Martial, Garnacho goals help Man Utd win Wolves for EPL

Manchester United win Wolverhampton Wanderers 2-0 for dia Premier League match for Old Trafford on Saturday.

Anthony Martial and Alejandro Garnacho score di goals for di home team in front of 73,500 pipo.

Dis game bin dey crucial for Man Utd wey dey try to maintain dia position among di top four.

Erik Ten Hag side go remain fourth but dey level on 66 points wit Newcastle wey dey third. Wolves, meanwhile, dey 13th.

Di visitors no really threaten di home team, in fact dem finish di game without a shot on target.

Checkout all di match highlights here.

Second Half

90+8 mins- Di referee don blows im whistle for di final time to end di match.

90+7 mins- Luke Shaw don collect yellow card from di referee for foul wey im bin commit earlier.

90+6 mins- Referee don give Alejandro Garnacho yellow card.

90+4 mins- Goal

Alejandro Garnacho find imself one-on-one wit di keeper afta im collect fine pass from Bruno Fernandes. Im take di shot early and score!

90+2 mins- Di attendance na 73500

90 mins- Na 6 min. of added time.

90 mins- Bruno Fernandes take di free kick and fire hot shot from di edge of di box. Unfortunately for am, di ball curl ova di crossbar. Dat na chance!

88 mins- John Brooks show yellow card to Craig Dawson sake of di foul.

88 mins- Craig Dawson fouls im opponent. Manchester Utd get free kick.

87 mins- Bruno Fernandes play short corner.

87 mins- Bruno Fernandes run towards goal but di defender get back on time to force corner. Manchester Utd force a corner. Dem don send men inside di box.

86 mins- Di corner from Ruben Neves dey cleared.

86 mins- Adama Traore pass deep inside di box and attempts to put di ball inside di right post, but im shot dey deflected away by one of di defending players. Na corner kick for Wolves.

85 mins- Bruno Fernandes find good position inside di box and na small remain e for be through ball from di edge of di area.

83 mins- Bruno Fernandes dey go toward di corner flag to take di set piece.

83 mins- Casemiro bends in one shot from di edge of di box towardsdi bottom left corner, but Daniel Bentley see am quick and make comfortable save.

82 mins- Substitution. Alejandro Garnacho don enta, Jadon Sancho don comot.

81 mins- Substitution. Fred don enta Christian Eriksen don comot.

81 mins- Erik ten Hag decide to make substitution. Raphael Varane don comot for Harry Maguire.

81 mins- Nelson Semedo find space to cross from di side inside di box, but e no threaten United.

78 mins- Anoda substitution. Raul Jimenez go replace Diego Costa.

76 mins- Daniel Bentley jump to collect di ball from di corner wey Christian Eriksen play.

76 mins- Bruno Fernandes play di ball inside di box from corner, but one of di defending players clear am. Di referee points go corner flag and Manchester Utd go take another corner.

75 mins- Julen Lopetegui don decide to make change. Adama Traore go replace Mario Lemina.

75 mins- United take di corner but dem no take advantage of am.

75 mins- Jadon Sancho zig-zags im way inside di box and play one low shot towards di left post, but di goalkeeper pulls off asuperb stop.

73 mins- One of Wolves players dey through on goal but United defender foul am inside di box. Dat fit be penalty, but ref say NO! Play continues.

73 mins- Total attempts – 20:5.

70 mins- Surely dis na handball by one of the Wolves players inside di box, but referee just wave play on!

70 mins- Good clearance by Wolves defender mean say corner nothing come out for Manchester Utd.

69 mins- Di referee stop play for substitution, Wout Weghorst go replace Anthony Martial.

68 mins- Di ball go out of play. Manchester Utd get throw-in.

66 mins- Casemiro play neat ball inside di box towards di direction of Bruno Fernandes, but im no fit reach am.

65 mins- Fine solo run by Bruno Fernandes take am deep inside di box, but Daniel Bentley catch im weak effort towards di bottom left corner.

62 mins- Julen Lopetegui prepare one substitution. Toti don comot for Hugo Bueno.

62 mins- Substitution. Daniel Podence don replaces Matheus Cunha.

61 mins- Di game don match small break sake of di knock wey Bruno Fernandes get but dem dey check am.

61 mins- Bruno Fernandes try to break free, but Wolves player clear di ball away.

60 mins- Manchester Utd no profit from di corner as di defence clear di ball up field.

58 mins- Hee-Chan Hwang win di ball from corner kick and strike. But na weak effort.

58 mins- Ruben Neves step up to cross di ball.

55 mins- Di corner find Max Kilman wey dey unmarked but im close-range header dey poor and e go wide of di left post.

55 mins- Ruben Neves deliver di corner kick.

54 mins- Daniel Bentley clear di danger afta Anthony Martial try collect through ball from just outside the box.

51 mins- Mario Lemina need medical treatment, so di referee stop play and signals for di physio to come pitch

49 mins- Manchester Utd take short corner instead of sending di ball inside di penalty area.

48 mins- Anoda chance for Antony inside di penalty area, im shot beat di goalkeeper but defender clear am off di post.

46 mins- Second half don start

First Half

45+3 mins- Di match don reach half-time.

45+1 mins- Ruben Neves play di free kick but e no worry di home team.

45 mins- Two minutes added time

45 mins- Na throw-in to Wolves.

43 mins- Daniel Bentley pulls off a great save to block Varane header afta United play fine cross. cross.

43 min- Luke Shaw play short corner instead of sending di ball inside penalty area.

42 mins- Christian Eriksen take di corner but one of di defenders clear am.

42 mins- One of di defenders react at di last minute to block Bruno Fernandes pass. Manchester Utd get corner kick.

41 mins- Toti try to find Matheus Nunes, but im put too much power. Di ball go out of play.

40 mins- Wolves defence clear cross from United

39 mins- Di total attempts – 11:1.

37 mins- Casemiro don collect yellow card.

36 mins- Manchester Utd dey control tins wit a series of short passes.

33 MINS - GOAL

Inside di net! Antony pass out to Anthony Martial and e dey too easy for am to play di ball inside empty net. The score is 1:0.

30 mins- Luke Shaw fire shot from di edge of di box, but e no worry di goalkeeper as im effort dey blocked by a defender.

29 mins- Cross from corner kick by Wolves is too strong and di ball go out of play.

28 mins- Bruno Fernandes play direct shot from one dangerous free kick position. Di ball go ova di top left corner, but di goalkeeper make quick save to deny am.

27 mins- Referee John Brooks sees di trip by Matheus Nunes and no waste time to blow im whistle. Free kick to Manchester Utd for dangerous position.

25 mins- Wolves get chance to score from corner kick, but United defender clear di ball.

23 mins- Raphael Varane receive correct pass and make space for imself for di edge of di box, but im shot go ova di bar.

20 mins- Nelson Semedo behaviour break di rules. Him bin dey too careless wit im challenge.

17 mins- Jadon Sancho dribble im way past challenges, but Wolves player don collect di ball. Di ball don go out of play and na goal kick.

15 mins- Tempers dey fly afta Diego Costa challenge, e receive yellow card from di referee.

14 mins- Wolves defence block Aaron Wan-Bissaka pass inside di penalty area

12 mins- Di referee and di linesman signal a throw-in for Wolves.

11 mins: Varane send one low pass for Wan-Bissaka for di right touchline straight out of play.

Na bad start from di World Cup winner on im return from injury.

9 mins- First big chance fall to United winger as Kilman slip before im collect Dawson pass.

7 mins: Bad pass from Varane, back to De Gea, di goalkeeper dey forced to concede corner.

5 mins- Throw-in for Wolves.

3 mins- Patient build-up play from Manchester Utd as dem dey try unlock Wolves defence.

2 mins - Bright early start from Man Utd, dem dey dominate possession for Wolves half.

I min- Game don start