All five Judges of presidential court unanimously uphold election of Bola Tinubu as president of Nigeria

Bola Tinubu

Wia dis foto come from, Nigerian Presidency

Di Presidential Election Petition Court don affirm di election of President Bola Tinubu of di All Progressives Congress (APC).

Di court make judgements on di election mata on 6 September afta anticipation from different quarters.

Justice Haruna Simon Tsammani wey lead di five-member presidential election petition tribunal describe oga Peter Obi petition as "just tok-tok".

“Dis petition dey hereby declared unmeritorious,” one of di judges tok, as di tribunal reject Obi challenge to Tinubu victory.

Court say di presidential candidate of di Peoples Democratic Pary (PDP) Atiku Abubakar no mention di name of places wia dem allege ballot box snatching, di way dem snatch di boxes and how dem manipulate di Bvas machines.

E no also mention di polling units wia dem manipulate results and allege say mago-mago happun.

Court aslo say di petitioner wey claim say im get majority of lawful votes, no tok in clear terms, di total lawful votes wey im claim to get.

Court hold say Atiku allege say Tinubu no score majority of lawful votes but im no make di lawful votes known for im petition.

For di case of Allied Peoples Movement (APM) against Vice President Kashim Shettima about double nomination, court tok say di opposition party lack di power to institute di petition.

LP, PDP, and APM togeda wit dia presidential candidates dem petition di court to cancel di election wey produce Bola Tinubu as president of Nigeria.

Obi and Atiku bin tok say mago-mago full di election and say Tinubu no dey qualified to contest.

Na on di 1st of March Inec bin declare Tinubu as winner of di presidential election wey take place on 25 February.

For di result wey Inec announce, Tinubu get 8,794,726 votes, Atiku wey come second get 6,984,520, while Obi get 6,101,533 and Rabiu Kwankwaso of di NNPP get 1,496,687.

Atiku Abubakar, Bola Tinubu and Peter Obi

Wia dis foto come from, ATIKU ABUBAKAR/FACEBOOK, ASIWAJU BOLA AHMED TINUBU/FACEBOOK, MR. PETER OBI/FACEBOOK

Labour Party reject tribunal judgement

Labour Party (LP) for one statement by dia national publicity secretary, Obiora Ifoh, reject di judgement of di tribunal.

Labour Party say di judgement no reflect di law and di desire of di pipo.

Di party say dem go make dia next move afta dem consult wit lawyers wen dem receive di certified true copy of di judgements.

“Nigerians witness di electoral robbery wey take place on February 25, 2023, wey dey globally condemned but di Tribunal for dia wisdom refuse to accept di obvious.

LP say wetin dey at stake na democracy and dem no go relent “until di pipo prevail”.

“We salute di doggedness of our team of lawyers wey fearlessly expose di wrath wey dey for our system. We fit only weep for democracy for Nigeria but we refuse to give up on Nigeria,” di statement tok.

'Na battle we lose, we neva lose di war'

Peoples Democratic Party (PDP) presidential candidate Atiku Abubakar don tok say im refuse to accept di judgement of di Presidential Election Petition Court wey affirm Bola Tinubu victory for di 2023 election.

During im tok-tok wit tori pipo on 7 September, Atiku say make im supporters calm down sake of say na battle dem lose yesterday, but dem neva lose di war.

Atiku say im respect di decision of di judges but im refuse to accept am, and im lawyer go take di mata to di Supreme Court.

“Wit our hopes in God and you, we go win di war in restoring confidence for our electoral system,” Atiku tok.

E also tok say im supporters no get any reason to lose hope in di PDP sake of say life dey full of ups and downs.

Tinubu welcome tribunal verdict

President Bola Tinubu tok say im welcome di judgement of di tribunal wey affirm im electoral victory.

According to one statement by di president tok-tok pesin, Ajuri Ngelale, di president say im recognise di diligence and professionalism of di five-man panel wey handle di petitions.

Tinubu say im commitment to di rule of law and how di judges take do dia job show say Nigeria legal system don mature.

"Di President believe say di Presidential Candidates and Political Parties wey don lawfully exercise dia rights by participating for di 2023 general elections and di judicial process, wey follow, don affirm Nigeria democratic credentials," di statement tok.

Highlights of wetin shele for court

  • Court dismiss LP and Obi petition on 25 per cent wey Tinubu suppose get for di Federal Capital Territory (FCT) to win di presidential election.
  • According to di court, FCT pipo no get special privileges as LP and Obi claim.
  • Court tok dey LP and dia presidential candidate Peter Obi fail to prove say dem convict Tinubu for money laundering for di United States.
  • Court also tok say LP and Obi only make claim say irregularities plenti for polling units witout giving di particular polling units.
  • Court tok say APC petition wey challenge Obi membership of di LP no dey competent sake of say na internal affair.
  • Dem also tok say 10 out of di 13 witnesses Labour Party bring no get head and dem reject dem.
  • On IReV mata, di court say e no get any law wey say Inec gatz transfer or transmit di results of di election from di polling units electronically.
  • Tribunal troway Atiku petition wey claim say Tinubu na citizen of Guinea.
  • Court strike out di suit by Allied Peoples Movement (APM) wey argue say Vice President Kashim Shettima no dey qualified to contest
  • Di issue of blurred results no hold water sake of say Labour party lie say dem bin no fit identify anytin for those polling units.