Nigeria vs Zimbabwe - All you need to know

Read am in 3 mins

Nigeria coach Eric Chelle begin im reign wit Super Eagles wit a 2-0 victory against Rwanda.

Victor Osimhen score two goals for di match to guarantee dia three points.

On Tuesday evening, Nigeria go host Zimbabwe for dia sixth 2026 World Cup qualifying match.

Super Eagles captain William Ekong say Friday victory for Rwanda Amavubi na statement di Eagles bin need to put out as di World Cup race reach halfway mark.

Nigeria go expect to follow up dia away win by claiming anoda comfortable three points against Zimbabwe wey play 2-2 draw wit Benin, but currently dem dey sixth position for group C.

Bafana Bafana dey top thanks to a second-half burst against Lesotho.

Date, kick-off time and venue

Nigeria vs Zimbabwe dey scheduled for 5pm West African time on Tuesday evening March 24 2025.

Dis match go take place for Godswill Apkabio stadium for Uyo Akwa Ibom state.

Where to watch Nigeria vs Zimbabwe

Fans fit watch di match for Nigeria for SuperSport channel for DSTV.

Also follow our website for BBC Pidgin for all di action via live text.

Nigeria vs Zimbabwe team news

Nigeria Squad:

Goalkeepers: Stanley Nwabali (Chippa United, South Africa); Amas Obasogie (Singida Blackstars, Tanzania); Kayode Bankole (Remo Stars)

Defenders: William Ekong (Al-Kholood FC, Saudi Arabia); Bright Osayi-Samuel (Fenerbahce SK, Turkey); Bruno Onyemaechi (Olympiacos FC, Greece); Calvin Bassey (Fulham FC, England); Olaoluwa Aina (Nottingham Forest, England); Igoh Ogbu (SK Slavia Prague, Czech Republic)

Midfielders: Wilfred Ndidi (Leicester City, England); Raphael Onyedika (Club Brugge, Belgium); Alhassan Yusuf Abdullahi (New England Revolution, USA); Alex Iwobi (Fulham FC, England); Joseph Ayodele-Aribo (Southampton FC, England); Papa Daniel Mustapha (Niger Tornadoes)

Forwards: Samuel Chukwueze (AC Milan, Italy); Victor Osimhen (Galatasaray FC, Turkey); Ademola Lookman (Atalanta FC, Italy); Victor Boniface (Bayer Leverkusen, Germany); Simon Moses (FC Nantes, France); Sadiq Umar (Valencia FC, Spain); Nathan Tella (Bayer Leverkusen, Germany); Tolu Arokodare (KRC Genk, Belgium)

Ekong say: "E bin dey important to make di statement wey we make, and we dey happy about am, and di way we do am. Of course, we neva qualify and we still get a lot of work, but we don start di recovery in a good way and we just need kotinu to work hard.

"I no wan go into di circumstances wey make di first four matches go di way e go. Di good tin be say we fit still recover and revive di campaign, and we dey do am."