Nigerians among US deportees wey Ghana receive - Why Mahama accept Trump deportation agreement?

Large number of pipo wey wear black hoodies, one man put hand on di iron barricade wit head warmer.

Wia dis foto come from, Fatih Aktas/Anadolu via Getty Images

Read am in 4 mins

Ghana president John Mahama say dem don confam di arrival of di West African deportees wey come from di United States.

Dis na afta di kontris get agreement to receive pipo from oda West African kontris wey dem dey deport comot from di US.

President Mahama during di Presidential Media Encounter for di Jubilee House on Wednesday 11 September 2025, tok say di individuals wey di US bin deport don land for di kontri.

E say as part of di arrangement wey dem get wit di US, di group of West African deported nationals don enta Ghana.

Mahama say dem accept di deportees becos say di West African nationals no need visa to enta Ghana.

Na about 14 deportees wey be West African nationals don enta Ghana sake of di arrangement between di two kontris.

"Di US bin approach us to accept third-party nationals wey dem dey comot from di US, and den we agree wit dem say we go accept di West African nationals, becos all our fellow West Africans no need visa to come to our kontri", Maham tok

Ghana President say e dey acceptable to receive di West African deportees, since dem decide to travel to Accra.

"If dem decide to travel from di US to Accra, dem no need visa anyway. So if you dey bring our colleague West Africans back, dat dey okay," Mahama tok.

Since e enta office, President Donald Trump don announce plenty immigration-related executive orders, to clear road to crack down on undocumented migrants for US.

For more dan 21 actions, Trump move to overhaul parts of di US immigration system, including how dem go process and deport migrants comot from US.

While Trump don promise "mass deportations" and arrests, e don dey clear how e go take complete much of im plans.

Dis no be di first time wey US go deport immigrants comot from dia kontri.

United States goment don turn Africa to dia new backyard wia dem dey deport migrants wey dem say be convicted criminals.

Bifor, dem don fly some migrants go kontris for Central and South America, dem bin send 12 men from kontris including Mexico, Myanmar and Yemen go Eswatini and South Sudan.

Di US goment bin also try convince some oda African kontris to accept pipo wey dia kontris no gree collect back, dis according to US authorities.

Ghana come enta di list of kontris wey odn accept US deportees, and dis decision don raise plenti kwesions for mind of Ghanaians.

Who de di West African deportees

According to di Ghana president, most of di deportees na Nigerians while odas na from Gambia.

E say di Ghana govment don tell di Nigerian deportees to return to dia kontri afta dem provide bus transportation wey go carry dem go back Naija.

For di Gambian nationals, e say dem go need to work wit di Gambian Embassy for di kontri so dem go fit provide air ticket to return to dia home kontri.

Why Ghana accept di West African deportees arrangement

According to President Mahama, e say di reason why Ghana dey participate for di deportation agreement na sake of say e dey in line wit ECOWAS Protocol on Free Movement.

E say di protocol bin allow citizens of oda member states to enta and stay for oda West African kontris even wen dem no get visa for up to 90 days.

"West Africa get di protocol of free movement, and so sake of dat any West African dey free to come to Ghana and dey to stay for 90 days."

President Mahama say no be big issue if dem receive pipo from oda West African kontris into Ghana.

"If dem dey bring our colleagues back, we no get any problem to accept dem," Mahama tok.