Nigerian police dismiss officers wey kpai 28-year-old man for Delta State

    • Author, Gift Andrew
    • Role, Reporter
  • Read am in 4 mins

Di Nigeria Police Force say dem don dismiss di officer wey dey involved for di killing of 28-year-old Mene Ogidi for Effurun, Delta State, south-south Nigeria.

Police give dis update on Wednesday 29 April, 2026 wia dem identify di officer wey use gun end di guy life as ASP Nuhu Usman.

"On di directive of di Inspector-General of Police, IGP Olatunji Rilwan Disu, all officers wey dey connected to di incident dey immediately withdrawn from di Delta State Command and transfer to Force Headquarters, Abuja, wia dem bin dey subjected to expedited disciplinary proceedings."

Di Force Disciplinary Committee (FDC), alongside oda internal disciplinary processes, don concluded dia review, Force tok-tok pesin DCP Anthony Okon Placid tok for statement.

"Findings establish unequivocally say di principal officer, ASP Nuhu Usman, bin act in gross violation of Force Order 237 and oda extant regulations wey dey govern di use of firearms. Im actions bin dey unlawful, unprofessional, and clear betrayal of di oath to protect life and uphold di law," e tok.

"Consequently, di FDC don recommend di immediate dismissal of ASP Nuhu Usman and oda officers wey dey culpable. Di Inspector-General of Police don approve di recommendations and forward same to di Police Service Commission for ratification in line wit due process."

Police say afta di administrative procedures, dem go hand ova di affected officers to di appropriate judicial authorities for prosecution for dia roles for di extrajudicial shooting.

Dis latest police kasala don dey ginger many tins for Nigeria, as youths gada for Delta State to protest.

For di video, di victim wey sidon for ground dey beg di officer say im no know anytime but im go carry dem go to di pesin wey send am to collect one item.

Tori be say im bin go waybill package for one logistics company wey turn out to be guns.

Some locals say di victim receive waybill for motor park, but di drivers discovers say di parcel get gun inside.

As im come to pick up di parcel, dem catch am and den alert police.

But as police arrive, instead of to carry di suspect and investigate di mata, dem shoot am dia.

Di video show say di officers no listen to am, two police officers dey try cock dia gun for about one minute, dem remove di magazine of di gun and put am back.

Bifor dem shoot di suspect, im dey shout "officer abeg I go tell you evritin, na my friend deceive me. E dey Sapele".

"Abeg abeg, I no know anytin concerning am, I go carry you go meet am, e dey Sapele like dis, officer I go carry you go meet am abeg, officer, I go carry you go meet am officer, officer... I no know - officer abeg, I go carry you go meet am."

As e dey beg, di officers dey busy dey cock dia gun. As dem cock di gun, di officer wey dey on mufti release di bullet into di victim and e slump immediately.

Afta dem shoot am, dem carry am put inside dia vehicle and move am go dia station.

Tori be say dem shoot am more times for dia station bifor e die.

Di video dey trend for social media as pipo dey condemn di action of di police.

Pipo enta social media to demand make police IG mandate all dia officers wey dey on duty to dress properly and wear name tags for easy identification.

Nigeria police dey notorious for extrajudicial killings, brutality and assault, dis lead to di popular EndSARS protest wey happun for 2020, and later authorities disband di police department known as Special Anti-Robbery Squad (SARS).

But years after, stories of incidents of police brutality and extrajudicial killings still dey make di rounds for di kontri.