Nigeria sama Algeria 2-0 to set up semi-final clash wit Morocco

Nigeria go jam Algeria for Marrakech, Morocco

Wia dis foto come from, NurPhoto via Getty Images

Read am in 4 mins

Nigeria Super Eagles beat Algeria 2-0 to qualify for di semi-finals of di ongoing Africa Cup of Nations.

Nigeria dominate di match from start to finish, but Algeria no still make di game easy for di Super Eagles.

First half end for goalless draw afta Nigeria and Algeria try dia luck but goal no come.

Victor Osimhen score Nigeria first goal immediately second half start for di 47th minute.

Adams Akor score ten minutes later wit Victor Osimhen assist for di 57th minute.

Nigeria get beta chances to strike but dem dey play di ball ova di bar.

Di match hot sotey Algeria collect five yellow cards while Nigeria collect three yellow cards.

Nigeria go jam host kontri Morocco for di semi-finals.

Di deadly combo of Ademola Lookman and Victor Osimhen versus reliable goalkeeper Luca Zidane go surely sweet to watch.

For di Desert Warriors, dis na chance to complete redemption afta two shameful group-stage exits bifor now. For di Super Eagles, na test of maturity, control and focus, especially afta tournament wey don loud both on and off di pitch.

Nigeria don win Afcon three times – 1980, 1994 and 2013. Algeria don win am two times – 1990 and 2019.

How Nigeria take reach quarter-finals?

Nigeria go jam Algeria for Marrakech

Wia dis foto come from, NurPhoto/Getty Images

Nigeria enta knockout stage with 100% record too, afta dem beat Tanzania, Tunisia and Uganda for Group C.

For knockout, dem start wit heavy 4-0 beating of Mozambique.

How Algeria take reach Afcon 2025 quarter-finals?

Nigeria go jam Algeria for Marrakech

Wia dis foto come from, DeFodi Images/ Getty images

Algeria qualify wit three wins from three matches – against Sudan, Burkina Faso and Equatorial Guinea.

For round of 16, dem beat DR Congo 1-0 for extra time, thanks to fine goal from substitute Adil Boulbina.

Algeria dey calm and organised under coach Vladimir Petkovic. Dem win all group matches, allow only one goal, and survive strong pressure from DR Congo for last 16 bifor Adil Boulbina beautiful 119th-minute goal carry dem go next round.

For four matches, dem don concede just one goal – thanks to good organisation, patience and outstanding keeper Luca Zidane.

Tactically, dis na classic style clash: Algeria compact 4-3-3 versus Nigeria aggressive 4-4-2 diamond. Algeria go want control, tempo and discipline. Nigeria go dey look for space, counter-attack and confusion.

Head-to-head

Algeria and Nigeria don meet 22 times bifor, both competitive and friendly matches.

Algeria get small advantage – 10 wins, Nigeria get nine wins, while three matches end for draw.

Algeria don be Afcon bad luck team for Nigeria, as dem don win four and draw two of nine Afcon meetings, including di painful 5-1 beating for 1990 tournament wey Algeria host.

Also, di Fennec Foxes don win di last three meetings, including di memorable 2–1 win for 2019 Afcon semi-final, wey Riyad Mahrez score late free-kick bifor dem win di title.

Nigeria never beat Algeria for competitive match since 2004 and dem neva win any of di last four meetings.

Lineups

Nigeria: Starting 11: Nwabali , Osayi, Ndidi, Ajayi, Lookman, Osimhen, Bruno, Iwobi, Calvin, Akor, Osimhen

Algeria: Starting 11: Zidane, Belghali, Mandi, Bensebaini, Nouri, Mahrez, Zerrouki, Boudaoui, Chaibi, Maza, Amoura