Seahawks sama Patriots to win Super Bowl

Seattle Seahawks

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Seattle Seahawks bin win dia first Super Bowl for 2014
    • Author, Ben Collins
    • Role, BBC Sport journalist at Levi's Stadium
  • Read am in 5 mins

Di Seattle Seahawks show dia defensive power to beat di New England Patriots to win dia second Super Bowl title.

Two of di NFL obgonge teams wit strong defence face each oda for di Sunday event; wey di Seahawks win 29013 for di Levi's stadium.

Na proper defensive performance; Briton Aden Durde take centre stage to become di first overseas coach to win di United States' biggest game.

46-year-old Seattle defensive co-ordinator help create di defence wey everibody dey fear for NFL, na so dem show am for di biggest stage for Santa Clara, California.

New England dia second-year quarterback Drake Maye miss out for dis season MVP award but di Seahawks don scata di move wey dem win six sacks, dem force three turnovers wey dem score defensive touchdown.

Maye first turnover result for di opening touchdown for di tight end AJ Barner for di fourth quarter afta Seattle bin dey lead 9-0 for halftime.

Linebacker Uchenna Nwosu now return one interception for 45-yard touchdown, at a time Jason Meyers bin kick record five field goals; Seattle bin deny di patriots dia recoed seventh Super Bowl title.

"Na we be di beta team; we be di best. We dey love each oda, now we be champions," Seahawks head coach Mike Macdonald tok NBC.

"We bin dey di dark side dis night. We love our players - na dem dey make tins happun."

How Seahawks stop MVP contender Maye

Be like most of di 70,823 crowd bin dey support Seattle, wey enta di game as favourites; and dia win also mean say quarterback Sam Darnold finish his redemption story afta pipo throway di idea as starting NFL quarterback.

Di Seahawks be Darnold im fifth team for his eight-year career - di third in three years - but for his first year for Seattle, di former third overall draft pick bin win di game's biggest prize.

For 2019 di 28-year-old tok sometin wey dey chase am till now.

He tok say "i dey see ghosts" when im dey struggle against di Patriots, but Darnold don now clear all those demons.

Instead, na Maye wey bin suffer nightmare when physical defence wey Durde and coach Macdonald dey lead, attack dem.

Na so be di breadth and depth of di threat wey Devon Witherspoon collect sack from cornerback.

Im, Derick Hall and Rylie Mills only score 2.5 sacks between them for di whole season but all di three of dem bin reach Maye for di first half.

Di Patriots get only four first downs bifor halftime and 52 yards for di total.

Some trolls on top social media even joke say Bad Bunny get more yards as im carry di ball during im first half-time show.

Hall im second sack bin force mistake wey Byron Murphy don recover, wey im also sack Maye twice as di Dark side create history for Seattle legacy togeda wit di "Legion of Boom", di defence wey make di Hawks win dia previous Super Bowl title win for 2014.

"My team-mates and coaches dey believe in me well well," Darnold tok NBC.

"Since di first training camp, everi single day we bin come to work. Shout out to our offensive line for everitin dem do for di game. But i also gatz to give shoutouts to our defence.

"We do am. Dis be special journey wit dis pipo.

Kenneth Walker

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kenneth Walker become di first running back wey dem name am Super Bowl MVP since Terrel Davis for 1998 afta im 135-yard performance

Patriots and Vrabel denied historic win

New England bin dey play dia first Super Bowl since 2019 when legendary quarterback Tom Brady and head coach Bill Belichick comot di team.

Di two, lead di Patriots to six Super Bowl wins, to equal di NFL record wit Pittsburgh Steelers, Mike Vrabel play in three of those wins.

Afta two 4-13 seasons, di former linebacker return to New England as head coach wey he bin build roster.

Vrabel bin dey hope to become di first man to win a Super Bowl as player and coach, wit di same franchise, even as Maye dey aim to be di youngest quarterback to win di big game.

As he get di league best pass completion rate, Maye don impress well well wit im ability to scramble and escape di pressure.

Dem neva fit get away from di Seahawks even though New England no fit get dia run game on point.

Maye bin give hope to di Patriots as he find Mack Hollins for di touchdown to reduce di score to 19-7, but dem hustle wey dem take di ball for di next two possessions; e mean say Rhamondre Stevenson im late score be conslation.