African countries in 2026 Winter Olympics and wetin dem go do

Wia dis foto come from, Tom Weller/VOIGT/DeFodi Images via Getty Images
Nigeria dey part of eight African countries wey go participate for dis year Winter Olympics wey start for Italy on Friday.
Di oda countries include Benin, South Africa, Kenya, Guinea-Bissau, Eritrea, Madagascar and Morocco. In total na 15 athletes pack go dis year Olympics.
For di last Olympics wey be di Beijng 2022, na only six athletes waka come from five countries.
Dis go be di second time for di history of di competition wey Africa go dey represented by eight countries.
Dis year event na di 25th Winter Olympics and go feature 116 medal events and three go be in di newly added sport of ski mountaineering.
Oda African countries record breaking moments go hapun for dis list. But make we torchlight di countries wey dey participate.

Wia dis foto come from, Maja Hitij/Getty Images
Nigeria
Nigeria dey participate for one sport for dis Olympics wey dem come wit only one athlete too.
Samuel Ikpefan na di only pesin wey go fly Nigeria flag for di Milano Cortina Olympics 2026.
E go participate for di cross-country skiing event. For wia e go do two competitions wey be di Men Sprint Classic wey dey hapun for 8 February and di Men 10km Interval Start Free and dat one dey start for 13 February.
Oga Ikpefan wey be 33 years old wey dey born and brought up for French Alps na im bin also keep di Nigeria flag flying for di Beijing Winter Olympics for 2022. For dat Olympics, e bin carry 73rd position overall for di men sprint free.
Cross-Country Skiing na di oldest form of skiing and how dem dey take win am be say, na like racing wia di first to finish na dem dey win. Dem get two ways dem dey take ski wey be Classic, wia di race dey hppun for pre-created ski tracks and na just to ride am di athletes need to do. Di oda wey be free sprint no get tracks. Dia be also different ways dem dey take start. Weda na all at once or Interval start wia di goal na to get di best time.
South Africa
South Africa dey present five athletes for dis Winter Games wey go make am di kontri biggest team for di Winter Olympics
Di team get two teenagers 17-year-old Thomas Weir and 18-year-old Lara Markthaler wey go participate for di Alpine skiing.
Na skiing race down di mountain to test who go fit ski di best in di fastest amount of time. Di events dey mostly divided into technical and speed and some events dey combine di two.
21-year-old Malica Malherbe go do freestyle skiing and 35-year-old Matthew Smith na im dey run dia cross-country ski.
Freestyle Skiing na all about di technicality on ski, na like if gymnastics get im own ski competition. E involve a lot of acrobatics for am. Di way dem dey judge am na di jumps for slopes weda di take off dey good and landing dey kajad.
For di finale, di chosen go do two jumps of dia slope to determine who go carry medal.
Finally, 31-year-old Nicole Burger dey fly di South African flag for di Skeleton competition.
Skeleton na competition wey di athletes go lie down face down for dia sledge as dem dey race down. Di race dey start wit 30 seconds race to build momentum bifor dem come lie down on top dia sledge to continue di competition. Once di athlete don lie down tight dia hands for dia sides, na dia shoulders, knees and toes dem dey take control di sledge. To win, you gatz get di fastest combined time in four runs on di tracks.
Kenya

Wia dis foto come from, Getty Images
Kenya dey field two athletes for di Winter Olympics and dem two dey participate for Alpine Skiing.
Di athletes na 18-year-old Issa Laborde wey dem born and train for France but wey dey represent im mama country Kenya
Im competition dey hold on 14 February.
Di second Alpine skiing athlete na Sabrina Simander wey qualify for di Winter Olympics bifor she announce her retirement but e still dey up in di air weda she dey race.
If she race, she dey do di Women giant slalom and Women slalom for 15 & 18 February.
Benin
Dis na di first time wey Benin dey qualify for di WInter Olympics and dem dey do am wit one athlete.
E be 21-year-old Nathan Tchibozo wey dem born for France. Na Alpine Skiing carry am come. E go be di first athlete for im kontri wey go compete for di Winter Olympics.
Im event go run for 14 and 16 February for both di Men's Giant slalom and Men's Slalom events.
Morocco
Morocco get two athletes wey dey participate for dis year games.
Pietro Tranchina go compete for di slalom and giant slalom events for alpine skiing for di Milano Cortina. Im events dey hold for 14 and 16 February.
While, Abderrahim Kemmissa go compete for di 10km freestyle event for cross-country skiing for di 13 of February.
Madagascar

Wia dis foto come from, Klaus Pressberger/SEPA.Media /Getty Images
Madagascar send two athletes to lift dia flag for di 2026 Winter Olympics.
Dem go make history wit Mialitiana Cierc wey be di first African woman wey go compete for inside three Winter Olympics - di first time she participate na wen she bin dey 16 years for PyeongChang for 2018. Her event na Alpne skiing and e dey hapun for 15 and 18 February.
Madagascar also get Mathieu Neumuller aka Mathieu Gravier wey dey participate for im second games and dey also do Alpine Skiing. Im competition dey hapun for 14 February.
Guinea-Bissau
Dis go be Guinea Bissau first entry into di Winter Olympics as a country but no be dia athlete frist time.
19-year-old WInston Tang na Aphine skier. In fact, oga Tang wey dem born for Utah for di US na Taiwanese-American-Guinean-Bissau.
Guinea-Bussau na di third country e dey fly dia flag for di competition.
Eritrea
29-year-old Shannon-Ogbnai Abeda na im dey fly Eritrea flag for Alphine Skiing.
Dis be im third competition for di country and fit be im last. Di last time e compete for di Beijing 2022, enfinish for 39th position.
Im events dey hold on 14 and 6 February.









