Who be di men wey mob lynch for Edo state wey spark reactions?

Read am in 5 mins

Di calls for justice and order for full investigation, especially from Nigeria President Bola Tinubu and northern leaders don follow di gruesome killings of some travellers wey some residents and members of one local vigilante group for Edo state, southern Nigeria attack and set ablaze on top accuse say dem be kidnappers.

Di Nigerian leaders wey express shock at di barbaric act don direct di Police plus oda security agencies to conduct swift and thorough investigations and punish the suspected culprits.

Di Edo state Govnor Monday Okpebholo for statement tok say travellers bin dey travel for inside one commercial truck, wen members of di local security group for Uromi, one community for di state, stop di truck, and wen dem search am, dem discover guns for inside, and dat lead to di attack.

E neva clear how many pipo be victims of di mob attack however, plenty reports claim say dem be 16.

Plenty videos of di brutal killings bin go viral on di internet on Friday, 28 March.

Who be di pipo dem lynch?

According to reports, di incident happun on Thursday, 27 March for Uromi, East North East local goment area of Edo state.

Tori be say di pipo wey die from di jungle justice bin dey travel through Uromi.

President Bola Tinubu for inside statement say dem be 'travelling hunters' while Govnor of Edo state call dem 'travellers'.

Some reports say dem bin dey travel from Port Harcourt go Kano state to celebrate eid wit dia families. Di commercial truck dem dey inside bin dey pass through Edo state. But wen dem reach Uromi, some pipo bin allege say dem be kidnappers, and lynch dem alive.

Some of di videos wey go viral bin show as crowd full one area dey shout kidnappers. Some of di pipo wey stand bin dey hit some pipo wey dem allege as kidnappers wit sticks.

Di video show as di victims lie down for pool of blood, dem appear lifeless as dem lie down for ground naked.

Anoda video show as dem dey beat one severely, e no even try to fight back, dem kick am towards di oda pipo wey dey ground, and dem dey shout die… die…

Odas videos show as dem throw tyre for di neck of di victims and set dem on fire.

Some oda video also show say as di pipo ransack di truck wey carry di travellers, wey dey claim say dem see guns. Dem scata some of di tins wey dey inside di truck put for ground.

Although di Edo state police command neva release any statement yet on top dis mata, di govnor don order police to carry out full investigation on di case and e give assurance say justice go prevail.

Di Edo state goment also add say dem don arrest more dan four pipo wey get hand for di tragic killing.

"I fit assure you say di pipo wey get hand for dis unprovoked attacked no go go scot -free, as di govnor don direct di Commissioner of Police to launch a full scale investigation into di mata. As I speak now, ova four pesins don dey arrested for dia involvement in dis ugly incidence," Di Chief Security Officer (CSO), Government House, Solomon Osaghale wey visit Uromi afta di incident tok.

President Tinubu, Northern leaders, odas react to di mob attack

President Bola Tinubu for one statement don condemn di murder of di 'travelling hunters' wey locals for Uromi community for Edo state, stop and lynch.

Di president wey commiserate wit di families of di affected victims and assure dem say im no go allow criminals shed di blood of innocent Nigerians in vain.

"Jungle justice no get place for Nigeria, and all Nigerians get di freedom to move freely for any part of di kontri.

Northern leaders, Amnesty International and oda ogbonge Nigerians don express sadness ova dis development for Edo state as dem call for Justice.

Amnesty International, one rights organisation say make Nigerian authorities carry out immediate and transparent investigation of di lynching of at least 16 travellers wey one vigilante group and armed youth for Uromi block dia vehicle, drag dem one by one, beat dem, soak dia body wit petrol and light dia bodies wit fire.

"Those wey dem kill na hunters wey dey travel from Rivers state to Kano to celebrate Eid wit dia families. Dem tie dem to tyre wey petrol don soak and den set dem on fire. Di viral videos of di gory incident show di victims drenched in blood, dey beg dia attackers while crowds dey hail di vigilante wey dey attack dem wit axe, stones, dagger, iron rod and machete.

"Di horrific mob violence wey happun for Uromi na part of di rising trend of vigilante groups for towns and villages along highways wey dey block roads and carry out unlawful activities wit impunity." Amnesty International tok for statement.

Di rights group add say e don tey wey dis killings don dey happun, wit few cases investigated and prosecuted. Dem highlight authorities failure to uphold and fulfil dia obligation to protect pipo from harm and violence."

One former Nigeria vice president Atiku Abubakar condemn di attack and e call on authorities to act swiftly and decisively to prevent a recurrence of jungle justice.

Former Kano state govnor Rabiu Kwankwaso also condemn di attack and say pipo from all parts of di kontri suppose fit travel without facing any form of harassment or intimidation.

Former Minister of Digital Economy, Prof. Ali also join di calls for justice for those wey die from wetin e say be jungle justice.