Tesla Cybertruck wit fuel and fireworks explode for Trump Las Vegas hotel
- Author, Christal Hayes and Madeline Halpert
- Role, BBC News
- Read am in 5 mins
Police dey investigate afta one Tesla Cybertruck wey dey filled wit fuel canisters and firework mortars bin explode outside di Trump Hotel for Las Vegas, Nevada.
Di driver die and seven pipo injure, police tok witout naming any of di individuals wey dey involved. Officials say all injuries na minor.
Dem rent di truck for Colorado and e arrive in di city on Wednesday morning, less dan two hours bifor di detonation, police tok. Dem park di truck in front of di hotel near one glass entrance, and e start to smoke, den explode.
For one evening address, President Joe Biden say di White House dey track di incident and law enforcement dey investigate "weda any possible connection dey wit di attack for New Orleans", wey kill 15 pipo on New Year Day.
For one afternoon press conference, Sheriff Kevin McMahill bin show dramatic footage of di explosion and fotos of di aftermath, including several fuel canisters along wit large fireworks for di truck bed.
Footage show say di truck bin park directly for front of di entrance of di hotel. Di truck sit idle for several seconds bifor e explode - bursts of multi-coloured fireworks shoot for multiple directions.
Anoda video show investigators dey use a black fire-retardant tarp to put out di blaze and di charred remains of di truck bed. Gas and fuel canisters bin dey left behind along wit di remnants of more dan one dozen firework mortars.
Di fire happun around 08:40 PT (15:40 GMT), just hours afta one man drive one truck wit Islamic State (IS) group flag into di crowd for New Orleans. At least 15 pipo die and dozens injure.
Mr McMahill of di Las Vegas Police Department say di authorities bin dey examine weda di incident fit dey connected to di one for New Orleans, wia improvised explosive devices bin dey found near di scene.
E say dem also dey investigate weda e fit dey linked to President-elect Donald Trump, wey get di hotel, or Elon Musk, wey get Tesla.
"Obviously, a Cybertruck, di Trump Hotel, plenti questions dey wey we gatz answer as we move forward," e tok.
Di FBI also say di agency dey look into weda di incident fit be act of terrorism, but di authorities say dem currently neva confam di identity of di driver, wey die for di vehicle. Authorities also say so far, dem neva find any evidence say dis incident dey related to IS.
"I know evribodi dey interested for dat word, and dey try to see if we fit say, 'Hey, dis na terrorist attack.' Dat na our goal, and dat na wetin wey dey try do," FBI special agent in charge Jeremy Schwartz tell reporters for one news conference.
Di sheriff note say e be like say dem bin rent di two vehicles from Turo, one app-based car rental company.
One Turo tok-tok pesin tok for statement say di company dey work wit authorities for Las Vegas and New Orleans to help wit di investigation. Di tok-tok pesin note say di two pipo wey bin rent di vehicle no get any criminal background wey fit "identify dem as a security threat".
"We dey heartbroken by di violence wey happun for New Orleans and Las Vegas, and our prayers dey wit di victims and families," di statement tok.
Di authorities say dem get di name of di pesin wey bin rent di vehicle but dem neva officially confam say na di pesin wey bin drive di vehicle.
"As you fit imagine, wit di explosion here for di iconic Las Vegas Boulevard, we dey take all of di precautions wey we need to take to keep our community safe," im tok during news conference.
Mr McMahill say no threat dey again for di Las Vegas community.

Wia dis foto come from, Reuters
Dem bin brief Biden on both di attack for New Orleans and di Las Vegas explosion.
"We dey track di explosion of one Cybertruck outside di Trump Hotel for Las Vegas," na wetin di president tok for one evening address.
"Law enforcement and di intelligence community dey investigate am too, including weda any possible connection dey wit di attack for New Orleans."
Fire department officials say emergency responders bin quickly work to quench di vehicle fire.
Dem add say make di public stay away from di area. Dem evacuate di hotel, and move most of di guests to different location.
President-elect Donald Trump company own part of di hotel, for one post on X, Trump son, Eric Trump, say a "reported electric vehicle fire happun for di porte cochère of Trump Las Vegas".
"Di safety and well-being of our guests and staff remain our top priority. We extend our heartfelt gratitude to di Las Vegas Fire Department and local law enforcement for dia quick response and professionalism," im tok.
Stephen Ferlando tell di Washington Post say im bin witness di incident from im hotel room on di 53rd floor of di Trump Tower.
Im bin tell di outlet say "true-true na explosion" and di windows bin start to shake.
Di Trump Hotel get 64 floors wit around 1,300 suites, according to dia website.
Trump recently name Musk to co-lead one presidential advisory commission, di Department of Government Efficiency, afta two of dem becom close during Trump campaign.










