Elon Musk don present humanoid robot Optimus

An Optimus prototype

Wia dis foto come from, Tesla

Wetin we call dis foto, Video show di robot dey do some simple tins, like watering plants, carrying boxes and lifting metal bars

Tech billionaire Elon Musk don show di latest prototype of one humanoid robot wey im Tesla electric car company dey develop.

Optimus bin appear on stage for one Silicon Valley event, wia e wave to di audience and raise im knees.

Di CEO say di robot na work-in-progress but fit dey on sale to di public in some years time.

Tesla mass-market robots go dey tested by working jobs for di car factories, na so di company engineers dey tok.

Dem roll di prototype on stage for di annual Tesla AI [artificial intelligence] Day presentation.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Dem show pipo video of Optimus as e dey perform simple tasks, like watering plants, carrying boxes and lifting metal bars.

Oga Musk say dem go produce plenti of di robots for cost lower dan $20,000 (£17,900), and e go dey available in three to five years.

"Really na fundamental transformation of civilization as we sabi am," na wetin di CEO tok.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2