Elon Musk Twitter $44bn takeover and di changes e fit bring

A photograph of Elon Musk

Wia dis foto come from, AFP

    • Author, James Clayton in San Francisco and Peter Hoskins in Singapore
    • Role, BBC News
  • Read am in 4 mins

Di world richest man, Elon Musk, don complete im $44bn (£38.1bn) takeover of Twitter, according to US media and one investor inside di firm.

E tweet say "di bird is freed," for wetin be like say e dey refer to di closing of di deal.

Reports say dem don fire some top executives, including di boss, Parag Agrawal.

E bring to a close kasala wey make Twitter go to court to hold di billionaire to keep to di terms of di takeover deal e bin try to escape.

Twitter never yet confam di takeover, but one early investor for di company tell BBC say di deal don dey completed.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Di company chief executive, Mr Agrawal, chief financial officer Ned Segal, and di firm top legal and policy executive, Vijaya Gadde, no longer dey with di company, according to US media reports.

Dem escort Mr Agrawal and Mr Segal out of Twitter San Francisco headquarters afta dem close di deal, Reuters news agency report.

Twitter co-founder Biz Stone thank Mr Agrawal, Mr Segal and Ms Gadde for dia "collective contribution" to di business.

Meanwhile, Bret Taylor - wey serve as Twitter chairman since last November - update im LinkedIn profile to show say e no longer dey di post.

Dem go suspend di social media platform shares from trading on Friday, according to di New York Stock Exchange website.

Mr Musk say e buy di social media platform to help humanity and e want "civilization to get a common digital town square".

Earlier dis week Mr Musk tweet a video of imself dey waka enta Twitter headquarters for San Francisco wit kitchen sink e carry wit di caption: "let that sink in!"

E also change im Twitter profile to read "Chief Twit".

Elon Musk carry sink to Twitter HQ.

Wia dis foto come from, Elon Musk

Wetin we call dis foto, Elon Musk carry sink enta Twitter HQ

Many analysts argue say di price Mr Musk dey pay now for di company dey too high seeing di fall in di values of many tech stocks and Twitter struggle to attract users and grow.

Recently, di Tesla founder say Twitter na "an asset wey don suffer for a long time, but get incredible potential, although obviously myself and di oda investors dey overpay for Twitter right now".

Wetin go change for Twitter now?

Mr Musk early investments for Twitter bin first escape public attention. For January, e begin to dey make regular purchases of shares, so dat by di middle of March e don buy 5% stake in di firm.

For April, dem reveal am as Twitter largest shareholder, and by di end of di month, dem finally reach a deal wit am to buy di company for $44bn.

E say e plan to clean up spam accounts and preserve di platform as a venue for free speech.

But by mid-May Mr Musk, wey be ogbonge Twitter user, don begin to change im mind about di mata, sake of concerns say di number of fake accounts on di platform dey higher dan Twitter claime.

For July e say e no longer wish to buy di company. Twitter, however, argue say di billionaire don dey legally committed to di buying and eventually file a lawsuit to hold am to di deal.

For early October, Mr Musk revive im takeover plans for di company on condition say dem bin pause legal proceedings .

"I tink di court push am over di line," Ross Gerber, chief executive of Gerber Kawasaki Investments tell BBC.

"Quite frankly, dis na sort of disaster from di beginning... Starting off very strong to dey pursue Twitter in a way wey really force Twitter to di table... den e come dey vex and public quarrel over wetin to me na issues wey dey well known."

No comment yet from Twitter about im new management team, but whoever go become dia next chief executive e dey clear say Mr Musk go ultimately be in charge of di company.

E fall out with Mr Agrawal for early April - wen e sit briefly on Twitter board.

For private messages wey dem reveal for court filings, Mr Musk tok about how Mr Agrawal no understand how to fix di social media platform problems.

Reports of im removal go dey seen as signals of a clear change in direction for Twitter.

Mr Musk, a self-styled "free speech absolutist", bin don dey criticise Twitter moderation policies and di news go dey greeted with mixed feelings by Twitter users and employees.

Many pipo for di right of US politics go celebrate im exit. Dem dey see pipo like Mr Agrawal, and di former CEO, Jack Dorsey, as liberals wey dey block free speech.

Dem also tink say under dem, Twitter don censor conservative voices - accusation wey Twitter deny.

E appear now say as Mr Musk dey at di top, many pipo wey don dey banned for hate speech or disinformation fit dey invited back to di platform.

Former US President Donald Trump still dey banned from Twitter - decision Mr Musk bin don call "foolish" and say e go reverse.

However, Mr Trump don insist say e no go reactivate im account - preferring instead to post on im own platform Truth Social.

Meanwhile, odas dey fear say relaxing moderation policies go allow hate-speech to spread.

Inside tweet e address to Twitter advertisers Mr Musk say di platform no fit become a "free-for-all hellscape" and must dey "warm and welcoming for all".

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

As Twitter owner, e dey widely reported say Mr Musk dey plan to staff plenty staff. However, Bloomberg don report say di billionaire deny say e go cut 75% of staff inside a meeting with employees.

But working for Twitter fit become more one kain. Di Tesla chief executive bin don tweet say make employees expect work ethic expectations wey dey "extreme".

Di entrepreneur bin don also post say im plans for Twitter include "X, di app for everything".

Some suggest dis fit be sometin along di lines of di ogbonge success of Chinese app WeChat, one kind of "super app" wey incorporates different services including messaging, social media, payments and food orders.

Additional reporting by Chris Vallance