Wike stand im ground on kwanta wit Naval officer ontop land mata for Abuja

FCT Minister Nyesom Wike

Wia dis foto come from, FCT Administration, Abuja

Read am in 5 mins

Nigerian Minister of di Federal Capital Territory, FCT Nyeson Wike don download di behind di scenes wetin happun for im and di uniformed military man for video wey go viral.

On Tuesday, one video wey bin go viral on social media, show as di FCT minister and one young military officer bin dey exchange words ova one land wey belong to one former Chief of Naval Staff..

Di property, wey dey located on Plot 1946, bicom di subject of argument afta Wike bin visit di said properties wit officials and question if di ex-naval chief get di right to develop am.

E insist say di military no get approval or valid documentation from di federal capital territory to develop di land.

However, di military officer, insist say im dey act on orders and di land get valid papers.

Oga Wike tell tori pipo for press conference say di mata no be just as dem dey see am as e allege say, "goment officials dey attacked, goment officials dey beaten up, goment officials wey even reach di level of directorship and I go dey siddon for office, dey do wetin?"

On di mata of wetin happun for di viral video, Wike accuse di pesin behind di military officer say, "Na private individual. Dem no allocate land give am. Dem allocate di land give one company wey dem dey call Santos dis tin for 2007 for parks and recreation."

E add say, "dem bin apply to di former minister, for change of use. Di minister no gree. Di man come go, start to dey sell land. Maybe di former chief of Naval Staff bin fall for dia scam. But still na goment property, no be your property."

"Goment don siddon under administrative committee collect all di lands back wey bin dey for parks and recreations and even under secretariat bicos we bin see say plenti dealings and law cases bin dey inside am".

Di former govnor of Rivers state bin give example of how e bin help solve land wahala for pipo wey include former president of Nigeria, Olusegun Obasanjo wey call am as opposed to using military to take intimidate di mata.

Although e no call oda names, e tok say more pipo dey way e don help solve land mata for do area bicos as e put am, "respect beget respect".

E also add say if to say di pesin na active member of di military, e for know how e go take attend to di mata or even escalate am.

Oga WIke tok say, "Wen one serving Major-General bin attack development control, I bin write letter, to di den Chief of Army Staff say sir see o, bicos na seriving military officer im be. So if anytin spoil e still dey under di control of di military"

Minister of State for Defence Matawalle address Wike

Howeva Wike actions don collect dragging from di Minister of State for Defence Bello Matawalle wey call di Minister of di FCT out say e go against di advice of di Chief of Defence Staff and di Chief of Army Staff to no go di site, so dem go handle di mata through proper channels.

For interview wey oga Matawalle bin do on Wednesday e call di whole mata unfortunate and say di officer wey bin dey dia bin dey carry out lawful orders and bin dey work wit weytin military disciplie teach am.

Local tori pipo, DCLHausa quoe di minister say e tok say, "no offence dey under military law wey dem go charge am. Wike for no follow am do gbas-gbos even if only out of respect for di uniform wey im dey wear. Anyone wey disrespect soja dey indirectly disrespect di President wey be di Commander in Chief of di Armed forces".

Howeva oga Matawalle clear di air say wetin e tok no mean say military get right to disrespect ciillians but tok say wetin dat one mean be say e dey improtant to dey folloe di chain of command procedures for inside di Armed forces.

Meanwhile di Minister of Defence, Mohammed Badaru, say di ministry dey investigate di confrontation between di Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, and one naval officer, A. M. Yerima, ova one disputed piece of land for Abuja.

During one press briefing on Wednesday, 12 November to commence activities for di 2026 Armed Forces Remembrance Day for di National Defence College, Abuja, Oga Badaru tok say di Armed Forces no go abandon any personnel wey dey carry out lawful duties.

Oga Badaru say, "Well, for di ministry, and indeed di Armed Forces, we go always protect our officers on lawful duty.

"We dey look into dis issue, and we assure all say any officer on lawful duty go dey highly protected. We no go allow anything to happun to amso long as dey do im job, and e do im job very well."