England beat brave Nigeria 4-2 on penalties for World Cup

England beat brave Nigeria 4-2 on penalties for World Cup

Wia dis foto come from, Getty Images

England beat Nigeria 4-2 on penalties to reach di quarter-finals afta di game finish 0-0 afta extra time.

Dis one break di heart of di Super Falcons wey dominate mist part of di game.

As England struggle to lead di game from di beginning, Nigeria no gree as dem hold di game to a goalless draw for Brisbane.

Nigeria play unbeaten run reach di last round of 16 for di tournament.

Dia confidence grow wen Michelle Alozie begin dey create chances for her team but Alessia Russo no allow goal enta di net.

For di first-half, Ashleigh Plumptre almost end di goalless run of England as she enter wit a crossbar, but dia European opponent no gree.

England wey don reach dia 16 consecutive Women’s World Cup matches begin dey try wen two of dia players Russo and Rachel Daly force goalkeeper Chiamaka Nnadozie into dangerous action.

James chop red card for deliberate foul on Alozie

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Lauren James chop red card for deliberate foul on Alozie

Di England team get one chance for penalty wen Rasheedat Ajibade do foul for Daly, but di referee Melissa Borjas overturn di chance after im check VAR.

Nigeria begin dey hold di Lioness down wit brilliant display as Uchenna Kanu show her pepper for dia defence line wit different header. England goalkeeper Mary Earps no gree as di ball dey enter crossbar.

Frustration begin dey show for di England team as dia to player Lauren James chop red card.

Referee send her comot for pitch after she fall Michelle Alozie and still step ontop am.

Nigeria later take full control of di game for di second half enter extra time. Alozie begin dey get more chances from six yards but her shot no gree enter net. Di England team come dey struggle to carry di game enter penalty.

Penalty shoot-out

Di tension during di shout-out dey very threatening. Georgia stanway first play penalty for England but she fire am go wide, e no even go goalkeeper position.

As we dey expect make Nigeria take di lead, Desire Oparanozie play her own penalty shout-out go wide too. Di disappointment show for her face.

Alozie miss her penalty for Nigeria before Daly come score her penalty for England. Di spectacular Rasheedat Ajibade no miss her chance for Nigeria.

England hope come enter strong level afta Alozie miss her penalty wey come give di team opportunity to lead wen Chloe Kelly strike di decisive penalty.

Na di goal send England enter di last round of eight wit a 4-2 finish ova Nigeria.

Second Half

England vs Nigeria

Wia dis foto come from, Getty Images

120+3 mins FULL-TIME

England 0-0 Nigeria

OK, match don end.

Na penalty remain.

120 mins: Dem don add three minutes and we go enta penalty shoot out.

118 mins: England 0-0 Nigeria

Pressure!!

Di ball almost enta!!

Asisat Oshoala shapely for inside di box but shot wey she fire enta Mary Earps hand.

116 mins: Chaaaiiii!!!

Two players nod diasef and dem dey nurse head injuries afta dem challenge each oda. Rachel Daly quickly stand before Rasheedat Ajibade come follow.

112 mins: England dey do wetin dem fit do make Nigeria no go beat dem. Dem dey manage to get header from di back den hold di midfield.

Eight minutes left.

109 mins: Asisat Oshoala bin use bicycle kick take make contact for inside di box but she no succeed for dis extra-time.

England continue to dey put pressure

106 mins: SUBSTITUTION

Beth England dey on for her team, wit sub Chloe Kelly - wey don perform thankless task for di field.

HALF-TIME

106 mins: Dis fifteen minutes go be like fifteen years becos any team wey win for here go enta next stage and di loser go dey go house.

Even Lucy Bronze don begin dey get mental fatigue. England just dey very lucky.

105 mins: HALF-TIME

England don survive 15 minutes. Anoda 15 mins to go. Dis na di real heat, pressure and tension

100 mins: Anoda ball chop bar again.

Asisat Oshoala charge from dat angle till she tip di ball across di bar reach next line.

98 mins: What a chance!!!!

Nigeria Michelle Alozie for don put one goal in for Nigeria. Space plenty for her to control and score di goal on di left box but she play di ball wide.

97 mins: England get di ball at di right end of di pitch but di minutes dey catch up wit dem. Nigeria dey quick for ball and dem dey do more.

KICK-OFF

Na di last 16 of di World Cup.

Dis game na 11 v 10 as dem don enta extra-time.

90+6 mins: FULL-TIME: England 0-0 Nigeria

Dis game get everything but goal no dey. Unfortunately, England get red card for one of dia star player, Lauren James.

England go need extra energy for dem to keep dia World Cup hope alive.

Extra time dey on di way

90+3 mins: England dey use all dia energy and dem dey try reserve some too. Di match tough for dem as dem dey try break into Nigeria defence.

Di match fit enta extra-time.

90+3 mins: England dey down for di first three minutes of di added six wit sensible possession.

90 mins: Referee add SIX more minutes more.

88 mins: SUBSTITUTION

England make dia first change. Alessia Russo replace Chloe Kelly.

88 mins: RED CARD

Yeeeee. Lauren James don chop red card oooo.

75 mins: England win one corner. Dem go fit snatch something from dis as we enta di last 15 minutes?

72 mins: Oh jeezzzz, di ball go wide

Uchenna Kanu dey use her strength to fight for di necessary space and meet di corner, but her effort go off target. Anoda chance for England.

70 mins: Now we dey look which team go first score one goal for normal time and e fit be di likely winner.

69 mins: Plenty shout from di crowd as Oluwatosin Demehin neatly stop one England player. Her pass no fit match di skill.

67 mins: Georgia Stanway drive enta corner into di six-yard box but e no convert to goal. England dey fear but no shaking as both teams dey sweat.

63 mins: Rachel Daly get one free-kick from di referee.

Lauren James finally get some space to work in but she no fit do anything from di left side of Nigeria box.

59 mins: Substitution - Nigeria superstar Asisat Oshoala don enta. Remember say she enta against Australia and she score goal.

She enta for Ifeoma Onumonu.

England dey shake but di shaking no go helep dem.

57mins: Alessia Russo charge for di middle as Alex Greenwood see free-kick. She dey too fast because di ball dey behind her and wen she touch di ball, na wide she play am.

Na di first time wey England go get beig chance be that.

53mins: Di corner wey England play dey heavy but Ashleigh Plumptre block am. Anoda free kick touch head of player but e no enta Nigeria net.

51mins: Uchenna kanu dey put plenti pressure ontop di England team. She dey show dem shege for di defence line wii plenti header wey reach her side.

49mins: Yeeee!!! Falsons hit bar

One cross wey touch Uchenna Kanu head for don enter net. She dey above Rachel Daly but dat header chop di bar before e go above di net.

England 0-0 Nigeria

We go again, this time na to conclude di match

45mins: Kick-Off

First Half

England beat Brave Nigeria 4:2 by penalty

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, England beat Brave Nigeria 4:2 by penalty

HALF TIME: England 0-0 Nigeria

45 +3mins: Haaa, Dat one dey close to goal!!!

One lovely link up give Lucy Bronze di chance to enter di box to deliver, but one heavy touch from di opponent comot di ball from her leg.

45mins: Chiamaka Nnadozie no looseguard as cross show for her front from di left.

42mins: Lauren James dey waka around di box for every corner as she dey find one big volley wey go enter di net. She get one chance but she fire am wide open.

38mins: Fantastic defending. Plenti goal-saving blocks from Jess Carter.

Nigeria fit take di lead, but e dey block.

Two blocks from England still put di match for 0-0. Di block na from Uchenna Kanu wey Millie Bright block, di second from Christy Ucheibe no reach Mary Earps.

33mins: Di VAR dey check wetin happun as im move go di screen. England get golden chance but e never dey clear if na foul.

35mins: Penalty overturned!

Nigeria dey happy as chance wey England get to lead di game don wipe away.

30mins: Half an hour don go already and di match still dey tight. Na good moment for di stadium as Nnadozie save one goal comot for post.

England 0-0 Nigeria

28mins: Lauren James dey capable of plenti incredible action. She fire one volley shot from across di right. As di defender no gree for her shot, ball enter corner.

26mins: Di Nigerian fans no wan gree for di corner side wey Chiamaka Nnadozie dey as dem don begin dey drum.

Na five shot on goal don dey so far- and di strike from Alessia Russo na England first shot on goal.

24mins: Lauren James never see too touch ball, na only seven touches and three passes she don get so far.

18mins Nigeria dey very ready for shots now. England dey under serious pressure.

One thunderous effort from Ashleigh Plumptre from di edge of di box touch di bar.

Mary Earps dey forced into a decent save from one shot from Michelle Alozie

15mins: Nigeria don begin dey hit di ginger. Interesting match-up dey between Kanu and Greenwood from di left hand. Greenwood dey try protect di central area.

England 0-0 Nigeria

13mins: Nigeria win anoda corner after one fast break free Unchenna Kanu before dem tackle am

10mins: Rasheedat Ajibade give one heading wey force Mary Earps to punch di ball go corner

9mins: Nigeria don finally see ball play but England dey alive to withstand any threat. Jess carter dey alert and im dey track Toni Payne

England 0-0 Nigeria

1min: KICK OFF