Chiefs or Eagles? Expert Super Bowl 59 predictions

Di Super Bowl trophy and Chiefs and Eagles helmets

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Who go win di Super Bowl? We get our experts, analysts and players' predictions
    • Author, Paul Higham
    • Role, BBC Sport Journalist
  • Read am in 4 mins

Super Bowl 59

Date: Sunday, 9 February Kick-off: 23:30 GMT

BBC coverage: Live text coverage on di BBC Sport website and app, and live radio commentary on BBC Radio 5 Sports Extra and BBC Sounds, plus post-game video highlights

Di Philadelphia Eagles go face di Kansas City Chiefs to contest Super Bowl 59 on 9 February for New Orleans for di Superdome, wey don host more Super Bowls pass any oda stadium.

Who go win?

Patrick Mahomes, Travis Kelce and di Chiefs dey chase historic three-peat; Jalen Hurts, Saquon Barkley and AJ Brown dey hope to gain revenge for di Eagles.

Kansas City bin win one 38-35 thriller for 2023 for Arizona and sometin like dat go go down again very nicely.

Di Eagles generally get di beta side, wit star-studded roster, but di Chiefs wey get winning mentality don dey grind out close victories all season.

So, who go lift di Vince Lombardi Trophy for di Superdome on Sunday?

BBC NFL experts, some of di sport top analysts and NFL players don make dia predictions.

BBC columnist Phoebe Schecter: Plenty pipo dey tok say na Chiefs go win, but I tink say na di Eagles. I think e go be by a field goal.

Di way dis two teams dey play, di way dis two defences dey play, dem go keep di game tight, especially di Eagles defence no go allow explosive plays.

But di key go be how di Chiefs go try stop Saquon Barkley.

My head say I want make Chiefs make history, my heart say I love di Eagles – make someone else get chance.

And na Saquon birthday so, come on, give di man present!

Score: Chiefs 24-27 Eagles

MVP: Saquon Barkley

Rob Stanton, BBC Radio 5 Live NFL host: Di Chiefs dey always find way to get di job done.

How you fit bet against Patrick Mahomes at dis point? I think e go dey close and di Eagles go get a shot but Mahomes go find way to win anoda Super Bowl las las.

Score: Chiefs 30-27 Eagles

MVP: Patrick Mahomes

Paul Higham, BBC Sport: Dis big games dey always come down to turnovers, third downs and di finer details - and coaches Andy Reid and Steve Spagnuolo don ready di Chiefs, dem dey beta prepared for those hot moments pass anyone else.

Dat na why dem win all dis close games - dat and Patrick Mahomes, of course. So even wit all di talent wey di Eagles get, I gatz stick wit di Chiefs to create history.

Score: Chiefs 27-24 Eagles

MVP: Patrick Mahomes

Ben Collins, BBC Sport: E fit no dey flashy, but no be accident say di Chiefs continue dey win tight games.

Wit dis teams wey dey so evenly matched, I expect anoda close one, wit Patrick Mahomes again doing just enough.

Score: Chiefs 24-21 Eagles

MVP: Patrick Mahomes

Wetin we call dis Video, NFL stars give Super Bowl predictions

Washington Commanders defensive lineman Efe Obada: Unfortunately, I don witness first hand say di Eagles fit blow out teams. I tink say di game go dey very tough.

But Mahomes na magician, so e dey very hard to bet against him. I tink na 50-50.

Los Angeles Chargers kicker Cameron Dicker: I tink di Eagles go win. I hate di Chiefs - you gatz hate di Chiefs as a Charger - so I no fit see dem win.

Indianapolis Colts cornerback Kenny Moore: Di name of di game na running di football. Philadelphia get one unique, effective, physical run game so Kansas City gatz stop di run, first and foremost.

For di Eagles, dem gatz mix up di run and pass and let Saquon be Saquon.

Pittsburgh Steelers defensive tackle Larry Ogunjobi: For di Chiefs, di key na to stop di run game. For di Eagles, na to stop Patrick Mahomes and dat link up e get wit Travis Kelce. E suppose dey exciting, I dey go 20-17 Chiefs.

Jacksonville Jaguars wide receiver Brian Thomas Jnr: Di Chiefs go win. If dem keep di game close, Patrick Mahomes go handle di rest from there. If dem go out there and play hard, do what dem fit do, then di Chiefs go bring am home.

NFL analyst Jason Bell: You gatz dethrone Mahomes. Until somebody do am, you gatz dey di Chiefs back.

Wetin we call dis Video, Super Bowl LIX – Preview

Di road to di Super Bowl

Who dey perform for Super Bowl half-time show?

American rapper Kendrick Lamar go headline di Super Bowl 59's half-time show.

Di 37-year-old bin headline di Glastonbury for 2022 and e win 17 Grammy Awards, plus several oda honours from di music industry.

Rumours dey spread about oda artists wey fit make guest appearances during im set and, so far, Grammy-winning singer-songwriter SZA na di only oda confam name.