Wetin be di controversy around di appointment of Unizik VC and why Nigeria president chook mouth

Wia dis foto come from, @Nnamdi Azikiwe University/facebook
Controversies ova di alleged "illegal" appointment of Professor Bernard Odoh as di vice-chancellor of di Nnamdi Azikiwe University don cause plenti kasala for di university campus, after allegations say dem do mago-mago for im recruitment process becos im academic profile no qualify for di position.
On Thursday, Professor Bernard Odoh through a spokesperson insist say di institution and ministry of education no get di "powers" to remove am from office since di case dey for court.
Im bin dey react afta President Bola Tinubu, step into di situation to resolve di gbas-gbos between di university senate and institution councils, as e dissolve di five council members, and remove Bernard Odoh as di vice-chancellor as well as di registrar.
Tok-tok pesin to di president, Bayo Onanuga, issue one statement on Wednesday, wey confam di sacking of di governing council and officials say di action follow reports and allegations say di council illegally appoint an unqualified vice-chancellor without following due process.
"After di controversial appointment, di Federal Government step in to address tensions between di university Senate and di governing council of di 33-year-old institution." Di statement add.
Reacting to im removal from office, Oga Odoh tok-tok pesin, Charles Otu tok say, di ministry of education don violate di university Act and insist say dem no get di "powers" to remove di former vice-chancellor from office since di case dey for court.
Oga Odoh kwension di authenticity of di press statement Oga Onanuga post for im X account.
"Already, di greatest question mark on di integrity of di said letter na di fact say e no come from di President or Office of the Secretary to the Government of the Federation wey issue di council members with appointment letters. Rather e bin dey strangely endorsed, not by a Permanent Secretary for di Ministry perhaps on behalf of di Honourable Minister but by a Public Relations Director.
Dis obviously cast strong doubts on di genuineness and intents of di letter." E tok.
"We wish to maintain say as di parties dey Court, make di issues dey tested and established by di relevant provisions of our laws."
After Oga Odoh become di institution vice-chancellor, controversies dey ova im academic profile and appointment.
Oga Odoh profile wey dey on di university website tok say im serve as visiting professor for di Federal University, Gusau (FUGUS), Zamfara State, between July 2015 and October 2017 but controversy dey about im academic profile.
According to Channels TV, Federal University Gusau for Zamfara State tell tori pipo on Thursday say Oga Odoh no work as professor for di university.
Professor Muazu Abubakar, di vice-chancellor of Federal University Gusau for Zamfara State, tok say, di institution no employ Oga Odoh and dem no appoint am as professor.
Di vice-chancellor allege say di “letters of offer of appointment as professor and confirmation of promotion to di post of professor, on 30th April 2015 and 12th November 2015, wey Oga Odoh dey use as certified copies dey issued afta six years wen Ibrahim Bawa Kaura, di former Registrar of di Federal University, don comot from di university.”
Currently di matter dey for court.
UNIZIK appoint acting vice-chancellor

Wia dis foto come from, @ Nnamdi Azikiwe University/facebook
Afta di announcement of di removal of office of di VC by di president, Nnamdi Azikiwe University don announce di reinstatement of Professor Joseph Ikechebelu as di acting vice-chancellor of Nnamdi Azikiwe University, Awka.
Di university management issue one press statement on Thursday say Prof. Ikechebelu go begin work as di vice-chancellor and take on administrative responsibilities for di university, plus any matter wey require di approval of di governing council go be im responsibility.
"In di same vein, di Honourable Minister of Education don approve di reinstatement of Victor Ikechukwu Modebelu as di acting registrar of di University, following di nullification of di appointment of Barr. Mrs. Rosemary Ifeoma Nwokike as di substantive Registrar." Di statement add.








