'Welcome back' - highlight of Donald Trump meeting wit US president Joe Biden

Wia dis foto come from, Reuters
US President-elect Donald Trump go meet wit President Joe for di White on Wednesday, 13 November.
Di President-elect dey go di White House on di invitation of President Biden for one meeting.
Di meeting na part of one long-standing tradition wey show peaceful transition of power between administrations.
Di meeting between Donald Trump and Joe Biden go mark di start of di president-elect transition back into di White House.
Dis na di first time wey di two men go meet since dia presidential debate for late June, bifor Biden step down from di campaign.
Oga Biden wey first start di conversation congratulate Oga Trump and say im administration go accommodate di President-elect needs.
"Well Mr President-elect and former president, Donald, congratulations. We look forward to having a smooth transition, we dey do everything we fit do to make sure say you dey accommodated and get wetin you need. We go get chance to tok about some of dat today. So welcome, welcome back."
For im response, di President-elect Trump thank Oga Biden and tell am say politics dey "tough".
"I appreciate very much a transition wey dey so smooth, e go dey as smooth as possible," Trump tok.
Donald Trump White House visit today on President Joe Biden invitation - na return to tradition wey dem avoid for 2020, wen Trump be di outgoing president and Biden be di president-elect.
At di time, Trump no agree say im lose di election - position wey e still maintain, without evidence.
Trump break di tradition and no invite Biden to di White House to meet during di transition period.
Instead on di day dem suppose certify Biden victory for Congress, Trump bin hold rally where e tell im supporters to "fight like hell" ahead of di riot for di Capitol.
E den skip Biden inauguration ceremony for January 2021, anoda tradition wey e break.
Four years later, Biden don invite Trump for Oval Office meeting, in a return to tradition, e say im dey committed to "a peaceful transfer of power", even though di two presidents' dey often use harsh words towards each oda.
Melania Trump turn down invitation to di White House

Wia dis foto come from, Reuters
Meanwhile di incoming First Lady Melania Trump bin also dey invited to di White House but she turn no show.
Na tradition for di current first lady to host her successor for tea for di White House wen their husbands meet, but official say she turn down di invitation.
"Mrs. Trump no go attend today meeting for di White House. Her husband return to di Oval Office to start di transition process dey encouraging, and she wish am great success," di incoming first lady office tok for one post on X.
E add say "several unnamed sources for di media don continue to provide false, misleading, and inaccurate information", and dem no explain further.
However, during di meeting, di outgoing First Lady bin join President Joe Biden to greet President-elect Donald Trump for di White House.
During dis meeting, Jill Biden give Trump one letter for to im wife, Melania Trump, wey choose not to attend di the traditional post-election tour of di residence.
"She give Mr. Trump a handwritten letter of congratulations for Mrs. Trump, wey also express her team readiness to assist wit di transition," di White House tok.
Trump don comot di White House

Wia dis foto come from, EPA-EFE/REX/Shutterstock
Afta Trump conclude im meeting wit Biden, e leave di White House and e no follow tori pipo wey gada outside tok.
Afta brief remarks earlier for front of reporters for di start of dia meeting for di Oval Office, where Trump thank Biden for a "smooth" transition of power, di two bin continue to tok behind closed doors for nearly two hours.
E dey expected say dem discuss a number of items, from US foreign policy to di logistics of handing over power.
According to di White House, Trump incoming chief of staff Susie Wiles and Biden chief of staff Jeff Zients also join di two presidents for part of di meeting, our US news partner CBS tok.
Republican Senate don elect John Thune as dia new leader

Wia dis foto come from, Getty Images
Meanwhile as Trump and Biden dey meet, di Senate Republicans bin also dey meet at di same time to elect a new leader.
Dem elect John Thune, di long-serving Senator from South Dakota, as dia new leader for di chamber.
Di 63-year-old bin win one secret ballot on Wednesday, e defeat Florida Senator Rick Scott and Texan Senator John Cornyn.
Scott, wey be di preferred choice of many of Donald Trump top allies inside and outside Congress, bin chop elimination for di first round.
Di Republican Party win 53-47 majority for di Senate last week, wey make dem gain control of di upper chamber.
Thune go take ova from Kentucky Senator Mitch McConnell, di longest-serving party leader for US history.
Di 119th Congress go begin for January, and dem go serve for at least di next two years.
As Senate majority leader, e go be di chief spokesperson for di Republican conference positions on issues, co-ordinate legislative strategies and manage business - including all legislative action - on di chamber floor.
McConnell, 82, bin announce earlier dis year say im go step down afta 7 years for di top leadership post.
Im decision bin spark expected bids from Thune, di current minority whip, and Cornyn, wey bin previously serve as Republican whip.










