'We no dey legally married na introduction we do' - Olakunle Churchill react to controversy wit Rosy Meurer

Read am in 4 mins

Nigerian businessman Olakunle Churchill don describe as fake, tori wey dey spread say im and Roseline Meurer, wey pipo sabi as im wife don divorce.

For one statement on im official Instagram account, Churchill wey be di ex-husband Nigerian actress Tonto Dike clear am say im and madam Meurer no dey legally married and na only introduction dem do.

Dis im reaction dey come afta tori begin spread say actress Meurer don file for divorce from am. Di tori begin fly from di time e reconcile wit im ex-wife Tonto Dike and get access to im 10-year-old son.

"No legally recognized marriage. No church wedding and no court wedding. Wetin we do na introduction. Therefore, di idea of a 'divorce' dey baseless from di beginning."

E add say make pipo ignore all dat tori about divorce, as e no hold any truth.

Oga Churchill claim say dem neva serve am wit any divorce documents and question di divorce papers wey dey fly up and down.

"Any legitimate legal process go need say make all parties dey formally served and given di opportunity to respond. I was never served," e tok.

Di relationship of Churchill and Meurer begin gain traction for social media afta im ex-wife Tonto Dike announce say she don reconcile wit her ex-husband and 10 years of bitterness don end.

Churchill bin confam di reconciliation as e tok say true-true, im don settle di differences e get wit im ex-wife.

Afta dia reconciliation, anoda tori wey fuel break up rumour for Churchill and Muerer relationship na one recent post wey e tok say im go always choose im children always without hesitation.

Na afta dis post tori about dia divorce begin fly. Although Meurer neva confam or deny tori about di divorce.

Meanwhile, Churchill for im post also address one divorce documents wey dey spread on social media.

E question di legality of di documents and suggest say pipo witout experience dey advise Meurer incorrectly.

"I dey 100% sure say e get some pipo wey no get experience for dis media space wey dey advice Rosy incorrectly, plus legal practitioners wey dey practice under mango tree wey without due process claim to produce divorce documents within 24 hours."

Di businessman no stop dia, e also touch on im past relationship wit actress Tonto Dikeh, wey dem togeda get son, King Andre.

Di former couple bin get very public and messy split years ago, wey dey filled wit allegations and online exchanges.

E say both of dem don choose to forgive each oda and e believe say she don change and dey for beta place now.

For di lengthy post, Churchill also tok say im no agree wit di narrative wey dey spread say Rosy stand by am wen tins dey toxic wit im and im ex-wife.

"While I acknowledge say she face public criticism, e dey important to state say if she no dey dia, anoda pesin for occupy dat position for my life. Issues within my relationship suppose dey left for me to address, wey include defending her for public wen necessary," e tok.

Churchill and Meurer don dey togeda for almost six years. Dem get two children togeda.