Family of pastor wey im church member husband allegedly stab to death tok how e happun

Wia dis foto come from, Ezekiel Adetoyese/Facebook
Police for Osun State don detain one couple afta di husband allegedly stab one clergy man to death on Wednesday 1 January.
Di tok-tok pesin for di Osun State Police Command Yemisi Opalola confam di incident to BBC News Pidgin.
Di 52-year-old clergyman, Bishop Shina Olaribigbe na di leader of Rapture Empowerment International Inc., Osogbo.
Tori be say di couple don dey get misunderstanding and dis make Olaribigbe chook mouth.
Bishop Olaribigbe bin don dey involved to ensure say peace reign between di couple bifor.
Tori be say for di early hours of Thursday, di suspect allegedly stab di clergyman to death wen e meet am for im wife house.
"Dem tell us say di pastor bin dey di wife place today (Thursday) wen di husband get dia. Dem also tell us say di husband stab di pastor. Dem also tell us say di deceased bin dey on di wife bed wen di incident happun.
"Di husband stab am several times and e die. Tori be say di husband act on di suspicion say di pastor bin dey sleep wit di woman," Opalola tok.
"Police officers from di Dugbe Division respond promptly to di scene, arrest di suspect, and recova di exhibit."
Opalola say di corpse don dey deposited for di Uniosun Teaching Hospital Mortuary for autopsy.
Di police tok-tok pesin say dem dey work to ensure say justice dey served on di mata.
Friends and acquaintances enta social media to mourn di passing of di clergyman on Thursday.
'Na di husband of di church interpreter kill Bishop'
Families of Bishop Shina Olaribigbe wey dem stab for Osun state don come out to tok how di mata happun.
According to di first son of di late Bishop, Damilare Olaribigbe, im papa dey always settle fight for members anytime dem call am and na wetin e go do dat day be dat bifor dem stab am.
Di son say e still see im papa on di 30th December 2024, and na di same woman wey her husband stab di bishop be di interpreter dat day for church.
"I bin receive a call, but I no fit pick am becos na night around 1:00am bifor my sister call me make I dey come next morning. I tink say dem arrest am, until dem tell me say dem stab am. I no fit see am, until dem tell me say e don die.
Na di same pesin wey her husband kill my papa na im dey interpret for church dat day. Di husband no dey come church."

One pastor wey also dey close to di late bishop say na wit knife and bottle dem bin stab di late bishop.
According to Pastor Olukunle Gbenga, wey follow BBC Pidgin, e say di wife of di suspect tell am say di late bishop bin go intervene and settle family matter wen di stabbing happun.
"Na one of our pastor bin call me say dem don kpai bishop say pesin stab am, but dem no tell me who. Later, I call di wife of di suspect, and she later tell me say she dey wit police for inside cell wit im husband.
She say her husband don kill daddy, say na she call daddy make e come intervene for dia family matter sake of say na new year dem dey enta. Na so di husband stab bishop wit bottles and knife."
Pastor Gbenga say di wife tell am say na di husband go report for di police station by imsef say e don kill pesin.
E add say di matter happun on first day of 2025 and blood full everiwia for di house, according to wetin di wife of di suspect tell am.
"Di Bishop bin beg say im come help dem settle issues but e no hear till blood full evriwia on di 1st of January 2025. Di husband come go report for di police station say im don kill pesin," Pastor Gbenga tell BBC.
Who be Bishop Shina Olaribigbe?
Bishop Shina Olaribigbe na di founder of Rapture Empowerment Int'l Inc. wey dey Osogbo, Osun State, southwest Nigeria.
Di church describe diasef as di ministry wey dey "prepare di saints for di second coming of Christ Jesus".
Videos wey Rapture Empowerment Int'l Inc. post on dia Facebook page show say na church wey still dey grow.
Not so much dey known about di bishop but im teaching show say im dey prepare im congregation for di second coming of Jesus Christ.










