Premier League don come back - See wen be di earliest time Liverpool fit win di title

    • Author, Sean Kearns
    • Role, BBC Sport
  • Read am in 5 mins

Di Premier League don return afta two week international break.

And just in case you don forget wetin dey sup for both ends of di table, we tanda to give una di full tea.

For di top, na Arne Slot runaway leaders Liverpool wey dey above second place Arsenal wit 12 points.

For di bottom - all three promoted sides wey be Southampton, Ipswich and Leicester don enta relegation zone wella and e be like say dia destiny na to immediately go for di Championship.

E be like mata of 'wen not if' those tins happun as we dey enta di final stretch of di season.

But wen e go dey known who dey go relegation and who go gbab di title?

Wetin Liverpool need to do to win di title?

Liverpool don currently dey at 70 points and dia nearest challengers Arsenal fit only get maximum of 85 points if dem win dia remaining nine games.

Di Reds require 16 points of possible 27 to gbab dia second Premier League title - and record equalling 20th title overall.

Fifteen points sef fit make dem win sake of say Liverpool goal difference beta pass Arsenal by far (currently +42 to +29).

In fact, bicos of dia goal difference supremacy, Slot side fit need only four wins as long as one of dem dey against di Gunners to gbab di title.

Wen be di earliest time wey Liverpool fit win di title?

Arsenal beat Chelsea for Emirates Stadium for dia game bifor di International break.

Dat victory reduce Liverpool lead for di table from 15 points to 12.

But wen e come to wen Liverpool fit win di title, e no really mata.

Di soonest wey dem go win dia 20th league title na 13 April wen dem play West Ham for Anfield.

For dat to happun, Arsenal need to lose dia next two matches against Fulham and Everton and den Liverpool go come beat Everton and Fulham.

Dat go leave Arsenal 18 points behind Liverpool wit only 21 points wey dey left to play for.

A Brentford victory against Arsenal for 12 April go leave di Gunners 18 points behind wit just 18 points to play for wey mean say Liverpool go need just one point against di Hammers on 13 April to claim di title.

Statisticians Opta give Arsenal just 0.8% chance to win di title and Liverpool bin get 99.2% chance based on dia positions now and di remaining matches.

Liverpool next five matches

Liverpool v Everton - 2 April - 20:00 BST

Fulham v Liverpool - 6 April - 14:00 BST

Liverpool v West Ham - 13 April - 14:00 BST

Leicester v Liverpool - 20 April - 16:30 BST

Liverpool v Tottenham - 27 April - 16:30 BST

Arsenal next five matches

Arsenal v Fulham - 1 April - 19:45 BST

Everton v Arsenal - 5 April - 12:30 BST

Arsenal v Brentford - 12 April - 17:30 BST

Ipswich v Arsenal - 20 April - 14:00 BST

Arsenal v Crystal Palace - 26 April - 17:30 BST

What about relegation?

Wolves 2-1 win against Southampton bifor di international break turn bitter blow for di bottom three.

Vitor Pereira side na di only realistic candidates wey go dey dragged to relegation battle, dat win carry dem go nine points clear of safety.

Both Leicester and Ipswich fit still get hope but time dey run out for dem to close di nine-point gap.

Wit 27 points wey dey left to play for, Wolves fit secure dia Premier League status if dem get 10 points for dia next four matches but only if Leicester and Ipswich both loose dia next next three games.

If e happun, Wolves go dey 19 points clear of di bottom three and dem go be only 18 points to play for.

Wetin go do Southampton?

Southampton need small miracle to stay up as dem dey 17 points under wit just 27 points wey remain to play for.

Instead, Ivan Juric side go dey fight so dem no go get di title of worst Premier League side eva.

As at now, dat title wit just points alone, na Derby County for 2007-08.

Paul Jewell side bin finish di season wit 11 points, less dan Sunderland wey bin get di title bifor wit 15 points.

Southampton need three points in dia next nine matches to pass di unwanted mark wey Derby set 17 years ago.

But di Saints dey also battle so dem no go be di earliest team for Premier League history to dey relegated.

Dat title dey di hand of Derby and Huddersfield Town side of 2018-19.

Both times, di two teams bin dey relegated afta game week 32 wen six matches still remain to play.

Southampton fit beat dat record if dem lose dia next two matches Dis na if Wolves win theirs.

Dat go leave di Saints 23 points behind Wolves wit just 21 points wey e remain to play for.

What about di top four?

Di teams wey finish for di Premier League top four go automatically qualify for di season Champion League.

Liverpool, Arsenal, Nottingham Forest and Chelsea na who currently dey di positions.

But as na just five points wey separate Chelsea wey dey fourth place and Bournemouth for 10th, e mean say dem be seven teams wey dey fight for fourth position.

Hold on, wetin fit do fifth place?

Dis na wia tins fit hard small.

As tins be so, to finish for di top four for di Premier League na di only official way to take qualify for di Champions League.

But e be like say England go dey granted anoda Champions League spot bicos of dia co-efficient ranking.

Dat mean say di team for fifth position go fit enta Champions League.

Di team wey dey dia na currently Manchester City. But na just four points separate City and Bournemouth for 10th place and all di teams wey dey di top half go like get dat extra spot.