Teams wey qualify for Afcon quarter-final, fixtures and oda tins to know

Some kontris wey finish top of dia group bin crashout

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigeria and Ivory Coast don enta quarter-final

Di round of 16 games for di African Cup of Nations, Afcon 2023 don end and teams don qualify for di quarter-final afta winning dia games.

Di round of 16 get plenti surprises pass di group games. Different teams shock dia fans wit di results of di matches afta dem battle am out for 90mins.

Some kontris wey finish top of dia group bin crash for di knockout stage while kontri wey qualify as best loser make am to di next stage.

Some kontris bin get luck to qualify to di round of 16 sake of di new structure wey di Confederatio of African Football, Caf, bin introduce for di tournament.

Kontris like host, Cote d'Ivoire, Guinea, Mauritania, and Namibia wey carry third for dia groups eventually qualify as best losers.

Surprisingly, Cote d'Ivoire and Guinea wey qualify as best losers enta round of 16 beat dia opponent to progress to quarter-final.

Di round of 16 get plenti surprises

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ivory Coast shock defending champion Senegal

Teams wey don qualify for quarter-final

  • Nigeria- Di Super Eagles bin catch Cameroon and wipe dem 2-0 to make am into di quarter-final.
  • Cape Verde- Na from group stage dis team don dey hot as dem dey beat all dia opponents and e no too dey surprising say dem beat Mauritania 1-0 to enta di quarter-final.
  • Guinea- Dis team na one of di biggest shock for dis ongoing Afcon 2023 as dem qualify as best loser from dia group stage but dramatically beat di same Equatorial Guinea wey flog dem 4-2 for group stage.
  • Angola- Wetin dis team dey play be like say dem really mean to enta final of di torunament as dem no give dia opponent any chance as dem beat Namibia 3-0 to scale through.
  • DR Congo- How dis team take beat a seven-time winner of di Afcon Egypt, still dey surprising but dem struggle wit dia last ability to win wit penalty enta quarter-final.
  • Ivory Coast- Host kontri wey almost comot for di competition if no be for di best loser rule and dem surprise di reigning champion Senegal wit penalty wey make dem progress go di next stage.
  • Mali- Di team no wan give up for dis torunament as dem also surpsise audience wit dia incredible win ova Burkina Faso wey dem beat 2-1.
  • South Africa- Di Bafana Bafana really shock plenti fans wen dey defeat di tournament favourite Morocco.

Road to Afcon final

Picture show how teams go play dia way to di final

Wia dis foto come from, CAF

Wetin we call dis foto, Nigeria go face Angola for di quarter-final

Dis year Afcon come wit surprising and shocking moments wey dey make fans get mixture of joy for di winning teams and tears for di losing teams.

Nigeria go face Angola for di quarter-final of di Afcon while Cape Verde go face South Africa.

Dis mean dat any team wey win for di first outing between Nigeria and Angola, go face winner of di game between Cape Verde and South Africa for semi-final.

If Nigeria win, dia opponent go be either Cape Verde or South Africa - and di winner of dat semi-final go enta final.

Mali go face Ivory Coast while DR Congo go face Guinea. If Ivory Coast fit beat Mali, dem go meet di winner between DR Congo and Guinea for semi-final.

Some of di top team wey fans dey expect to reach final afta di big teams don crash out na Nigeria, Cape Verde, Ivory Coast and South Africa- but dis ongoing Afcon no too dey predictable and anything fit happun.

Afcon quarter-finals fixtures

  • Nigeria - Angola

02/02/2024, 17:00

(Felix Houphouet-Boigny)

  • DR Congo - Guinea

02/02/2024, 20:00

(Stade Olympique Alassane Ouattara)

  • Mali - Cote

03/02/2024, 17:00

(Stade de Bouaké)

  • Cape Verde - South Africa

03/02/2024, 20:00

(Stade Charles Konan Banny de Yamoussoukro)

Morocco dey highly ranked but dem crash out for Afcon2023

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Morocco crash out

Big teams wey dem comot for Afcon

Senegal

Senegal wey be defending champion no make am to di quarter-final afta dem lose to host kontri Ivory Coast. For di game, na Senegal first score but dem hold down dia goal as dia opponent equalise.

Di two teams bin need extra-time to find di winner but dem cancel diasef as na penalty later decide di take.

Niakhate na im be di only player wey miss im kick as im shot hit di post. Kessie wey bin don score from di spot during regulation also convert di decisive kick to send di hosts and dia fans into wild celebration.

Morocco

Morocco fit no expect wey happun to dem becos how South Africa go beat Africa most ranked team 2-0.

South Africa bin produce one of di shock of di 2023 Africa cup of Nations as dem defeat tournament favourites Morocco to seal qualification to di quarter-finals.

Wen South Africa dey lead, Morocco bin get chance to equalise on 85 minutes from di penalty spot afta di ref and VAR judge say Mvala use im hand stop El Kaabi goal bound shot.

Sadly, Hakimi wey hope dey im hand blast im kick onto di crossbar. Amrabat of Morocco chop straight red card for di foul wey im do for Mokoena, just five minutes make match end.

Same Mokoena double South Africa lead wit a wonderful strike wey fly past Bono into di net, naso Bafana Bafana put tears for eyes of Morocco fans.

Egypt

Dis team don win di Afcon reach seven times, but dis time around, dem no even reach quarter-final. Di shocker wey dey be say na DR Congo comot dem for di tournament.

Dem play 1-1 draw full-time and wen e reach penalty shootout, na dia DR Congo knockout Egypt. Di Pharaoh wey dey always dazzle for di tournament, naso we no see dem again.

Afcon 2023 round of 16 results

Angola 3-0 Namibia

Nigeria 2-0 Cameroon

Equatorial Guinea 0-1 Guinea

Egypt 1-1 DR Congo (penalty)

Cape Verde 1-0 Mauritania

Senegal 1-1 Ivory Coast (penalty)

Mali 2-1 Burkina Faso

Morocco 0 - 2 South Africa