Traders count dia loss as fire destroy Kantamanto market for Ghana

Firefighter trying to quench Katamanto market fire

Wia dis foto come from, Ghana National Fire Service/Facebook

Read am in 3 mins

Fire outbreak happun for Kantamanto market for Accra, Ghana, for di early hours of Thursday, and destroy ova 100 shops.

Di fire wey start around 1:00 am don cause traders ogbonge losses.

One video wey di Ghana National Fire Service (GNFS) share on dia Facebook page show how dem dey quench di fire.

Dem quickly call di Electricity Company of Ghana (ECG) to cut power supply to di area, to ensure di safety of di operation.

Fire tenders from Circle, Trade Fair, and Dansoman arrive di scene of di fire.

GNFS say dem deploy 13 fire tenders from across di Greater Accra Region to combat di fire.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Di GNFS neva confam di cause of di fire, but investigations dey expected to commence once di area dey secure.

According to local media, no be di first time di Kantamanto market dey catch fire.

Many traders wey dey affected don ask for goment assistance to help dem get back on dia feet.

Pipo still dey waka round di market to see wetin dem fit pick from di remains of wetin burn.

Dennis wey be sales boy for di area tok say wetin e want na say make dem no use wood to build di market like dis but make dem use wetin dey durable to fire so dat if dis kain burning happun again, e no go burn di market finish.

E tok say, "as di market don burn like dis, I don enta ground zero bicos no be like say normally market dey go very well and work no dey."

Di fire service PRO, Divisional officer (DO) II Desmond Ackah reveal say no casualty bin dey recorded.

As at now, e say di fire dey under control.

More fotos from di fire

Di market afta dem put out di fire
Picture show di pockets of fire wey still dey around di market
Wetin we call dis foto, Di fire DPO say di work now na to quench di pocket of fire around di market
Pipo wey dey try save something from di fire
Wetin we call dis foto, Fireservice DPO say na di solvents for di container and di cloth for di market na im fit cause di wild spread of di fire
Pipo dey gada wetin dem fit from di market