Thomas Partey score 2 goals as Ghana scatter Madagascar 3-0 for dia Fifa 2026 World Cup qualifier

Read am in 13 mins

Ghana don thrash Madagascar 3-0 for dia second leg of di 2026 world cup qualifiers for Morocco.

Dis na afta di blackstars sama Chad 5-0 on Friday for dia qualifying game.

Arsenal midfielder Thomas Partey score two headed goals from two corner kicks by Jordan Ayew, bifor Mohammed Kudus bin score di third late in di second half.

Captain Jordan Ayew grab di assist for all di three goals, as im lead di team, by example.

Wit dis result, Ghana now bin open 5-point gap on top Group 1, wit 15 points. Madagascar dey second wit 10 points, Mali bin dey third wit 9 points afta dem draw 0-0 wit Central Africa republic.

Comoros dey fourth also wit 9 points, CAR fifth wit 5 points and chad bin dey bottom of di group wit zero points.

Dis na di first time Ghana bin win back-to-back games wia dem score 8 goals, without conceding.

Coach Otto Addo dey happy wit di team performance as im already tok say dis game na "mini final".

Fans of di blackstars tok say na refreshing to see say di stars don dey play football again to bring dem joy.

Dis na six out of ten matches wey di teams for group I don play – dem get four more bifor e go dey clear wey teams dey go di football extravaganza for US, Canada and Mexico.

Second half

FULL TIME!

Referee don blow whistle to end di game. Ghana win 0-3.

94" Madagascar still no giove up. Dem dey try to score but di ball comot for park - na throw in.

93" Ghana now dey wind down di clock to end dis game. Dis na di first time for long time wia Ghana don keep two cleansheets wey dem score 8 goals in 2 games.

Time don run out for Madagascar to score for dis game.

92" Mohammed Salisu bin cause wahala for di madagascar are wey ref blow whistle for freekick.

90+1 Madagascar dey create sometin, Clement tink say im win freekick in front of di Ghana box, but referee say di freekick na for Ghana.

90" Referee don add 5 minutes

89" Razak Simpson dey for ground afta one double stamp by di Madagascar midfielder.

88" Jordan play di freekick; Madagascar clear di ball wey dem attack. But dem no fit carry di ball hurt Ghana.

87" Kingsley Shindler for di right back dey attack Madagascar wey dem hack am put ground.

86" Thomas partey bin win freekick for di center of di park.

85" For di last 5 minutes, Madagascar go try to score, but dem fit to score 3 goals to draw di game? Time go tell.

For di first leg of dis game on 11 November 2023, Inaki Williams bin score last minute goal to win all di 3 points.

83" Madagascar players dey pass pass di ball for dia own area, na so Ghana collect wey di ball comot for park dor throw ball.

82" Madagascar bin get throw in. But dem lose di ball. Ghana now don take ova.

81" Jerome Opoku don sit for floor inside di Ghana box, di medical team bin rush to di park to treat am.

Ghana don comot two players, Gideon Mensah, Abu Francis and Kudus comot Razak Simpson, Jonathan Anan and Ernest Nuamah don enta di game

78" Morgan from Madagascar clear di ball from im area but di ball fall to Ghana player wey Ghana win corner.

76" Captain Jordan Ayew bin hit di ball, na so confusion happun for di Madagascar box. Di keeper Geordan comot dey no man's land, im make lucky say di ball no enta di net.

Ghana bin win freekick afta dem foul Kudus. Madagascar take di chance to make anoda change.

75" Goalkeeper Benjamin Asare don catch one long ball into di Ghana box.

74" Madagascar take di corner but dem neva trouble di blackstars.

73" Chaaaaance! Madagascar get chance to score inside di Ghana box, but keeper Asare carry hand save di ball, but im still dey in play, na so Salisu rush come clear am for corner.

72" Jerome Opoku make one madagascar player sit for floor bifor im cross di ball. Di ball pass everibodi en for di Madagascar box.

71" Chaaaaance! Warren from Madagascar enta di Ghana area wey im shoot but e go wide. Im don dey tok di ref say di ball touch di keeper but ref say goalkick.

70" Ghana don comot Antoine Semenyo, na so Inaki Williams enta di game

Madagascar player do rabonna to pass di ball to im team mate but di ball too strong.

Madagascar dey try to pump energy for dis dia team to see if dem fit to grab a goal at least.

68" Madagascar don comot three players - BAGGIO, Arnaud and Loid all comot.

67" Antoine Semenyo pepper di Madagascar defense wey im try to take advantage of di moment but im delat on top di ball wey di chance vanish

Ghana goalkeeper Benjamin Asare don jump to catch one ball inside im area.

66" Kingsley Shindler carry di ball pass one defender in legs but im no fit collect am afta, Madagascar now get di ball.

65" OFFSIDE! Antoine Semenyo enta offside trap, referee blow whistle.

64" Freekick for Ghana - Kingsley Shindler don win am, but dem no carry do anitin.

If di result stay like dis, Ghana go get 15 points wit 15 goals fro Group I as leaders.

62" Madagascar neva dey give up. Dem dey try to create sometin for diaserf, but e neva dey happun for dem.

60" Ghana dey try to create anoda chance wit Jordan Ayew as dem begin to drive into di Madagascar area. But di pass too strong for Gideon Mensah.

59" Dat Kudus goal na wetin go boost im confidence as im bin struggle to score goals for di kontri and westham.

Westham starboy Mohammed Kudus don run enta di box wey im latch onto Jordan im thru ball to score.

57" Gooooooooaaaaaal!

But today, di Arsenal midfielder bin grab 2 goals.

56" Many pipo bin dey bash Partey say im no dey play well for di blackstars like di way im dey play for Arsenal.

Ghana don get anoda freekick far from di box. Dis time Madagascar don clear dia lines.

Jordan Ayew grab two assists for Thomas Partey im 2 goals.

Madagascar 0 -2 Ghana

Thomas Partey don score again from anoda Jordan Ayew corner.

52" Gooooooooaaaaaaaaaal!

51" Kudus win freekick as im come back to collect di ball.

Poor pass by Partey, but Abu Francis try to win di ball for di midfield but im commit foul

50" Ghana don win throw in, Kingsley Shindler thorw di ball back into im area, na so Ghana begin to dey pass di ball for di back.

49" Between Partey and Kudus, dem pass pass di ball ion front of di madagascar goal, but dey don defend am.

48" Chance! Madagascar player Clement cross one ball but e don pass evribodi wey e go ova

47" Anoda chance for Ghana - Jordan Ayew blast one shot ova di bar.

46" Afta Ghana pass di ball, Kudus get chance wey im shoot from di edge of di box, but di shot na way off target

45" Referee don blow whistle to start di second half.

Halftime Madagascar 0 - 1 Ghana

45+1 Referee don blow whistle for halftime

45" Blackstars bin dey dash ball for di midfield bifor Kudus win freekick.

44" Right afta dat Madagascar carry ball enta di Ghana area bifor Salisu block di di attacker, im shot go wide.

43" Kudus don fall inside di Madagascar penalty box wey im tink say he win penalty but ref say no penalty.

42" Freekick to Ghana. Kingsley Shindler win am

Referee restart di game now, Gideon Mensah hold di ball wey im pass back to di keeper

41" Referee don stop di game afta Jordan carry hand chook Clement im face.

40" Clement from Madagascar dey worry di Ghana defenders for di left side, im carry di abll enta di area bifor im lose di ball.

Possession don be 50-50 now as Madagascar still dey try to create sometin.

39" Chaaaance! Baggio don shoot from more dan 20 yards but di ball enta row z!

38" Thomas Partey bin pass one ball to im opponent for di center of di park.

36" Second yellow card for di game, Abu Francis from Ghana collect yellow afta im foul di Madagascar player.

Antoine Semenyo carry one ball run enta di Madagascar area but instead say im go pass to Jordan wey dash for di oda side im hold di ball until im lose di ball

35" Madagascar now dey try to posses di ball without creating any danger.

34" Madagascar get one chance to shoot di ball in front of di Ghana box, but goalkeeper Benjamin Asare don catch di weak shot.

So far, Madagascar never get any clear chance to score sake of di Ghana defenders don block di area

33" Baggio from MAdagascar bin foul Mohammed Kudus inside di halfway area.

32" Madagascar take di corner sharp sharp, but dem no fit create any chance from dia.

31" Chaaaance! Madagascar captain Raya carry ball pass two Ghana players wey im shoot from outside di box, but di ball deflect for corner

29" Anoda chance! Thomas Partey lay one ball thru di middle fo di Madagascar defense but dia defender cut di ball.

28" Chhhaaaance! Ghana get chance wit Antoine Semenyo - di Bopurnemouth striker cross di ball into di box, but Kudus no fit carry leg reach di ball wey e go wide.

27" Since di goal, di game don dey scata, as di players just dey cot each oda.

25" Madagascar dey create something wit dia players Clement and Rayan, but dem neva fit to penetrate

24" Goalkick to Ghana, goalkeeper Benjamin Asare don hook di ball into di Madagascar area.

23" Kudus don lose ball inside di midfield but im try to recover; Madagascar dey try to pepper di blackstars.

22" Referee bin stop di game afta Madagascar player Baggio commit foul - im chop di forst yellow card for di game

21" Antoine Semenyo get chance to try and test di Madagascar keeper but Geordan comot di 6-yard box to collect di ball

Captain Raya Raveleson don balloon di freekick to di stands. Di chance don waste.

20" Freekick to Madagascar as Salisu bin foul Arnaud for di edge of di Ghana box.

19" Referee don calm di players wey match don restart

18" Di players bin dey fight for di park afta Arnaud fall for ground under challenge from Salisu bifor Jordan im foul.

17" Gideon Mensah carry left play di ball for Jordan to chase but di Malagasy defender carry peg prevent Jordan as di ball comot for goalkick.

16" Kudus and Partey bin dey exchange passes for di midfield bifor Partey lose di ball, but Ghana defend

15" Jordan Ayew play di corner but goalkeeper Geordan jump wey im catch di ball.

14" Chaaaaaance! Goalkeeper Geordan bin dive for ground to save Kudus im shot. Corner to Ghana

13" Throw ball to Ghana, captain Jordan Ayew dey try to take on di Madagascar defender for di line

12" Ghana bin dey try to create anoda chance afta dat goal, but Madagascar bin dey clear dia lines

Madagascar 0 - 1 Ghana

Arsenal midfielder Thomas Partey bin head di ball inside di net afta Jordan Ayew play di freekick.

10" GOOOOOAAAAALLLL!

Ghana bin dey play wit 5 defenders for dis game, as di coach Otto Addo dey try to protect dia goal area

9" Jordan Ayew win freekick for di Ghana area to bring down di pressure.

So far both teams dey try to control di ball and create chances. Salisu bin hack down one Malagasy player for freekick for di halfway line.

7" Madagascar goalkeeper Geordan bin comot en box to clear one high ball.

6" Chaaaaance! Jordan Ayew bin take di freekick, but Mohammed Salisu carry left leg hit di ball but e don go sidenet.

5" Chance for blackstars for one side outside di madagascar box

4" Freekick for Ghana afta di Madagascar defender Harrison foul Antoine Semenyo.

3" Madagascar bin waste di freekick, wia Ghana dey try to attack, but referee blow whistle against Kudus.

2" Freekick to Madagascar afta Kingsley Shindler foul im attacker.

1" Game don start wit Ghana trying to dey create some quick attack but di ball go throw

Blackstars bin dey wear dia new yellow jersey na so Madagascar dey wear dia red home jersey.

Referee don blow whistle afta di national anthem of di two teams don play

Welcome yard pipo to dis live text commentary for di game between di blackstars of Ghana and Madagascar.

First half

Jordan Ayew bin dey captain blackstars for di second straight game as coach Otto Addo make two changes from di team wey beat Chad 5-0 for di 2026 world cup qualifier for Accra last Friday.

Lyon forward Ernest Nuamah wey score one goal against Chad now dey start from di bench, di same tin for Inaki Williams wey also bin score on Friday – im too dey for bench.

Di lineup wey dem confam na

Ghana

Benjamin Asare (GK); Kingsley Shindler, Salisu Mohammed, Gideon Mensah, Alexander Djiku, Thomas Partey, Jerome Opoku, Abu Francis, Mohammed Kudus, Antoine Semenyo, Jordan Ayew ©.

For Madagascar, coach Corentin Martins also bin name im starting XI top face Ghana.

Madagascar

Geordan (GK); Matheu, Harisson, Thomas, Morgan, Rayan ©, Baggio, Clement, Lapoussin, Warren, Arnaud.

Ghana fit open 5 point-gap for di top of di table if dem win dis game v Madagascar afta Central Africa republic and Mali bin play 0-0 for dia match earlier.

Background

Ghana and Madagascar dey jam for dia 2026 World Cup qualifier for Morocco on Monday.

Dis dey happun afta di Black Stars hammer Chad 5-0 for di Accra sports stadium on Friday.

Dat na di first time Ghana don score five goals for one game since dem thrash Qatar 5-0 for di year 2020.

Goals from Antoine Semenyo (Bournemouth), captain Jordan Ayew (Leicester city), Mohammed Salisu (Monaco), Inaki Williams (Athletic Bilbao) and Ernest Nuamah (Lyon) give Ghana di emphatic victory for dat game.

Wit dat win, Ghana don climb to di top of Group I wit 12 points from five matches.

Madagascar dey second wit 10 points, Comoros get nine points, Mali and Central African Republic both get eight points wey Chad dey bottom of di table wit only one point.

Ghana President John Mahama bin ginger di team wen im visit dem ahead of di Chad game wey im tok say make dem win dis two qualifiers and make di fans happy again.

"Una go get di support of di kontri if you win dis games, make una show dedication like how una dey do for your clubs. As goment, we go support you to deliver."

Afta di 5-0 win v Chad, President Mahama tok say "I bin get appetite for food wit dat result, make dis victory no enter your head. Dis gat to be di beginning of di love for di Black Stars once again."

Team news

Ghana no get any injury mata for dis game as di team do dia recovery training for Morocco.

Coach Otto Addo bin tok say im dey want make di team focus for dis game.

"Everybody happy about our last win but we still gat long way to go, na so everybody gat to be on dia toes. We dey need 100% from di whole team."

Im add say "dis na tough game, wetin I call small final."

Im add say di technical team bin observe di Madagascar team well well, wia we go try to beat dem.

Hearts of oak goalkeeper Benjamin Asare wey keep clean sheet for im blackstars debut at 32 years, go fit dey inside post again today.

Sabi pipo tok say di coach dey likely to maintain di defense - Alexander Djiku, Mohammed Salisu, Gideon Mensah and Kingsley Schindler.

Black Stars legends - Asamoah Gyan and Stephen Appiah bin dey camp to ginger di boys and give dem vim for dis match.

Na long time wey di kontris legends don dey around di team to inspire dem and motivate dem.

Di football association believe say dis go help di squad.

Madagascar coach Corentin Martins ahead of di game tok say dem go play to dia own strength to try and beat Ghana.

"We don dey face ogbonge team like Ghana, but we go do our best."

Dem appoint Corentin for February dis year as coach ahead of di qualifiers wit central Africa republic and Ghana.

As dem appoint am, im tok say "na short term contract, we go try to qualify for di World Cup; na tough dream but we go try to make am."

Di Barea go rely on dia goalkeeper Geordan Dupire wey bin make three ogbonge saves for di game against central Africa republic.

Head-to-head

Dis go be di fifth time Ghana and Madagascar go jam for competitive games - Black Stars bin win two, Madagascar also win two, wit 1 draw.

Na so di last time dem face each oda, Inaki Williams score one late goal for di Baba Yara Sports stadium for November 2023.

Dat game na di first win for di 2026 World Cup qualifiers.

For June 2022, blackstars don hammer Madagascar 3-0 for di 2023 Africa cup of nations qualifiers - for di reverse game, di two teams play 0-0.

Madagascar no fit score goal for dia last three games wit Ghana.

Possible lineups

Ghana

Asare (GK); Schindler, Djiku, Salisu, Mensah, Partey, Kudus, Nuamah, Ayew, Semenyo, Williams

Madagascar

Dupire (GK); Morgan, Fontaine, Marcelin, Rabemanantsoa, Lapoussin, Couturier, IIaimaharitra, Raveloson, Randriananten, Caddy