Five reasons why Kamala Harris lose to Donald Trump

Read am in 7 mins

Donald Trump don win di US presidential election to secure a historic return to di White House by defeating Vice President Kamala Harris.

E no be like wetin many pipo expect like di vote count for 2020.

Trump maintain a lead from di start wit di majority of Americans for key battleground states wey vote am.

Harris wey get di Democratic nomination wen incumbent President Biden drop out of di race for July, na di second female candidate to lose to Trump afta Hillary Clinton defeat for 2016.

Hia, we dey look five reasons why Harris lose to Trump.

Economy

Despite low unemployment and confam stock market, most Americans say dem dey feel di rising prices and di economy na major concern for voters.

Inflation wey go up to levels wey dem neva see since di 1970s, di aftermath of di pandemic don give Trump mouth to tok kwesion of: "You dey better off now dan wetin you be four years ago?"

For 2024, voters around di world don throway di party wey dey in power sake of di high post-Covid living costs. US voters also dey hungry for change too.

Only one in four Americans dey satisfied wit di direction of di kontri, and two-thirds hold bad belle view of di economy.

"Inflation wey dey caused in some part by Biden huge spending programmes remain a serious issue, and voters tok about how Biden agenda dey make serious negative numbers wey make Harris dey difficult to go all di way," Foreign Policy columnist, Michael Hirsh tok.

Just ova half of voters say dem favour Trump ova Harris wen e come to how to handle di economy and na 31% of voters say dat na dia top issue, according to CNN exit polls.

Biden Unpopularity

Harris position herself as di candidate of change, but as Joe Biden vice president, she don struggle to separate hersef from her oga wey im approval ratings don dey around 40% for im presidency.

Despite dis, she don remain loyal to am, even as Americans don show say dem no like how e dey handle inflation and di US-Mexico border crisis.

One example of dis, according to political analysts, occur wen Harris appear on ABC programme 'The View' last month.

Many see am as a chance for her to introduce hersef to Americans wey dey unfamiliar wit her background.

Instead, di Democratic nominee struggle to explain how she go dey different from President Biden, but she say, "no be sometin wey dey come to mind."

David Axelrod, a former adviser to Barack Obama, call di exchange "diisastrous" for Harris.

E also get "crisis image” for di Democratic Party, sources don tell di BBC.

A Democratic political operative for Washington DC bin tell di BBC Ione Wells say di party "need to flush out over sabi pipo for DC for a start."

Odas wey dey praise di campaign efforts feel say di party get "image problem," especially as issues like di cost of living dey heavy for voters minds.

"Dis Democratic lose of hope dey remind me of one conversation I get wit a Republican for Trump rally," Well tok.

"E claim say dia candidate don completely ‘reimagine’ di Republican Party, moving away from kontri-club image to appeal to working-class families, while di Democrats don become di 'party of Hollywood'."

Social Issues

Beyond di economy, elections dey often shaped by emotionally-charged issues.

Democrats dey count on abortion to get voters, while Trump dey bet ontop immigration.

Record-high border encounter during Biden administration and di impact of immigration for states wey dey far from di border don lead voters to trust Trump more on dis issue, according to a poll by di Pew Research Center.

Harris, meanwhile, dey campaign seriously to restore abortion access and secure a solid 54% to 44% lead among female voters, according to Edison Research exit polls.

Howeva, dis na narrow margin pass Biden 57% to 42% lead wit women for 2020. As for Trump, 54% of im supporters na men, while 44% na women.

Ultimately, abortion no get di same powerful impact as e be for 2022, wen Democrats perform better dan expected for di midterms.

British-American historian Niall Ferguson, a senior fellow for di Hoover Institution at Stanford University, say US voters don“come togeda to reject di policies of di last four years.”

E argue say Americans turn against economic policies wey don fail and dey cause increasing inflation, a foreign policy wey lead to wars for di Middle East, and a social agenda wey dey labelled as "woke."

"For di various progressive manifestations, dis agenda leave behind not just white Americans, not just working-class Americans, but Latin Americans, Hispanics, e leave behind pipo right across di kontri," e tell BBC Radio 4 Today programme.

"Di Democratic Party don receive a clear message: Di American pipo no want dis policies. Dem want peace through strength and prosperity without inflation. Dem certainly no want ‘wokers’ for social policies."

Underperformance among Black and Latino Voters

Trump return to di White House become more certain wen e win Pennsylvania and dia 19 electoral votes—a state wey Democrats don only lose one time since 1988, wen Trump beat Hillary Clinton for 2016.

Harris campaign pour resources into Sun Belt battleground states like Arizona, Nevada, Georgia and North Carolina, wit hope say she go win ova moderate Republicans and Independents wey dey frustrated by Trump-era divisions.

Howeva, dat investment fail to pay off.

Di Democrats usual support among Black, Latino and younger voters divide and while Harris maintain some support for college-educated areas, e no dey enof to offset Trump gains for Democratic strongholds.

Edison Research exit polls suggest say Harris go win 86% of Black voters to 12%, and 53% of Latino voters to 45%.

For 2020, howeva, Biden margins dey stronger to secure 87% of Black voters and 65% of Latinos.

For a major shift, Trump make di largest gains among Latino men as e win dem 54% to 44% ova Harris, compared to Biden’s 59% to 36% win among di same group for 2020.

Harris compared to Biden victory for 2020 also underperform for heavily Republican rural counties, falling back to Clinton 2016 levels of popularity.

Excessive focus on Trump

Much like how Hillary Clinton do for 2016, Harris focus heavily on how Trump no fit for di office.

Early on, Harris position di race as a referendum on Trump. For di campaign final weeks, she conclude her tok, calling Trump a "fascist," "unhinged," and "unstable," as she cite former White House Chief of Staff, John Kelly claims about Trump alleged love for Hitler.

She frame di election as a fight for democracy, echoing Biden approach bifor e comot for di race for July.

"Kamala Harris lost dis election wen she focus almost exclusively on attacking Donald Trump," pollster Frank Luntz posted on X, formerly Twitter.

"Voters alreadi sabi Trump; dem wan know more about Harris plans for her first days and year in office."