Elon Musk: Twitter agree to let World Richest man buy social media platform for $44bn

Elon Musk

Wia dis foto come from, Reuters

Read am in 4 mins

Di board of Twitter don agree to $44bn takeover offer from Elon Musk.

Oga Musk wey shock pipo wen e make di offer last week say Twitter get "tremendous potential" wey im wan unlock.

E don also ask make dem change tins like reduce hand for di content dem dey restrict and how to comot fake account.

Di company for di beginning bin reject im offer, but now dem go ask dia shareholders to vote so dem go fit approve di deal.

Elon Musk na di richest pesin for di world, according to Forbes magazine.

Elon Musk and Twitter logo

Wia dis foto come from, Getty Images

Im estimated net worth be $273.6bn most of dem na sake of di shares wey im get for di electric vehicle maker, Tesla wey im dey run. E also dey head di aerospace company Space X.

Oga Musk for statement wey im take announce di deal say, "Free speech na di foundation for functioning democracy, and Twitter na di digital town square wia pipo fit debate on mata wey dey important to di future of humanity."

E add say, "I also wan make Twitter better than ever by improving di product with new features, make di algorithms to dey open source to increase trust, defeat spam bots and authenticate all humans."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Dis sale dey come as politicians and regulators don dey pepper Twitter ova di kain content dem get on dia platform. Everybodi just dey yab di work dem dey do handle misinformation for di platform.

One of dia most high profile moves bin come last year wen dem ban former US president Donald Trump saye risk "incitement of violence".

At di time oga Musk bin say, "a lot of pipo go vex say na one West Cost high tech don become di real judge of free speech".

Di right wing class of di US bin happy with di news of di takeover of di platform, even as Trump tell Fox News say im no get plans to region.

White House no agree to tok on di mata but tok-tok pesin Jen Psaki tell tori pipo say: "No mata who own or dey run Twitter, e don tay wey di president bin dey worry ova di power wey big social media platforms get."

On Twitter, di chairman of di UK, Digital, Culture, Media and Sport Committee, MP Julian Knight say di deal be "extraordinary development for di world of social media".

E say, "e go dey interesting to see how private owned Twitter (wey di man wey dey run am na oga ova free speech) go handle to di global moves to regulate am".

Wetin be Elon Musk record for Twitter?

Elon Musk in 2019

Wia dis foto come from, Getty Images

Oga Musk, wey get pass 80 million followers for Twitter, bin get gbas-gbos on di platform.

For 2018, US financial regulators accuse am say e bin dey mislead Tesla investors with im tweets, claims wey bin dey sorted for $40 million settlement and wey oga Musk still dey deny.

For 2019, dem knack am defamation suit say im call one diver wey rescue di schoolboys for Thailand, "pedo guy" for Twitter. Im defeat di case sha.

On Monday, oga Musk wey dey known to gbas-gbos with tori pipo and block critics say im see Twitter as place for debate.

Just hours before dem announce di deal, "I hope say even my worst critics go stay for Twitter, because dat na wetin free speech mean".

Musk fit turn Twitter around?

As part of di takeover, wey suppose close later dis year, Twitter shares go dey delisted and e go dey private.

Mr Musk bin tok say dis go give am freedom to make di changes e wan do for di business.

E don suggest to allow longer posts and di ability to edit dem afta dem don publish.

Twitter shares on Monday bin close 5% higher afta dem announce di deal.

Howeva di price no reach di $54.20 per share offer, wey Wall Street believe say e dey over pay for di company.

Oga Musk say e no "care about di economics" of buying. But di company e dey buy get k-leg wen e come to financial performance.

Even with im influence, Twitter neva really turn profit before and di user growth don slow down most especially for America.

Di company wey dem start for 2004, bin finish 2021 with $5bn for revenue and 217 million users worldwide wey dey use di app daily.

Dis no reach di users wey oda platforms like Facebook dey boast of.

Bret Taylor, wey be di chair of Twitter board, say dem don chook eye for Musk offer and na di "best road forward for di stakeholders of Twitter".

Parag Agrawal

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Parag Agrawal takeova from Twitter co-founder Jack Dorsey for November

E no clear who go lead Twitter for future, As na just November last year, Parag Agrawal bin take ova from co-founder and former boss Jack Dorsey wen im step down.

But for im offer document, oga Musk tell Twitter board say, "I no get confidence for management".

Oga Agrawal bin tell employees say di future of Twitter no dey clear.

According to Reuters, e say, "once di deal close, we no know di direction di platform go go".

How dis deal take happun?

Di way wey Elon Musk take target Twitter move with ogbonge speed.

E start for di beginning of April wen pipo hear say na im be di largest shareholder for di firm with 9.2% stake.

Dem come invite am make e join board, but e refuse and the m shock evribodi wey im launch surprise bid for di company on 14 April.

E say e wan unlock Twitter potential as di bastion for freedom of speech.

Twitter bin try to bounce im bid, dem even threaten t water down di shareholding anyone wey get pass 15% stake or di firm. But dem change dia mouth afta oga Musk reveal more financial details of di bid.

E don secure $25.5bn financing for di deal and go take a stake of $21bn for di business.

Afta dat, di board fully vote to approve di bid, wetin remain now na for shareholders to vote.