'I dey embarrased' - Popular TV presenter Serwaa Amihere tok for di first time afta sex video leak

Wia dis foto come from, Serwaa Amihere/Instagram
Popular female Ghanaian TV presenter Serwaa Amihere don tok for di first time since her intimate video bin go viral on internet.
She open up few weeks afta Ghana police arrest three pipo for leaking di video on top social media.
Ms Amihere for one statement she post on her Instagram account on Wednesday night 24 April say di video really embarrass her, her family and her loved ones.
E also expose her employers plus di businesses and brands she represent to embarrassment.
At di time di video leak, plenti pipo bin bash di GHOne TV presenter on social media.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Di short video bin show di media personality for bed wit one man, wey police don identify as Henry Fitz.
Henry Fitz na her ex and di two of dem bin dey on top bed and e dey kiss her for neck and back.
Tori bin fly at di time say na di man leak di video afta im allegedly blackmail di presenter for many weeks.
End of Di one wey oda users dey read well well
Ms Amihere however don clear am now say, di video na from five years ago and di pipo wey share am online bin threaten and collect money from her hand for five months before police finally arrest dem.
She say she dey sorry for di embarrassment, disappointment and frustration di mata don cause her family and di brands wey she represent. She add say she don learn her lessons and dat kain tin no go ever happun again.
“Sincerely, I say sorry for di embarrassment, disappointment and frustration which dis mata don cause my family and loved ones, to the distinguished businesses and brands I represent, and to you.”
Police charge three pipo for allegedly leaking d intimate video
For 8 April, Police bin charge three pipo for di alleged publication of di intimate video of di popular female Ghanaian TV presenter, Serwaa Amihere.
Di three chop accuse say dem leak di video for social media.
Police charge Edem Saviour Ketti (filmmaker), Candylove Ababio (trader) and Henry Amponsah wey pipo sabi as Henry Fitz (businessman), di main suspect for allegedly sharing di video..
Di three don dey face four counts wey dey related to sexual extortion and di distribution of di intimate video of Serwaa Amihere.
Some of di charges dey include conspiracy to commit crime, wey be non-consensual sharing of intimate images contrary to section 23 of di criminal offences act.
Dem also chop accuse for sexual extortion contrary to section 66 of di kontri cyber security act 2020.
According to court document, one of di three pipo, wey be Henry Fitz dey at large.
Na im many pipo tok say leak di video afta im allegedly blackmail di presenter.
Di police don take di action afta di TV presenter file official complaint ova di video leak.
How di suspects allegedly blackmail di presenter

Wia dis foto come from, SERWAA AMIHERE/ @DRURYGH/TWITTER
Police accuse di suspects for allegedly leaking di video afta im allegedly collect Ghc 25k ($1900) from Serwaa.
For di charge sheet, dem tok say di suspects don call di TV presenter im makeup artist on 3 December 2023, “to demand Ghc 5k ($380) odawise dem go leak im nude pictures.”
Na so dem allegedly give di makeup artist one mobile number wey get one of di suspects im name (Edem Saviour Ketti) to send di moni.
Di charge sheet tok say for 2 April, 2024, di same pesin don call di presenter wit anoda number to demand additional Ghc 20k ($1500).
Di pesin tok say make she pay di moni in one minute, odawise dem go leak di video.
But afta dem receive di moni, dem still allegedly leak di video for social media, according to di charge sheet.
Afta Serwaa Amihere for 3 April file complaint to di police, di service don arrest two of di three suspects.
Di charge sheet tok say Edem Saviour Ketti “admit to say im use im Ghana card to register di number wey dem use to collect di moni from di presenter.”
Police launch manhunt for Henry Fitz, wey be di main suspect for di mata.
Henry na businessman wia dey own some companies including one hotel for eastern region of Ghana.
Tori be say na im and di TV presenter dey inside relationship at a time wen Henry don do ogbonge wedding for 2019.
Dat wedding na di tok of social media at di time, sake of Henry hire one pleasure resort for di entire weekend for di exclusive wedding.
Who be Serwaa Amihere?

Wia dis foto come from, Serwaa Amihere/Facebook
Serwaa Amihere na popular television broadcaster and social influencer for Ghana.
She dey work plus Accra based GhOne TV but her big presence for Twitter and Instagram na major boost to im personality for di kontri.
She start off her media career as entertainment presenter, but she switch to news and current affairs for 2017.
For 2017, dem award her Best Newsroom Staff of di Year.
She win dis award within di private television company sake of her insight, enthusiasm and dedication to news production.
As her career take new turn away from di soft nature of entertainment news to news and currents affairs, GhOne managers give am on di job training which help turn her into proper news and current affairs anchor.
Through hard work, she instantly dominate di airwaves plus her personality and interviews which sometimes dey go viral.
In 2018 she win di Radio and TV Personality Awards as Best TV Newscaster of di year.
She win same RTP Awards in 2019 and 2020 respectively.
Apart from being a journalist, Serwaa na fashion icon and brand influencer.
She create side business out of dis wey she start dey market products give brands who dey operate within de beauty industry.
She dey market to her ova 2 million Instagram followers products from known to new brands wey dey enter de Ghanaian market.
She influence thousands of young ladies plus her her fashion style - something which solidify her image as de topmost fashion icon for Ghana.
Dem born Serwaa Amihere on March 8. 1990 to en father Frank Yeboah den Lydia Tetteh en mother.
She do her secondary education for Yaa Asantewaa Girl's SHS wey she earn degree in Banking and Finance for Methodist University College, Ghana.
Punishment for sharing nudes of oda pipo for Ghana

Wia dis foto come from, Getty Images
Sharing nudes and child grooming na crime for one law di kontri pass for 2020.
Based on dis law for di cyber security act 2020, any pesin wey engage in publishing pictures of children or adults go fit face 5, 10 or 25 years in jail.
De law also dey address child grooming for sexual abuse
Pesin wey dey involved for sexual abuse or aiding and abetting or cyber stalking a child go fit land pesin between 5 to 15 years jail term.
Pesin wey go share naked images online or on social media platforms go face fine of between $5,200 den $10,000.
Threatening to circulate nude images for cash
In addition to dis, di law make am clear say any pesin wey go also threaten to send someone nude pics go also face di law.
According to di cybersecurity laws, threat to circulate nude photos or videos in exchange for cash, dey attract 10 to 25 years in jail.
Willful sharing of nudes
According to Section 278 of the criminal code, pesin wey go publicly and wilfully publish dia own nudes, commit grossly indecent act wey be misdemeanour.














