Trump say trade tok-tok wit Canada don 'end' afta anti-tariffs advert

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Osmond Chia
- Role, Business reporter
- Read am in 5 mins
US president Donald Trump don announce end to all trade negotiations dem dey do wit Canada sake of one advert wey criticize di tariffs wey him impose on di nation.
Di advert wey one Canada province govment of Ontario sponsor, quote wetin former US president Ronald Reagan tok say tariffs "dey hurt every American".
Trump write for social media say di advert na "FAKE" and "egregious", add say dem dey terminate di trade tok-tok.
Im administration don impose 35% levy on many goods from Canada and individual tariffs wey target particular industries like car and steel manufacturing.
Dis don hit Ontario hard.
Trump allow exemptions to goods wey fall under di free trade agreement wey im negotiate wit Mexico and Canada during im first term.
But Canada Prime Minister Mark Carney don dey try strike deal wey go ease di US tariffs since dem elect am.
But Ontario Premier Doug Ford bin don dey complicate di matter, unto say im be pesin wey dey very vocal on how im dey criticize taxes wey wey Canada dey levy on US firms wey dey buy Canada products.
For di one minute advert wey dem publish last week, you fit hear di voice of Reagan ontop of pictures wey include New York Stock Exchange and cranes, wey dem put US and Canada flags.
Di video collect some parts of Reagan address for national radio for 1987 for wia im tok about foreign trade.
"Wen pesin say make we impose tariffs on foreign imports, e dey like say dem dey do patriotic tin to protect American products and jobs. And sometimes e dey work, but na for only a short time.," na so Reagan tok for di advert.
"But as time dey pass, dat kain trade barriers go begin hurt every American worker and consumer.
"High tariffs dey make foreign kontris to retaliate and trigger fierce trade wars…markets go shrink and collapse, businesses and industries go shutdown and millions of pipo go loose dia jobs."
Ronald Reagan Foundation - group wey dey preserve im legacy - release statement on Thursday say di advert select audio and video wey e use, say di advert misrepresent di former president address and no tok why. Dem accuse di Ontario govment say dem no seek permission to use or edit di remarks.
Di foundation say dem dey "review dia legal options". Trump say dem design di video to interfere wit Supreme Court decision wey go happun for November on whether Washington major tariffs on many nations dey legal.
Di court decision go represent di biggest test of Trump presidential authority and fit force di US to refund billions wey dem collect in di name of tariffs.
Though di one minute advert only include excerpts from di original five minutes long address, e no alter Reagan words.
Dem change di order wey im take make di comments, dem take some parts from di end of di original speech, join am with phrase from di early part of di speech.
Di title of di original address na - Address to di nation on free and fair trade - dis na regarding some set of tariffs wey di Reagan administration bin sama ontop some goods from Japan.
Reagan bin wan use di speech to explain why im introduce dose tariffs for dat special case, even wen im believe say to impose tariffs and barriers no be wetin im dey like do.
E tok say im wan lift am as soon as possible to promote di prosperity and economic development wey only trade free fit bring. Dis na wetin im stress throughout di speech.

Wia dis foto come from, Getty Images
Dem run disaster as part of campaign wey worth 75 million Canadian dollars (£40m; $54m) on mainstream TV channels for US. For di post wey accompany di advert, Ford write say "we no stop to dey make case against American tariffs on Canada".
China embassy for Washington also use similar Reagan clip to post on X to cast doubt on Trump global tariffs earlier dis year.
Ontario na Canada most populous province and di largest regional economy. E don suffer di most sake of di US tariffs. Ford hit back on Trump earlier tariff threat against Canada say im dey willing to cut off power supply to di US.
E describe Washington trade policies against Canada like pesin wey don draw knife and "yank am into us" and call US lawmakers to put pressure on.
Some of Trumpnlevybon Canada include di 50% levy on metals and 25% levy on automobiles.
White House global tariffs on steel, aluminum and cars hit Canada hard, force job losses and put pressure on businesses.
Carney and Ford neva comment on Trump announcement.
Dis na second time Trump dey say im dey cease trade talks wit Canada, afta Ottawa announce say be go impose digital service tax on US technology firms earlier dis year.
Wen Canada recall di tax, White House say Carney cave to pressure from Trump.









