You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Donald Trump life for pictures
Donald Trump don win di US election and go make a historic return to di White House.
Di Republican tell happy crowds for Florida say: "America don give us an unprecedented and powerful mandate".
As Trump and di Republicans dey celebrate im victory, dis na some key moments from im life.
Dem born Donald John Trump on 14 June 1946 for di New York borough of Queens.
Na im be di fourth of five children, e get two brothers - Fred Jr and Robert - and two sisters, Maryanne and Elizabeth. Elizabeth na im only sibling wey still dey alive.
Im papa Fred run a successful construction company for di outer boroughs of New York.
E join di business for di first time for 1968, but soon go start im own for di heart of Manhattan.
Casinos, condominiums, golf courses and hotels follow, from Atlantic City, Chicago and Las Vegas to India, Turkey and di Philippines.
Donald Trump flamboyant style help am stand out for New York business world and e rise to stardom for di entertainment world wit di TV show, The Apprentice.
Trump don marry three times and e get five children.
E first tie di knot for 1977 wit Ivana Zelníčková.
Trump marry im third wife Melania Knauss for 2005. Wen dem meet seven years earlier, e be 52 and she be 28.
Im political career bin start for 2015 wen e announce im White House bid during one press conference for Trump Tower surrounded by im family.
Im motto: “Make America great again”.
Afta one bitter campaign wey dey marked by controversy, e beat Democratic candidate Hillary Clinton and e dey sworn in as di 45th president of di United States for 2017.
Im presidency na uncertain time for US allies, as e often dey clash openly wit foreign leaders.
E withdraw from major climate and trade agreements and e launch one trade war wit China.
Criticism bin dominate di final year of im presidency ova di way e take handle di Covid pandemic.
Trump bin dey forced to take a break during im 2020 election campaign afta e dey diagnosed wit di virus.
Trump lost di 2020 presidential race to Joe Biden but e refuse to accept di result, as e claim say di election dey rigged.
E rally supporters for Washington on 6 January and encourage dem to march to Congress.
Di rally bin turn into riot and im actions on dat day na di focus of two criminal cases.
E be like say im political career bin dey ova, but e announce anoda run for president and quickly become di Republican Party frontrunner.
Trump begin di general election campaign as e face 91 felony charges.
For, May 2024, court find am guilty of 34 counts of fraud wey relate to hush money paid to adult-film actor Stormy Daniels ahead of di 2016 election.
Back on di campaign trail ova di summer, one 20-year-old gunman bin try to assassinate am for one rally for Butler, Pennsylvania.
Days later for di Republican National Convention, dem confam am as di party presidential candidate.
A win for Trump make am di US oldest president ever. E go be 82 by di end of im term.