One die, 28 dey miss afta China landslide

An aerial shot shows the damage after a landslide in south-western China. A large brown slash of mud and rock cuts through the otherwise green landscape.

Wia dis foto come from, Xinhua/AP

Wetin we call dis foto, Di landslide strike Jinping village for Sichuan province
    • Author, Laura Bicker
    • Role, China correspondent
    • Author, Tom McArthur
    • Role, BBC News
  • Read am in 3 mins

At least one pesin na im don die and 28 still dey miss afta one lanslide happun for south-western China, according to Chinese state media.

Di landslide wey strike Jinping village for Sichuan province around 11:50 am on Saturday (03:50 GMT) bury 10 houses plus trap many of di pipo wey dey live dia. Dem rescue two pipo.

Authorities don set up one command centre for wia di landslide happun, according to one statement from di kontri emergency management bureau.

China President Xi Jinping don give order, make dem do "all-out" rescue of pipo wey dey trapped.

Di President say make authorities do "everytin possible to search and rescue missing pipo, minimise casualties and properly handle di result", according to di official Xinhua state news agency.

Images from state media show one big collapse of mud and rock from one steep mountainside, wey cut through wetin be like one small village.

Hundreds of emergency workers dey search for survivors, according to one statement from China Ministry of Emergency Management.

Around 200 pipo na im dem been evacuate.

Map: A map showing the country of China. Within the borders of China, Sichuan province in the central southwest is highlighted
Wetin we call dis foto, Mountainous regions in China's southwest can be prone to landslides

Chinese Premier Li Qiang also ask for investigation into potential geological hazard risks for nearby areas.

According to local tori pipo reports, villagers bin say, dem don dey see large rocks dey frequently roll down di mountain since di last six months.

Li also say make dem evacuate area pipo wey dey under threat to prevent anoda disaster, AP news agency reports, citing Xinhua.

Fifty million yuan ($6.9m; £5.5m) na im dem allocate from di central goment funds to repair infrastructure and public services, AP add.

Di remote, mountainous parts of China south-west also dey vulnerable to landslides.

For January 2024, on elandslide for Yunnan province kill plenty pipo wen one steep cliff collapse, come destroy part of one village.

At least 18 pipo na im die fo anoda separate landslide for di same region 11 years before dat one.