Bianca Censori Grammys dress and oda looks from events wey make pipo open mouth

Ye and im wife Bianca Censori

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Ye, di artiste wey dem dey formerly call Kanye West wife, Bianca Censori tiff di spotlight for di 2025 Grammys red carpet as she shock pipo wit di naked dress wey she wear inside her fur coat and unveil wen dem enta di centre of di red carpet.

As at now, Ye or Bianca Censori neva comot to tok why dem run di parole wey dem do.

But no be di first time wey looks from di Grammys don make pipo say ehn for di 67 times wey di event don happun.

Some stars don really push di line between shocking and stylish even as pipo start to wonder wen di fashion dey finish and di unexpected tins dey start.

From Lady Gaga and her controversy, to Jaden Smith wey wear house on im head for dis year Grammys dey overshadowed by nudity.

Jennifer Lopez look wey start Google images

Jennifer Lopez look for di 2000s Grammys

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, 'We bin put cello tape so di dress go stay'

No list go dey complete witout di look wey shine sotay e kickstart di beginning of Google Images by sake of high search.

Di year na 2000, and Jennifer Lopez and P. Diddy na like di couple goals of di Hip-Hop music industry and decide to showcase di coupling for di red carpet.

Jennifer Lopez bin dey nominated for di 2000 Grammy Awards wia she cause kasala wit di dress wey she wear wey get big slit for front.

She tell NBC Access Hollywood for interview say, "we bin put cello tape so di dress go stay. Wen we start dey waka, all of a sudden pipo start to whisper like, 'Who be dat, wetin dey happun?' And wen we enta red carpet, na so kasala burst."

"Who bin know say one dress go change di world?", na wetin actress and singer Jennifer Lopez laugh tok afta di ogbonge Versace dress she bin wear for 2000 bring out di need for Google Images.

Lady Gaga Performance look wit egg

Lady gaga

Wia dis foto come from, Getty Images

For 2011, Lady Gaga enta wit hype of di meat dress wey she wear for di 2010 MTV VMAs, she come reason how she go take make am up as dem nominate am for Album of di year and she gatz come correct.

She arrive as four models and dancers bin dey hold am inside one semi transparent egg, wey she call "an outfit and a vessel wey Hussein Chalayan create", according to wetin she tell Vogue.

She say, "I bin dey very particular for wetin my dancers wear for di performance sotay di night to di event, I tell dem to scrap di whole cloth say we need use latex. Dat time latex no dey evriwia, either you find am for sex shop or you find am wia we find dis one for bus company wey dey use am cover dia chair."

She add about her egg say, "I bin dey inside di egg for three days. Make I tok true, during award shows, especially for dis time, I bin no like to dey tok to pipo. I bin always feel like say e dey throw me off my performance."

Nicki Minaj and her fake pope

Nicki Minaj

Wia dis foto come from, Getty Images

For 2012, Nicki Minaj bin get performance for di Grammys so like di year bifor wit Lady Gaga to prepare for di performance she decide say she go carry one old man follow bodi go di red carpet.

Many pipo bin call di look wey come bifor her Roman Revenge performance say e bin dey "sacrilegious", even as tori pipo, The Hollywood Reporter tok dat time say na "her best Gaga imitation".

Jaden Smith House on im head

Jaden Smith

Wia dis foto come from, Getty Images

Musician Jaden Smith bin carry full small black house for im head wit im custom suit wey im wear for di award show.

Di rapper bin follow im papa Will Smith and singer sister, Willow Smith to di award show wit di headpiece wey di pipo wey make am, Abodi tok sa na "way to remember pesin childhood and retain playfulness and borderless creativity".

Pipo point out say di look resemble di house wey American actor Willen Dafoe bin wear for 2023 GQ Italia.