Kendrick Lamar, Donald Trump, and celebs wey show for Super Bowl

Kendrick Lamar perform for Super Bowl

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Kendrick Lamar na di first rapper to headline di Super Bowl as a solo act
Read am in 5 mins

One of di biggest sporting events for di world take place for New Orleans for America.

Philadelphia Eagles win dis year Super Bowl wit 40-22 victory ova defending champions di Kansas City Chiefs.

Di event no just bring out di best NFL get to offer dis season - but plenty of Hollywood A-listers, musicians and US President Donald Trump dey inside di stands of di Superdome.

Bifor di match start, actor Jon Hamm introduce di Chiefs while Bradley Cooper hype di Eagles.

Checkout dis selection of photo from celebrities for dis year Super Bowl.

Actor Bradley Cooper join Declan LeBaron (right) to announce dia favourite team - di Philadelphia Eagles

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Actor Bradley Cooper join one young fan Declan LeBaron (right) to announce dia favourite team - di Philadelphia Eagles
Blue Ivy wear oversized leather jacket paired wit casual cargo denim; as she stand next to her father Jay Z and sister Rumi

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Although pipo no really see Beyoncé for dis year Super Bowl, her daughters Blue Ivy and Rumi dey in attendance along wit dia father Jay-Z
Jay-Z take a few photo of Rumi as she jump next to one of di end zones as Blue Ivy watch on

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Jay-Z take a few photo of Rumi as she jump next to one of di end zones as Blue Ivy watch on
During di half-time Show, Kendrick Lamar perform Luther, im hit, wit R&B singer SZA

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, During di half-time Show, Kendrick Lamar perform Luther, im hit, wit R&B singer SZA
New Orleans Saints owner Gayle Benson, U.S. President Donald Trump, and Ivanka Trump dey look during Super Bowl LIX for Caesars Superdome

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Donald Trump become di first sitting US president to attend Super Bowl. Im carry large entourage, wey include im daughter Ivanka (right)
Trump salute as Jon Batiste sing di national anthem

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, President Trump salute as Jon Batiste sing di national anthem
Ivanka Trump stand by herself for di Superdome for New Orleans

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, But Trump appear to leave bifor di match finish and criticise di kick-off of di Super Bowl for im Truth Social platform. Im leave im daughter Ivanka Trump to enjoy di occasion
Jordan Hudson - di girlfriend of former NFL coach Bill Belicheck - pose next to Golden Globes host Nikki Glaser

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jordon Hudson (left) - di girlfriend of former NFL coach Bill Belichick - pose next to Golden Globes host Nikki Glaser
Inter Miami's Lionel Messi, Luis Suarez, Jordi Alba and Sergio Busquets each attended Super Bowl 59

Wia dis foto come from, Instagram/jordialbaoficial

Wetin we call dis foto, Inter Miami Lionel Messi, Luis Suarez, Jordi Alba and Sergio Busquets each attended Super Bowl 59
Serena Williams dance to Kendrick Lamar

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Serena Williams na di only unannounced guest star during di set
Di half-time show open wit Samuel L Jackson wey dress as Uncle Sam

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di half-time show open wit Samuel L Jackson wey dress as Uncle Sam
Actors Pete Davidson and Kevin Costner bin dey laugh ahead of kick-off

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Actors Pete Davidson and Kevin Costner bin dey laugh ahead of kick-off

Which songs Kendrick Lamar perform?

Kendrick Lamar

Wia dis foto come from, Getty Images

Di career-spanning set play 11 songs inside 13 minutes. Dis na wetin Kendrick play.

  • Bodies
  • Squabble Up
  • Humble
  • DNA
  • Euphoria
  • Man At The Garden
  • Peekaboo
  • Luther (with SZA)
  • All The Stars (with SZA)
  • Not Like Us
  • TV Off

Lady Gaga surprise performance

Lady Gaga play for New Orleans

Wia dis foto come from, Fox

Wetin we call dis foto, Lady Gaga bin tape her segment earlier in di week

Bifor kick-off, Lady Gaga bin make a surprise appearance on Bourbon Street, for di middle of New Orleans' historic French Quarter.

Di star, wey don play her own Super Bowl half-time show for 2017, play one touching rendition of her song Hold My Hand, to honour di victims of di New Year Day terror attack wey claim di lives of 14 pipo for di city.

Gaga bin dey surrounded by first responders as she play a black baby grand piano for di middle of di road.

"Hia for Bourbon Street, always di heart and soul of New Orleans, dis year begin wit terror attack wey bin try to break dia spirit," na wetin former American footballer Michael Strahan tok during di pre-filmed segment.

"But di resilience of New Orleans dey matched by di resolve of our kontri."

Jon Batiste become di first musician to perform di US National Anthem for di Super Bowl in front of a sitting president

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Jon Batiste become di first musician to perform di US National Anthem for di Super Bowl in front of a sitting president

Musical performances bifor di game start also include R&B artist Ledisi, wey perform Lift Every Voice and Sing, joined by 125 youth choir members, many pipo dey refer to di song as di Black National anthem, .

Musician Troy Andrews, popularly known as Trombone Shorty, and Christian singer-songwriter Lauren Daigle play America di Beautiful - e give di track a feel-good New Orleans vibe.

And just bifor di game begin, New Orleans native Jon Batiste sing di American National Anthem, im add a few jazz flourishes from im multi-coloured grand piano.