Five conditions wey Hisbah say Kano 'TikTok couple' must meet before dem marry

Wia dis foto come from, Maiwushiryabackup/Tiktok
- Author, Abubakar Maccido
- Role, Reporter
- Reporting from, Kano
- Read am in 5 mins
One magistrate court for Kano, wey dey northern Nigeria, on Monday order di Kano State Hisbah Board make dem arrange wedding for two popular TikTok stars Idris Idris Mai Wushirya and Basira Yar Guda inside 60 days.
Di court give dis order afta videos of Mai Wushirya and Yar Guda go viral for social media wey Kano State Film Censorship Board call "dirty and immoral."
Di videos show how di two TikTokers dey show love and affection for public sometin wey di state Kano authorities say no follow moral value, religious teaching, and di culture of pipo for Kano State.
For interview wit BBC News Pidgin, di deputy Hisbah commander, Mujahideen Aminuddeen, confam say di court order dem make dem do di TikTokers marriage within two months.
E tok say di two social media lovers appear for court afta dem post videos wey no follow local tradition and Islamic teaching.
"We happy wit di court decision bicos e go serve as lesson to pipo wey dey post videos wey no follow our culture and Islamic values" Aminuddeen tok.
"For court, dem tok say na true love dem get for each oda. Na why we dey send our pipo go Zamfara to meet di girl parents" e add.
Aminuddeen still explain say di Kano Hisbah Commander, Aminu Daurawa, don give five conditions wey dem must fulfill bifor di marriage fit happun.
"Number one na to know wia dem come from who dem be and who be dia papa and mama.
We don send message go give di Hisbah Commander for Zamfara make e confam di girl background and bring her family pipo for di marriage arrangement."
E still tok say "we go check di mental health to know weda dem dey use drugs or get any mental wahala.
Anoda one be say dem go do medical test for tins like Hepatitis, HIV, genotype, and sexually transmitted diseases."
Aminuddeen say "After all dat, we go tok about bride price (dowry). Some pipo don already volunteer say dem go pay am."
E come add say Basira Yar Guda, di bride-to-be, don make am clear say she no go live for rented house afta marriage.
"She tok say she no go stay for person house unless di man she go marry get im own house" e tok.
"Right now, we dey beg di govnor make e help find house wia dem fit stay afta di wedding," Aminuddeen add.
According to am, Mai Wushirya and Yar Guda still dey under court custody, and na only marriage order di court give Hisbah Board.
E end di mata by saying say dis one go serve as lesson to oda social media content creators for Kano.
For anoda interview BBC News Pidgin do wit Abba El-Mustapha, di head of Kano Film Censorship Board and one of di big pipo for Kannywood wey also help secure Mai Wushirya and Yar Guda bail, confam di court order to marry AIdris Mai Wushirya and Basira Yar Guda.
"Di court give di judgment afta dem confirm say di two of dem really wan marry each oda, na dat one make dem dey do those pre-wedding kind videos," e tok.
"Dem tok say even before dem charge dem, dem don already start marriage plans and dia parents don already join for di matter" El-Mustapha add.
"I don bail dem, but Mai Wushirya phone still dey wit di Judge. E go collect im phone back afta eviritin don finish" El-Mustapha tok.
E tok say na di reason wey make di judge decide to give di marriage order.

Wia dis foto come from, Maiwushiryabackup/Tiktok
No court fit force two pipo to marry - NBA
Meanwhile, di Nigeria Bar Association (NBA) say no court get di power to compulsory two pipo to marry by force.
"E dey unconstitutional and unlawful for any court to get power to give dat kain order."
NBA President Mazi Osigwe, SAN give dis reaction afta one Magistrate court for Kano order two popular TikTok content creators, Idris Mai Wushirya and Basira Yar Guda, to formalise dia relationship through marriage within 60 days.
Di court bin give dis order afta videos of Mai Wushirya and Yar Guda go viral for social media wey Kano State Film Censorship Board call "dirty and immoral."
Oga Osigwe say dis development show grave misunderstanding of di limits of judicial authority under di Nigerian Constitution and e go against di fundamental rights of di individuals concerned.
E call for immediate review of Magistrate Halima Wali decision and ask di relevant judicial authorities to take steps to prevent a recurrence of such unconstitutional orders.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Who be Idris Mai Wushirya?
Idris Mai Wushirya na from Kano State, and na for Kano e dey live.
E do im primary school for Kano, den later go do secondary school for Katsina State.
E don turn popular for TikTok wia e dey post videos wey pipo say dey contain bad talk and immoral content videos wey dey always cause plenty tok-tok for Kano.
No be di first time authorities for Kano don accuse or arrest am before. Dem don catch am many times sake of videos wey no follow good morals.
Sometimes, Hisbah pipo and Kano Film Censorship Board go call am and other TikTokers wey dem believe no dey behave well for social media, to advise dem.
But dis time around, di TikTok video wey e post make dem carry am go court.
Meanwhile, Basira Yar Guda come from Zamfara State. She don popular for social media inside Kano, sake of say pipo for Kano dey always post her videos for dia pages.








