'Pesin tell me say make I kill my pikin becos e no get hands'

Wetin we call dis Video, 'Dem say make I kill my pikin becos e no get hands'
    • Author, Olawale Adekola
    • Role, Video Journalist
    • Reporting from, Lagos

Little Shindara dey energetic and lively as a young boy but im mama born am wit no hand.

Not discouraged wit di situation, Shindara mama identified as Mrs Funmilayo begin dey teach her son how to deal wit im situation and grow for education.

According to Mrs Funmilayo, pipo don advice her say make she try buy injection wey she fit use kill her own son but she no gree. She dey train her pikin to remain strong and not give up.

“I dey hide am bifor, one pesin tell me say one hospital dey wey I go fit buy killing injection make I give am make e die,” di mama tok.

Shindara like education
Wetin we call dis foto, Little Shindara go need artificial hand to help am

“Wen I give birth to di pikin, I hear story of pipo wey say I neva old reach and I come give birth to pikin wey no get hand," Shindara mama tok.

Little Shindara like education and im mama begin dey teach am basic tins im suppose know afta she buy am pencil and book to write.

Witout hand, little Shindara dey use im leg write and im dream to become a lawyer always dey for im mind.

“Im like education well well, im dey always tok say im wan become lawyer for di future. I buy book and pencil becos lawyer no dey lazy. I tell am say di place wey pipo wey get hand dey reach, im go pass di place.”

Little Shindara wan become lawyer for future
Wetin we call dis foto, Little Shindara no get hands since wen dem give birth to am
Funmilayo and Shindara

Mama Shindara get hope say if her pikin get artificial hand wey go help am do basic tins wen im grow well well, di situation go improve.

“If my pikin get artificial hand, di one wey dem go connect to di brain, na wetin go help am. I dey see my pikin future say e bright and I believe say im fit do am," she tok.

Little Shindara wan become lawyer
Wetin we call dis foto, Little Shindara dey learn how to write