Nigeria collect wotowoto for Portugal hand

Wia dis foto come from, Getty Images
Portugal dey go Qatar 2022 Fifa World Cup wit plenty confidence afta thrashing Nigeria 4-0.
Two goals from Bruno Fernandes and one each from Ramos and Mario give di Selecia dia well-deserved victory.
Nigeria bin get chance to enta di game back for di 78th minute with a penalty kick - but Emmanuel Dennis miss am.
Di Super Eagles bin no play well for di first half. Na for di second half dem find dia groove wit di substitution of some players.
Thursday night display of di Super Ealges summarise di poor run throughout dis year.
Dem don lose five of dia matches dis year - both comeptitev and non-competitive.
Dis na di first time Portugal dey play Nigeria and dem go happy wit dia first experience.
FULL TIME Portugal 4-0 Nigeria
End of Di one wey oda users dey read well well
Second Half
90mins: Two minutes of time added on for Portuguese capital.
88mins: Dis na Nigeria almost get cause comedy of an own goal. Uzoho wey bin dey slow try stop di call from crossing di line.
84mins: GOAL! Portugal 4-0 Nigeria - Joao Mário make am four!
83mins: GOAL. Ramos score on im debut for Portugal
78mins: PENALTY for Nigeria. Emmanuel Dennis miss di penalty
78mins: Corner for Portugal. Dem lose di ball and Nigeria catch dem on counter.
76mins: Substitution for Portugal. Horta enta for Octavio
75mins: Anoda missed chance by Jao Felix. Im shot go off wide
73mins: MISSED CHANCE. Uzoho save Jao Felix shot.
72mins: MISSED CHANCE. Patricio save solo shot fromChukwueze. Di ball go corner
71mins: Etebolose di ball afta e spend too much time.
69mins: Substitution for Nigeria. Etebo enta for Joe Aribo
68mins: Fould for Nigeria. No card for di match.
66mins: Substitution for Portugal. Ramos enta for Silva. Na di first time Ramos dey play for National team
62mins: Free kick for Super Eagles. Mario bring down Simon on di edge. Simon take di free kick but Portugal goalkeeper save am.
61mins: Throwing for Nigeria. Moses Simon dey show effort from di left.
60mins: From Diogo Dalot to Vitinha, Jao Felixm Portugal attempy yo break Nigeria defence again. Troost-Ekong block di last pass.
59mins: Substitution. Onuachu enta for Murphy
57mins: Easy catch for Uzoho. Silva bin wan give through pass from di left.
55mins: Calvin Bassey det get tough time to move around as im like
53mins: Nigeria don dey impressive so far since di second half start unlike wetin dem play for di first part of di game.
51mins: Ramos and Jao Felix dey control Portugal play for midfield.
49mins: Antonio Silva block Iwobe pass to Chukwueze. Super Egles bin try move on a counter.
46mins: Super Eagles dey try find dia grooove early in di second half
45mins: Substitution for Nigeria. Onyeka enta for Ndidi
Chukwueze enta for Lookman
45mins: Substitution for Portugal. Pepe, Vitinha, João Mário and Raphael Guerreiro enta for Rúben Dias, Nuno Mendes, Bernardo Silva and Bruno Fernandes.
HALF TIME
Portugal 2-0 Nigeria
45mins: Bruno Fernandes almost score wit a lovely through ball by Joao Félix.
44mins: Nigeria pin Portugal back. This Naija team no go at all.
40mins: Simon take on im man on di left, before slipping di ball inside to Aribo.
38mins: Portugal dey in total and utter control.
35mins: Bruno score di penalty!
Portugal 2-0 Nigeria!
PENALTY! Ref blow penalty kick for Portugal afta Super Eagles defender foul inside box 18.
33mins: Ndidi bring Otávio down some 40 yards out from goal, and Portugal get opportunity to deliver dead ball into di Nigeria box.
31mins: Portugal goalkeeper Rui Patrício dey touch ball for di first time.
Portugal 1-0 Nigeria
27mins: Portugal do neat short-corner routine wey end up wit Mendes cutting di ball back to Carvalho.
Portugal 0-0 Nigeria
26mins: Iwobi pass give Aribo, e no fit take di ball do better tin.
23mins: For di first time Nigeria manage to comot for dia own half
18mins: Portugal get 70% possession. All di game dey happun inside do half of di Super Eagles.
16mins: Bernardo Silva whip low ball into Super Eagles area but e too far.
9mins: GOAL! Bruno Fernandes score for Portugal.
Portugal 1-0 Nigeria
6mins: Bright Osayi-Samuel dey also m,ake im first appearance for Super Eagles on di right back.
4mins: Portugal dey control di ball inside José Alvalade. Mendes bring di ball forward down di left, before e play am to André Silva.
2mins: Nigeria immediately win corner. Simon take am but dem no handle am well.
1min: Portugal 19-year-old centre-back António Silva dey make im debut for di Seleção
KICK OFF: Firt Half

Wia dis foto come from, Getty Images
Portugal vs Nigeria team news
Portugal: Patrício, Dalot, Dias, António Silva, Mendes, Otávio, Bruno Fernandes, Carvalho, João Félix, André Silva, Bernardo Silva.
Nigeria: Uzoho, Osayi-Samuel, Akpoguma, Troost-Ekong, Bassey, Ndidi, Lookman, Aribo, Iwobi, Simon, Moffi.










