PhD student guilty of drugging and raping 10 women for UK and China, e keep dia belongings

Wetin we call dis Video, Police enta Zhenhao Zou London flat for January 2024 and arrest am on suspicion of rape
    • Author, Daniel Sandford
    • Role, UK correspondent
    • Author, Victoria Cook
    • Role, BBC News
  • Read am in 5 mins

A PhD student wey dem don convict of drugging and raping 10 women "fit turn out to be one of di most prolific sexual predators wey don eva dey for di kontri", according to di lead detective on di case.

Chinese national Zhenhao Zou wey be 28 years old, attack two women wey dem don identify and anoda eight wey dem neva trace, according to im trial for Inner London Crown Court.

E film nine of di assaults as "souvenirs", and keep a trophy box of victims' belongings, wey include jewellery and clothes.

Judge Rosina Cottage describe am as "dangerous and predatory sexual offender" and warn say e dey face a "very long" jail term wen dem sentence am on 19 June.

Police mugshot of Zou, looking impassively at di camera

Wia dis foto come from, Met Police

Wetin we call dis foto, Di Met Police don launch an appeal to find any oda of im potential victims

Di Met Police Cdr Kevin Southworth say di video evidence show say e fit get as many as 50 further victims, wey dem dey "desperate to trace".

"Such na di insidious nature of dis offences, I think e get a possibility say many more victim survivors fit even no know say e don rape dem," e say.

Following di trial and as a result of di media coverage, di Met confam say one woman don alreadi dey in touch on Zou.

A collection of random items on a table, including jewellery and clothing.

Wia dis foto come from, Metropolitan Police

Wetin we call dis foto, Zou keep a trophy box of victims belongings

As well as 11 counts of rape, di University College London (UCL) student dey guilty of voyeurism, possession of extreme pornographic images and false imprisonment.

Di crimes wey dem convict am of take place between 2019 and 2024.

Met Police find hidden cameras for im bedroom, as well as ecstasy and an industrial chemical wey di human body dey turn into di "date-rape" drug GHB.

Seven of di rapes happun during di pandemic for China. Di evidence of dose attacks na videos wey dem show to di jury wey e keep wia im dey have sex wit unconscious and semi-conscious women.

Police neva identify dem.

Four of di rapes take place for London. Two women dey identified and give evidence; di oda two rapes na of di same woman, but she neva dey tracked down.

spy camera show for evidence next to tape measure

Wia dis foto come from, Metropolitan Police

Wetin we call dis foto, Zou film di women using spy-cameras

Jurors gatz watch footage of nine of di rapes during court proceedings, appearing visibly angry and dem give dem regular breaks as dey show di material.

Some of di attacks dey filmed for im flats in Bloomsbury and Elephant and Castle, odas na for unknown location for China.

Di prosecutions wey relate to attacks for China dey possible becos foreign nationals wey dey live for di UK fit chop charging wit an offence committed abroad dat is also illegal in di kontri country wia e take place.

Wetin we call dis Video, 'No comment': Video shows police interviewing Zhenhao Zou

For im defence, Zou tell di jury say im discuss sexual preferences wit one of di women e film, and she tok say she like "uniform role play".

"We specifically discuss di kian role play I like, wey be rape role play," e say. E tell di court dis na how di videos come to be made.

Police photo of Zou bedroom. E get an unmade bed in sunlight from large windows, wit a desk to one side.

Wia dis foto come from, Met Police

Wetin we call dis foto, Zou paid £4,000 a month to rent im luxury flat

Di student come from a rich family, and get enof money to afford a Rolex watch, a wardrobe full of designer clothes, and cosmetic procedures including a hair transplant and facial surgery.

E pay £4,000 a month for rent.

Zou move to Belfast for 2017 to study at Queen University bifor heading to London in 2019 to do a master degree and den a PhD for UCL.

'Courageous women'

Following di convictions, di Met Police don launch an appeal to find any oda victims.

"If you be woman wey in any way get a one-on-one encounter wit dis man Zou, den we go like to hear from you," Cdr Southworth tok.

Di force say e dey particularly keen to hear from women from di Chinese student community wey fit don meet Zou and d ley ive for and around London between 2019 and 2024.

Di Met say e go also like to speak to potential victims wey fit don meet Zou while dey live for China.

Saira Pike from di Crown Prosecution Service say: "I go like to express my heartfelt thanks to di courageous women wey come forward to report Zhenhao Zou heinous crimes.

"Dem dey incredibly strong and brave – e no get any doubt say dia evidence help us to secure today verdict.

"Zou na serial rapist and a danger to women."

UCL say dem don set up an online portal for any students or staff to report if dem believe say dem don be a victim of Zou.

E say e dey also offer support to dose wey dey affected by di case within di university.

UCL president Dr Michael Spence say: "We dey appalled by dis horrific offences.

"Our thoughts d ey wit di survivors and we wish to pay tribute to di bravery of di women wey report dis rimes and give evidence for di trial."

Di charges in full

Di jury find Zou guilty of:

  • 11 counts of rape, wit two of di offences relating to one victim
  • Three counts of voyeurism
  • 10 counts of possession of extreme pornographic image
  • One count of false imprisonment
  • Three counts of possession of a controlled drug wit intent to commit a sexual offence

E dey cleared of two further counts of possession of an extreme pornographic image, and five counts of possession of controlled drugs to commit a sexual offence.