Who be di industrialist Aisha Achimugu wey EFCC declare wanted

Read am in 4 mins

Di Economic Financial Crimes Commission (EFCC) don declare one popular socialite and managing director/CEO of Felak Concept Group, Aisha Achimugu wanted.

For one circular on dia social media accounts on Friday, 28 March, di commission say Achimugu dey wanted for alleged criminal conspiracy and money laundering.

According to di circular wey EFCC tok-tok pesin Dele Olawale sign, e say; "Di public dey hereby notified say Aisha Sulaiman Achimugu, wey im photograph appear above dey wanted by di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) for one alleged case of criminal conspiracy and money laundering."

Di circular add say make anybody wey get useful information on di whereabouts of 51-year-old Madam Achimugu contact di commission for dia offices or go report for di nearest police station or oda security agencies.

Achimugu investigation no concern Atiku or Sanwo-Olu issues - EFCC

Meanwhile, EFCC don come out to say Achimugu investigations no concern Atiku or Sanwo-Olu issues.

Dis na as di presidential candidate of di PDP Atiku Abubakar for di 2023 election bin reject one report say dem receive campaign funds for di election from di Lagos state govnor through Madam Aisha Achimugu.

But dor statement, EFCC say, "EFCC wish to react to media reports linking im investigations of Ms. Aisha Achimugu with political undercurrents involving former Vice President Atiku Abubakar and Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu.

We wish to state unequivocally say di investigations of Achimugu no get correlation of any kind wit di two political actors."

EFCC add say dem dey investigate Achimugu for alleged criminal conspiracy and money laundering and dem don since declare am wanted.

EFCC say dem commence investigation of Achimugu for 2022 and though she approach di court to obtain one injunction wey stop di Commission from arresting, investigating, inviting or detaining her for any alleged criminal act, di injunction bin dey challenged and vacated on Wednesday, February 19, 2025 by one Federal High Court wey siddon for Abuja.

Di Abubakar Media Office for one statement on Thursday, 27 March tok say di former vice-president no ever meet Sanwo-Olu, talk less of collecting money from im hand.

"We for Atiku Media Office don take note of reports for one section of di media say di govnor of Lagos State, Babajide Sanwo-Olu through Ms Aisha Achimugu bin give Atiku Abubakar, Vice President of Nigeria, 1999-2007 money wey allegedly belong to Lagos State. Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) dey investigate di mata." Di statement tok.

Who be Aisha Achimugu?

Aisha Achimugu bin make media headlines for January 2024 wen she throw one lavish seven-day party to mark her 50th birthday anniversary.

Di seven-day extravaganza wey quickly become di tok of town bin hold for Calivigny Island and Silversands for Grenada; also for Abuja, Nigeria capital.

Plenty ogbonge Nigerians and politicians, including Lagos state Govnor Babajide Sanwo-Olu bin attend di celebration wey hold for di Caribbean Island of Grenada.

For her website, Dr Aisha Achimugu describe herself as ogbonge businesswoman and industrialist, she be di Group Managing Director and Chief Executive Officer, FELAK CONCEPT GROUP; one technical and professional consortium wey consist of about eight active companies in various sectors and industries like Engineering, Maritime, Oil and Gas, ICT Learning and Development, and various other leading sectors.

She also be di Chairman, Bluewave Exploration and Production Limited.

According to her website, Madam Achimugu OFR don receive plenty recognition and awards for her business acumen and humanitarian services from several esteemed organisations, wey include, FORBES Best of Africa Innovative Leadership Awards- September 2022, Winner, Africa Best Quality Oil & Gas Exploration and Production Company of the year (Oceangate Engineering Oil & Gas Limited) 2023, National Honors Award- Officer of di Order of di Federal Republic 2023, Di Youth Ambassador for Peace Award, among many odas.

Dem born Madam Achimugu for 22 January, 1974.