Five key tins wey don happun since di Uromi killing

Wia dis foto come from, Edo state government/Facebook
Kano State Governor, Abba Kabir Yusuf, don call for a public parade of di suspects arrested in connection wit di killing of 16 Kano indigenes for Udene, Uromi Local Government Area of Edo State.
Di governor also tok about di need for full compensation to di families of di victims as part of justice for di act.
Governor Yusuf make dis demand on Monday wen e receive Edo State Governor, Monday Okpebholo, wey lead a delegation to Kano to offer condolences over di tragic incident.
According to one statement wey di Governor spokesperson, Sanusi Bature Dawakin Tofa issue, Governor Yusuf insist say di fast arrest of di perpetrators must be followed by a transparent process, including a public parade to assure Nigerians say justice dey served.
Meanwhile, Edo state Governor Monday Okpebholo say dem don transfer di 14 suspects wey police arrest in connection wit di killings for di state go Abuja, di kontri capital for further interrogations.
Governor Okpebholo wey give dis informate wen e pay condolence visit to di Kano state govnor Abba Yusuf and wit di families of di travellers on Monday, 31 March say more arrest go follow as investigation kontinu.
E also pay condolence visit to di deputy president of di senate Barau Jibrin, and e give assurance say di pipo wey commit di crime go face di full wrath of di law.
Last week, tori bin go viral of how one local vigilante group bin carry out violent mob action against one group of travellers dem allege say be kidnappers wey dey travel along Uromi-Obajana road for Edo state.
Di Nigeria Police say di group bin dey travel inside one truck wen di vigilantes bin stop and search di truck. Dem see di travellers wey claim to be hunters in possession of 19 locally fabricated firearms.
Di police say di vigilantes bin no dey satisfied wit di excuse say hunters go dey in possession of such number of arms, and conclude say dem be kidnappers, and dat result to di gruesome killings.
Series of events don happun since den, wey include arrest and suspension. Dis na some of di key tins wey don happun.
Tinubu condemn attack and call for full investigation
Nigeria President Bola Tinubu bin give marching orders to security agencies to fish out dos wey dey behind di killing of di travellers for Edo State.
Di President describe di act as very wicked for statement.
"Di President, wey express shock for di dastardly act on Thursday, direct Police and oda security agencies to carry out swift and thorough investigations and punish di suspected culprits".
E add say jungle justice no get place for Nigeria, and all Nigerians get di freedom to move freely for any part of di kontri.
Edo govnor suspend Security Chief, vigilante
Di govnor order di immediate suspension of all illegal vigilante groups wey dey operate for di state.
Di govnor also suspend di Commander of di Edo State Security Corps, Friday Ibadin.
According to one statement wey di Secretary to di Edo State goment, Umar Ikhilor sign, e say di suspension na sake of di Uromi incident.
"Di local vigilante group wey get hand for di gruesome killing of 27th March bin dey operate illegally as dem no dey registered wit Edo State Security Corps.
"Dia actions no show di core values, character and principles of di Okpebholo administration, or di objectives of di corps as dem write am put for di Edo State Security Corps Governance Law."
Arrest of 14 suspects
As di mata dey hot, di Inspector-General of Police, Kayode Adeolu Egbetokun, say dem immediately deploy operatives for di Edo State Police Command go di affected community to restore law and order.
E say dem don arrest 14, and don launch manhunt to arrest oda perpetrators wey dey involved for di mob action.
Oga Egbetokun don also order di Deputy Inspector-General of Police in charge of di Force Criminal Investigation Department (FCID), DIG Sadiq Abubakar, to take ova di case and ensure a thorough, impartial, and expedited investigation.
Okpebholo visit Kano govnor and families of victims
On Monday, 31 March, di govnor bin pay condolence visits to di families of di victims for Kano state and to di state govnor Abba.
Govnor Okpebholo assure di bereaved families and di pipo of Kano State say justice go dey served.
For im tok during di visit, e describe di attack as unfortunate and repeat im commitment to ensuring say di perpetrators dey brought to justice.
E say di first thing wey im do na to remove di corpses and arrange dem for proper burial.
"I bin dey deeply touched wen I receive di news of di incident at night. By 4 a.m., I leave Abuja and rush go Uromi to meet wit di affected families. During my campaign, your pipo bin support me, and I stand wit you for dis time of grief. I extend my condolences to di pipo of Kano State and pray for di eternal rest of di victims' souls." E tell govnor Abba Yusuf.
Di Edo state govnor also promise to support di affected families, and govnor Abba Yusuf, confam say e don fulfil di promise.
Who be di pipo wey local vigilantes knack for Uromi
Authorities neva give full details on who di travellers wey die for Uromi be.
Earlier reports bin label dem as hunters, but subsequent reports from di police and di Edo state goment only identify dem as travellers.
Di Kano state goment tok say di victims come from two local goments for di state. Edo state govnor say some of dem na from Bankure local goment area.
Di kwesion on who dem really be still hang for air, dis na as cases of banditry, kidnapping and general insecurity still dey high for Nigeria.










