Tins to know as Ghana begin cholera vaccination afta 50 pipo die across di kontri

vaccination

Wia dis foto come from, WHO GHANA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di greater accra region gat ova 200 cases
Read am in 4 mins

Di Ghana health service don begin to vaccinate pipo against cholera for di kontri afta ova 50 pipo die.

So far at least five out of di 16 regions of Ghana don confam cases of cholera as hospitals dey struggle to deal wit di outbreak.

Many oda pipio don dey on admission.

Data from di health service and ministry of health don show say di greater Accra, Eastern, Central, Ashanti and Western regions na di regions wey don record cases.

Dr Denis Laryea wey be oga in charge of disease surveillance don tok say "pipo bin dey die sake of many pipo wey get di disease try to self-medicate, and odas bin dey report to di hospital three to four days afta di infection.

Na so dem begin to vaccinate pipo for di Greater Accra region between 14 -17 February 2025 as na di region wit di most cases - more dan 200 out of di 6,000 cases across di kontri.

Di Western and Central regions also get plenty cases.

For three days, di Ghana health service say dem dey target 300,000 pipo for dis vaccination for Accra.

Di areas for dis vaccination na di Ablekuma south, Okaikwei south and Ashiedu Keteke, all for di Greater Accra region.

People waiting on queues to be vaccinated

Wia dis foto come from, WHO GHANA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di WHO bin support di Ghana health service to vaccinate pipo for di Western and Central regions

Who qualify for dis vaccination

Di health service say di oral cholera vaccine (OCV) na for evribodi wey be one year and above.

Dem also tok say di vaccine dey safe and effective

"Make una look for your area for di vaccination team, and take di vaccine to protect yoursef," di health service tok.

Kontri director for di World Health Organisation tok say cholera na, "Highly contagious illness wey be global health threat. If dem no treat am, cholera fit to lead to death."

For dis round of vaccination, di GHS say dem go do house-to-house and target districts wey be hotspots.

A man is vaccinating a child

Wia dis foto come from, WHO GHANA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di vaccination na for pipo wey be one year and above

Symptoms of cholera

Di ministry of health bin dey educate pipo since last year ova di illness.

Dem tok say to know say di sickness una dey see na cholera, di patient go get:

- diarrhoea (wen pipo go dey poopoo water water).

- Vomiting.

- Patients go dey thirsty, tired and weak.

- Loss of body fluids wey fit lead to death.

Cholera dey spread by flies, water and food.

E dey transfer from faecal matter to pesin mouth.

If pesin drink water and food wey contaminate, im fit get cholera.

How to prevent cholera

People sitting and standing under a canopy.

Wia dis foto come from, WHO GHANA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di health service dey hope to contain di disease

According to di health service:

- Pipo gatz drink clean water.

- Wash your hands wit soap and running water.

- Wash fruits and vegetables well well.

- Practise good hygiene.

- Eat food wey hot.

- Make pipo stop open defecation.

- If pesin get acute diarrhoea dem gatz drink ORS quick and visit di hospital

- Pipo wey dey sell food gatz wash plates, cups, and oda tins well well.