President Mahama recall Ghana High Commissioner to Nigeria afta vote buying allegations for NDC parliamentary primaries

Wia dis foto come from, BABA JAMAL/FACEBOOK
Ghana President John Mahama order say make dem recall di kontri high commissioner to Nigeria sake of allegations of vote-buying and inducement during one parliamentary primary on Saturday 7 February 2025.
Baba Jamal abandon im post for Abuja to return to Ghana to contest for di govment party primaries for di Ayawaso East constituency afta di sitting member of parliament die in January.
Analysts tok say if he tink say he no like di post as high commissioner anymore, he for resign and focus on di parliamentary agenda.
But oga Baba Jamal tok say he decide to contest di parliamentary primaries sake of he wan serve his pipo well well.
Na so he return to Ghana to campaign and contest di primaries wit four odas, wey include wife of di sitting wey die; Amina Adams.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
'He allegedly dash TV, motorbikes and eggs for voting day'
For voting day, authorities say di camp of Baba Jamal allegedly dash di National democratic congress (NDC) voters many tins so dem fit vote for am.
Reports say ome of di delegates collect 32-inch TV set, odas get motorbikes.
Some also get cash; wey im campaign team also give odas boiled eggs and pepper just bifor di voting.
Some viral videos from di constituency show residents and voters wey collect dia TV sets wey dem dey go dia house.
Odas also get motorbikes.
Wen dem ask am why he dash gifts and cash bifor di elections, Baba Jamal say "e bi gift I give dem."
"Pipo wey sabi me know say I dey dash tins well well, every occasion, every Christmas and oda times, I dey dash pipo tins, so e no be new tin," he tok journalists.
He ask say "wetin be wrong if you dash pipo TV? Dis be di first time I dey dash pipo tins?"
"I put GHc2.5m ($229K) aside say I dey give to pipo as free loans every year; so if today pipo dey come vote wey I give dem TV, e no be vote-buying."
He add say, "if somebody dash you gift, you gatz to take it, but wetin be wrong be when you allow dat gift to influence your vote."
President order investigation as he 'remove' am from his role as High Commissioner

Wia dis foto come from, GHANA PRESIDENCY
Inside one statement from di presidency, govment tok say President Mahama no take di mata easy at all.
"President Mahama order di immediate recall of Mohammed Baba Jamal Ahmed from his position as Ghana high commissioner to di federal republic of Nigeria afta allegations of voter inducement," di statement wey govment tok-tok pesin Felix Kwakye Ofosu sign, tok.
Dem add say "di president give order to di foreign affairs minister say make he take di necessary administrative and diplomatic steps to ensure di removal."
"Even though dem make allegations of vote-buying against multiple candidates for di primaries, Baba Jamal be di only serving public officer among dem."
Di govment NDC party earlier condemn di vote-buying from di aspirants wey dem tok say dem begin investigations.
General secretary of di party Fiifi Kwetey tok inside dia party statement say, "di party dey aware say vote-buying hapun well well for di primaries for Ayawaso East constituency. We condemn dis tins."
"Di party dey investigate di mata wey we go take quick action against any candidate wey dey guilty."
Fiifi Kwetey add for di statement say, "we dey warn everibody say for di future, if dis tins hapun, we go punish di pipo well well, we fit even cancel di elections sef."
Baba Jamal win di primaries wit 431 votes, wey Amina Adams di pesin wey chop second, get 399 votes.
President Mahama say even though his party di NDC already begin dey investigate, e dey necessary say he for take action sake of dis be public official wey dey involved.
"Di president gatz to take serious action to preserve di integrity of public office and to avoid any perception of impropriety or conflict wit di govment code of conduct for political appointees."
E neva clear how long dis investigation go take, but many pipo say di president need to crack di whip.







