Highlights of Alexander-Arnold time wit Liverpool as e announce say e dey comot

    • Author, Mandeep Sanghera
    • Role, BBC Sport journalist
  • Read am in 5 mins

Trent Alexander-Arnold get just three more games to play in a Liverpool shirt.

Di England right-back don confam say e dey leave Premier League champions Liverpool for di end of di season.

Di 26-year-old, wey bin don dey di club since e be just six, go dey out of contract on 30 June and dey expected to join Real Madrid.

First up of im remaining games wit Liverpool na home match against Arsenal on Sunday, bifor im trip to Brighton on 19 May.

Im final match go be back for Anfield against FA Cup finalists Crystal Palace on di final day of di Premier League season.

"Afta 20 years for Liverpool Football Club, now na di time for me to confirm say I dey leave for end of di season," Alexander-Arnold announce on social media.

"Dis na easily the hardest decision I don ever make in my life."

Alexander-Arnold na one of three high-profile players wey dia deals for Anfield run out dis summer, but while Mohamed Salah and Virgil van Dijk don sign fresh contracts in recent weeks, Alexander-Arnold go leave wen im own expire.

Highlights of Alexander-Arnold time wit Liverpool

Di Liverpool-born defender don make 352 appearance, score 23 goals and provide 86 assists for di club since e make im debut in 2016.

E don help dem win dis season top-flight title under Arne Slot and also win di Premier League under di Reds' former manager Jurgen Klopp in 2019-20.

Im oda trophies wit Liverpool include di Champions League in 2018-19, di 2022 FA Cup and two League Cups.

"Dis club don be my whole life – my whole world - for 20 years," Alexander-Arnold add.

"From di academy right through until now, di support and love I don feel from everyone inside and outside of di club go stay wit me forever. I go forever dey in debt to you all.

"But, I never ever know anytin else and dis decision na about to experience new challenge, take myself out of my comfort zone and push myself both professionally and personally."

Liverpool bin tok say Alexander-Arnold "go depart wit our gratitude and appreciation for im contribution during one sustained period of success".

'Now na di time to tell fans di truth'

Di contracts of Salah, Van Dijk and Alexander-Arnold don be major tok-tok point during Slot first season in charge, wit di Dutchman regularly being asked about dia futures.

Salah bin announce say e dey stay on a new two-year deal in April and dey followed by di following week.

However, di speculation about Alexander-Arnold bin continue, while Slot bin praise di defender on 18 April and say im future still "never done", Alexander-Arnold tok say e don wait to announce im decision as Liverpool now don secure di 20th top-flight title.

"Obviously plenti noise don dey around wetin di decision go be and how dat go look," Alexander-Arnold tok.

"I know say a lot of pipo say I suppose don tok sooner, a lot of pipo go say maybe I wait for di right time. But I feel personally say di focus suppose always be on di pitch, suppose always be about di football.

"Wen we bin dey title race and dey try push for trophies, na about to make di right decision for di team and try to not distract di team and take away from wetin we dey do on di pitch.

"Now wey we don win di league and we don dey able to celebrate am and celebrate dat kind amazing achievement, I bin feel like now na di right time to get am off my chest and tell di fans di truth, and now na dat time."

Liverpool bin reject one approach from Real Madrid for Alexander-Arnold in January and, while im decision to leave don come as a major disappointment to di club, dem believe say dem do all wey dem fit to convince am to stay.

Richard Hughes bin contact Alexander-Arnold representatives bifor e officially take over as Liverpool sporting director last summer.

Formal negotiations bin start to dey follow Slot confirmation as Klopp successor last May and, while contact dey ongoing during cordial and constructive negotiations, e become clear to di club say Alexander-Arnold no go sign new contract.

Hughes bin meet Alexander-Arnold representatives for one final time earlier dis Spring and, wit im decision to leave final, di player bin inform Slot.