Ezra Olubi tok im side of di tori afta Paystack sack am

Ezra wear black robe and stand in front of one building surrounded by flowers. E wear choker round im neck and also wear lipstick.

Wia dis foto come from, EZRA OLUBI/TWITTER

Read am in 4 mins

Di co-founder of Paystack, Ezra Olubi don collect sack letter from di company wey e follow create.

Dis dey according to statement wey Paystack release wey reveal say dem fire am since Saturday.

Di sack dey come afta kasala wey burst on social media afta some of im old tweets start to come up.

According to di statement, "im recently resurfaced public tweets don cause beta negative reputational damage to di company and no follow wit wetin our values be and di standards wey we want from anybodi wey dey leadership position."

Dem also add say dem don follow due process to end im employment including di financial obligation, howeva e no go stop dia independent investigation into di mata of workplace misconduct.

Dis na as dem tok say, "dis one dey seperate from di independent investigation into accuse of work place misconduct wey still dey go on. Di review, na Aluko and Oyebode dey run am. Na external law firm wey di Board appoint. E dey go on independently and we go come share update wen e don finsh."

But Ezra Olubi wey don dey inside full scale kasala ova di old tweents mata ova di month, don respond.

For blog post wey im call, Terminated, e tell im own side of di tori on how e find out say dem don sack as e call out di way di investigation take go.

E tok say, "on Saturday, 22 November 2025, dem tell me say my employment don dey terminated. Dis decisoon bifor dem even finish dia supposed investigation and witout any meetinf, hearing or opportunity to allow ansa di mata wey dem raise. Dat one dey against di terms of di suspension and Paystack internal policies."

E add wetin e dey plan do afta di sack say, "my legal team dey review di process wey cause my so called termination, wey go include how e link wit internal policies. From dia dem go do wetin dem see as di appropraite way to run am. I no go tok pim on top dis mata again for now".

For im blogpost statement, e tok why e really no chook mouth for di mata of di old tweets wen kasala start to dey burst.

E tok say, "ova di past few days, my name and reputation wey I do build ova years as co-founde and technical leader for Paystack don dey called into question bicos of some informate wey we dey share online. Bicos of datm di Board of Directors for Paystack bin place me on suspension and start wetin dem call independent investigation.

"Wen dem start di process, I decide say I no tok come outside. I do am so e no go interfere wit di investigation bicos I bin dey expect say e go be fair, thorough and unbiased review of di allegation wey dem bin dey discuss online. Dis come leave room for assumptions nad misrepresentations to dey spread witout challenge".

Di mata start wen di ex partner of oga Olubi comot to accuse am of abusive behaviour for di case of dia relationship togeda.

Dis one come open di Pandora box as pipo start to dey check im tweets from im now deactivated X account wia e bin allegedly tok some kain tins wey include from May 2011 wia e alelgedly ask im followers to touch co-worker in appropraitely.

E bin also get post wia e tok about 16 year old girls for Anime for suggestive manner and also tok say e nack im cat.

As di mata start to dey escalate, na so Paystack put di Chief Technical Officer on suspension on top di mata for 13 November bifor dem sack am less than two weeks later.

Who be Ezra Olubi?

Ezra Olubi according to im LinkedIn account na Nigerian entrepreneur, co-founder and CTO for Paystack.

E be Software development veteran, technology consultant, needs assessment expert and e get specialties for Online Payments, Business Automation, Consumer Web, Ecommerce Systems.

E also don work wit plenty ogbonge organizations.

Dem born Ezra for 1986 for Ibadan, Oyo state, South West Nigeria.

American financial services company Stripe for 2021 bin acquire Paystack for a reported $200 million.

Ezra and Shola Akinlade establish Paystack for 2016 as a solution for merchants for Nigeria and Ghana to receive payment anywia for di world.

As at 2021, Paystack bin dey process ova 50% of all web payments for Nigeria, as well as payments for ova 60,000 organisations, including FedEx, UPS, South African mobile operator MTN and many odas.

Ezra na also OON, Officer of the Order Of The Niger.