'Nigerians help me, my husband dey inside trouble for Abuja' - Wife of former Rivers head of service raise alarm

Read am in 5 mins

Di end of di political crisis for Rivers State, Southern Nigeria neva dey near.

Dis na sake of di series of information and drama wey dey happun from Friday afta video of George Nwaeke, di former head of service for di state come out.

Im wife, Florence Nwaeke raise alarm say some pipo hold her husband hostage for Abuja, Nigeria Federal Capital Territory.

Tori of di resignation of oga Nwaeke bin come out earlier in di week but e bin no give reason for im resignation.

However, on Friday di former head of service come out to tok plenty tins on wetin im say im know about di political crisis for di oil rich state.

Governor Sim Fubara don already deny di allegation, say make Nigerian ignore am.

Wetin George Nwaeke tok

George Nwaeke for di video interview wey e make exclusive to Channels Television tok say im see how dem give money to former leader of di Rivers state House of Assembly, Edison Ehie to go attack di state Assembly complex.

E allege say na Ehie wey later become govnor Fubara Chief of staff plan di burning of di Assembly complex wey dey along Moscow Road, Port Harcourt.

Di former head of service also claim say dem also plan to go attack and destroy di residential quarters of di lawmakers.

E also say im bin don wan resign since becos all di kasala way dey happun for di state dey make am fear.

"First, e start wit di Rivers State House of Assembly, wia Governor Siminalayi Fubara direct im Chief of Staff to burn down di Assembly to avert om impeachment.

"I dey dia wit dem wen dem give Edison bag of money for dat operation, though I no know how much dey inside.

"Anoda attempt na to destroy di residential quarters of di House of Assembly members. If not for di press conference wey some Rivers youths, elders and National Assembly members do," e claim.

Na dis video wey di wife of di former head of service see wey make her raise alarm say husband don dey lose in mind.

'Nigerians help me my husband dey in trouble'

Madam Florence Nwaeke for her own interview say make Nigerians come help her becos she no know wia her husband dey for Abuja.

Wit tears for her eyes and fear for her body, di troubled woman say she neva fit reach her husband.

"Wen e reach Abuja, e call say e don land" but she shock wen she video of her husband dey trend online wia e dey tok about di pollical crisis for Rivers state.

"I say, dis no be my husband. Dis no be my husband.'

"So I send am message. I ask am if e dey under duress. I ask am if dem don kidnap you? Tok to me now. Why you no wan follow me tok," she lament as she show tori pipo di messages wey she send for her phone.

She kontinu, "Oh, Jesus, help me. Nigerians, help me. My husband don enta wahala. My husband dey in trouble. My husband dey inside trouble. See di message wey I send to am.

"I say, 'Daddy, why? Dem hold you hostage?' I say, 'Why you no follow me tok but e no reply. Im numbers no dey go through. Nigerians, help me! Nigerians, help me!"

Meanwhile, di River state govnor Fubara wey currently dey out of office sake of im suspension deny di allegations.

E say dem don compromise im former head of service.

Di govenor also share screenshots of WhatsApp chats between Nwaeke and im Chief of Staff, Edison Ehie, wia claim say Nwaeke dey beg for money.

"Di truth be say Dr Nwaeke don dey compromised, and watever e dey tok now na to fulfil im promise to pipo wey don pay am to lie against me," Fubara tok for statement wey e sign on Friday.

Background

E don pass one week since Nigeria president Bola Tinubu declare state of emergency for oil rich Rivers State, Southern Nigeria.

Di president declaration follow di political kasala wey dey happun for di state.

As a way to "stabilize di tension" wey di crisis dey cause, oga Tinubu appoint rtd Vice Admiral Ibok-Ete Ibas as di Sole Administrator of di state after suspending di govnor, di deputy govnor and di Rivers state house of Assembly.

A day afta di declaration, oga Ibas resume work as di new head of Rivers state government - position wey e go hold for "an initial six months period", according to di president.

On Tuesday, Ibok-Ete Ekwe Ibas announce di resignation of head of service for di state and den appoint Dr Inyingi Brown wey be Permanent Secretary in acting capacity for di Office of di Head of Service until dem appoint new Head of Service.