Elon Musk go resign as Twitter boss afta polls?

Wia dis foto come from, Getty Images
Twitter user don vote in favour of Elon Musk to step down as di platform chief executive afta di billionaire run one poll on im future.
One total of 57.5% vote "yes" afta Oga Musk ask im 122 million followers whether make e stand down.
Oga Musk, wey buy Twitter for $44bn (£36bn), tok before di poll close say im go abide by di result.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di technology tycoon, wey also run Tesla and Space X, don face plenti gbasgbos since im take ova di site.
Oga Musk neva comment since dem close di poll. Even if im resign as chief executive, im go remain as Twitter owner.
More than 17.5 million users vote for di poll on Monday, wit 42.5% vote no to make Oga Musk step down.
In di past Oga Musk don obey Twitter polls. Im dey used to dey quote di phrase "vox populi, vox dei", one Latin phrase wey roughly mean "di voice of di pipo na di voice of God".
One former Twitter member of staff, wey comot di company recently, tell di BBC say Oga Musk dey "show imself to be di incompetent fool wey we all sbai say im be".
End of Di one wey oda users dey read well well
Speaking on condition of anonymity, dem add: "Im investors dey surely look at dis now and question whether im be di right horse to back.
"I imagine im dey get pressure from investors to step down and im dey use this poll to make it look like he's following the will of the people instead of the will of those paying his bills."
Minutes before di poll close, di founder of crypto exchange Binance reply to Oga Musk dey tok say im go "stay di course" and e no go step down.
Dem dey think say Changpeng Zhao na one of Twitter investors and tok for May say im don back Oga Musk take ova as im make one $500m investment.














