Ireland crashout as Nigeria finish second of Group B behind Australia

 Asisat Oshola of Nigeria and Payne of Republic of Ireland

Wia dis foto come from, Getty Images

Nigeria Super Falcons end di Republic of Ireland World Cup campaign as di match end goalless.

Nigeria draw against Ireland make dem finish second for Group B behind co-hosts Australia.

Australia beat Canada 4-0 to top Group B and force Nigeria to second place.

Nigeria and Australia qualify for di Round of 16.

Di Irish team don already comot afta Australia and Canada beat dem but collect dia first point for World Cup dia final match of di tournamentagainst Nigeria.

Nigeria go face di winners of Group D in Brisbane, wey fit be England if dem draw or beat China on Tuesday.

Second Half

Ireland 0-0 Nigeria

90+7 Match don end

90+6 Last chance for Nigeria as Rasheedat Ajibade fire one waeak shot wey Courtney Bosnan catch.

90+5 Sunstitution for Ireland, Fathey don comot and Caldwell relace her.

90+3 Ireland dey mount pressure for di Nigerian defence, but di Super Falcons defenders dey contain dem.

90'Referee add 7 minutes extra time.

90' Both teams dey try dia best to get sometin out of di match but na deadlock till now.

84' Abbie Larkin and Marrissa Sheva don enta as Heather Payne and Lily Agg comot.

84' Substitution for Nigeria Blessing Demehin don enta

83'E be like say Chiamaka Nnadozie don get head injury afta she collide wit one Irish player to save ball Katie McCabe high ball

80' Na battle of di midfield as Nigeria and Ireland dey fight for possession for di midfield.

75' McCabe play corner kick for Ireland but e land ontop di goal post.

74' Super Falcons don get opportunities in di last two minutes but dem neva fit convert any chance. Ayinde play di ball wide.

71' Chance for Nigeria but Ireland defenders clear di ball, di rebound from Nigeria no enta net.

69' Katie McCabe of Ireland don collect yellow card. Rasheedat Ajibade play di freekick buy Courtney Bosnan save am.

67' Substitution Onumonu and Monday don enta as Asisat Oshoala and Uchenna Kanu comot.

65'Nigeria dey do short-short passes to try bring out di Ireland players but dem neva get space.

61' Ireland get throw-in, dem throw di ball dangerously near di Nigerian defence but Chiamaka Nnadozie save am.

57'Freekick for Ireland but e no cause any wahala for di Nigerian defence as dem clear di ball.

52'SAVE! Nigeria get corner kick wey collect Uchenna Kanu collect, she fire di ball staight to di box but Ireland goalkeeper Cortney Bosnan save am.

49' Ireland dey try to break Nigeria defence but dem neva get di chance.

47'Nigeria get corner kick and Toni Payne play am hit di side net.

46' Referee don blo w whistle, seconf half don start.

First Half

45' Ireland 0-0 Nigeria

45'No added time at all as Referee blow whistle to end first half.

43'Nigeria get dia first corner wey Toni Payne play, but Courtney Brosnan di Ireland goalkeeper punch am out.

39' Toni Payne of Nigeria fire wide shot from outside di box.

38' Republic of Ireland get dia first shot on target, striker Kyra Carusa nod di ball straight to Chiamaka Nnadozie hand.

35' Beta action neva really happun since as dem just dey pas di ball between demsefs.

31'Di Irish girls dey hold onto di ball wit short short passes.

28' So far Ireland dey lead wit ball possession wit 66.8 percent

27'Denise O'Sullivan find Heather Payne wit one nice reverse ball , she cross am near di back of di post but Sinead Farrelly shoot am wide.

23' One very dangerous Irish attack wit one beta run and thru ball from Denise O' Sullivan just pass front of dem, Ireland no fit control am enta di box.

22 'Nigeria goalkeeper Chiamaka Nnadozie drop Meghan Connolly freekick but she catch am before any Irish player reach di ball.

9'Republic of Ireland get dia first corner kick but dem play am but di Nigerian Golakeeper Chiamaka Nnadozie save am.

7'katie McCabe of Ireland almost get her second goal of di World Cup as dem pass di ball give her for di edge of di box. She fire di ball but e go wide of di bottom corner.

4' Di irish team rush Nigeria for di early stages of di match but notin come out from di early rush.

1' Referee don blow whistle and match don start

Nigeria Super Falcons go try maintain dia lead for di ongoing Fifa Women World Cup.

Di 11 time African Champions dey play dia last group match against di Republic of Ireland on Monday.

Super Falcons of Nigeria go play di match with plenti ginger, sake of say dem dey top Group B with four points while dia opponent Ireland dey bottom of di group with zero point.

Nigeria and Canada both dey go into dia final games only needing one point to go through, and Australia di chasing di win. A draw go dey enough for di Matildas if di Republic of Ireland, wey don already dey eliminated, beat Nigeria by two goals.

Di Irish only get pride to play for - and a first Women World Cup win - after dem lose both matches narrowly so far for battling performances against higher-ranked sides.

Line-ups

Nigera XI: Nnadozie, Plumptre, Ohale, Payne, Oshoala, Ucheibe, Kanu, Demehin,Ajibade, Ayinde, Alozie.

Subs: Oluehi, Balogun, Ogbonna, Ebi, Onumonu, Oparanozie, Monday, Ordega, Echegini, Imuran, Okoronkwo.

Republic of Ireland XI: Brosnan, Payne, Fahey, Louise Quinn, Connolly, McCabe (c), Littlejohn, O'Sullivan, Agg, Farrelly, Carusa.

Subs: Moloney, Walsh, O'Riordan, Mustaki, Caldwell, Barrett, O'Gorman, Lucy Quinn, Larkin, Sheva, Grant, Atkinson.