Osimhen double secure Nigeria place for Caf 2026 World Cup play-off final

Wia dis foto come from, Getty Images
Goals from Victor Osimhen don push Nigeria final of Caf 2026 World Cup play-off.
Di game hot up till di extra time and Nigeria get four goals wey push dem for di next round of di play off.
Wit dis 4-1 scoreline, Nigeria advance to di final of African play-offs.
Di game bin end for 1-1 scoreline afta 90 minutes afta Akor Adams first score for Nigeria and Gabon player Mario Lemina equalise for di 89th minutes.
Afta added minutes, and Victor Osimhen miss late minute one-on-one, di game enta extra time.
Ejuke score im first goal for di Super Eagles for di 97 minutes while Osimhen top di goals.
Nigeria go face Cameroon or DR Congo for Africa play-off final on Sunday (19:00 GMT).
Na di winners of dat match go progress to a six-team intercontinental qualifier, wia two oda nations go join di 2026 World Cup.
Na four kontris dey compete for di 2026 World Cup Africa qualifiers play-offs to reduce to one during dis international window- Nigeria don sail through.
Nigeria don face di first stage and dem don sail through and go face anyone wey win between DR Congo or Cameroon.
Nigeria 4 vs 1 Gabon
FINAL WHISTLE
120mins- Wat a chance for Gabon, but Nigeria defender bin clear di ball comot go corner
119mins- Frank Onyeka down afta serious tackle from Samake Nze or Gabon. Di two of dem chop YELLOW CARD
SUBSTITUTION' Victor Osimhen out, Arokodare in for Nigeria
116mins- Gabon players know say dis game don dey ova for dem, but dem still dey struggle to find goal
YELLOW CARD- Moussounda chop yellow card
113mins- Good game from di Super Eagles of Nigeria as dem dey dominate di game now
111mins- Di ball don return to play, as Gabon don dey weak since Nigeria don drop three goals for dia hand
110mins-Incredible goal by Victor Osimhen, e first chest di ball as e land for im side, den use im leg put am up, e look for chance by pushing di ball forward, den e STRIKE di ball for di back of Gabon goalkeeper.
Nigeria 4 vs 1 Gabon
'GOOOAAAAAAALLLLL
108mins- SUBSTITUION, Iwobi, Osayi-Samuel out, Awaziem and Troost-Ekong in for Nigeria
107mins- Nwabali almost make mistake for Aubameyang to score, but e quickly play di ball comot for post line
We don come back for di second
Nigeria 3 vs 1 Gabon
EXTRA-TIME HALF-TIME
Referee blow whistle
105+4mins- Frank Onyeka fall down sake of di challenge from Denis Bouanga. Referee blow foul
105+2mins- Gabon dey under serious pressure to score again, but shey dem go fit keep up wit two more goals? Nigeria dey gain dominance ova Gabon
FOUR ADDED MINUTES
104mins- Alex Iwobi dey do im own magic wit di ball
SUBSTITUTION- Obasogie in for Nigeria
Nigeria 3 vs 1 Gabon
102mins- Victor Osimhen give Nigeria anoda brilliant goal. Good assist from Fredrick, and Osimhen complete am
'GOOOOOAAAALLLLLLLL
102mins- Frank Onyeka run wit di ball
100mins- SUBSTITUTION- Meyo and Lemina out, Oyono don enta for Gabon
99mins- Ejuke down, afta hard tackle from Gabon player
97mins- Ejuke put di Super Eagles for anoda lead for di extra-time. Well positioned ball, e put am for di back of Gabon goalkeeper
Nigeria 2 vs 1 Gabon
GOOOOAAAAAAAAAAALLLLL
96mins- THROW-IN for Gabon, oh, Lemina no fit control am, afta Nigeria player tackle am
94mins- Anoda great SAVE by Gabon goalkeeper. Good charge by Osimhen
92mins- Calvin Bassey and Sanusi dey square-play for di middle, while Gabon dey attack wit pressure
Nigeria 1 vs 1 Gabon
90mins- Di game is on di way, di stadium fans dey in surprise of how di first 90 minutes bin finish
We dey go into di extra time now, na dis go give us anoda look of how di match go end. Stadium for Rabat dey hot wit emotions and shouts.
![Victor Osimhen [left] wear di Nigeria green shirt with sleeve, di shirt get di logo of di NFF for im chest, e spray im hair wetin resemble white and gold colour. Pierre-Emerick Aubameyang wear Gabon national sleeveless green shirt, e hold green and white football for hand. im hair na rich balck colour and black beards e. dey smile small for di foto](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/8b21/live/3a02b7e0-c087-11f0-924c-87dcfe4462ba.png.webp)
Wia dis foto come from, Nurphoto/Issouf Sanogo via getty images
EXTRA-TIME
Nigeria 1 vs 1 Gabon
Final Whistle
Dat miss for Nigeria go don put dem for good lead as di final whistle dey close. What a brilliant game.
90+11mins - Victor Osimhen play away a one-on-one target, e dey face di goalkeeper like dis but e play am away.
MISSED CHANCE, Osimhen!!!!
Ejuke wit di ball, oh no, goalkick, e no quick play di ball
90+7mins- CORNER for Nigeria, Moses Simon again to take am. E play am up, headed into Gabon box. Aubameyang play am go corner
Ejuke wit di ball, good dribble, e enta Gabon players, e find Calvin Bassey, ball still in play. Anoda corner
CORNER for Nigeria, dem go fit convert am? Moses Simon to take di corner.
90+4mins- Di game don dey hot now oooo. Abi na extra time dis pipo wan go into?
90+1mins- WHAT A CHANCE. Osimhen get di ball, oh no, e play am near di post
12 MINUTES ADDED TIME
Nigeria 1 vs 1 Gabon
What a goal dat was, di shot wey Lemina bin play deflect enta Nigeria net
99mins- Mario Lemina equalise for Gabon
GOOOOAAAAALLLL
87mins- Moses Simon wit good attack for di middle, Gabon looking for an equaliser to give dem hope for dis game
85mins- Long Range shot from Osimhen, but e no go near post
If Nigeria wan defend dia game well, make dem hold Lemina and Aubameyang well, as di two fo dem dey enta Nigeria defence well well
84mins- SUBSTITUTION' Gabon wit Didier Ndong out, Nze in.
SUBSTITUTION- Akor Adams out, Frank Onyeka in for Nigeria
82mins- ANODA CHANCE. Osimhen wit di heavy shot, but off-side
80mins- Nigeria dey lead now, and di game don dey show more pressure as Gabon dey find equaliser
Nigeria 1 vs 0 Gabon
Akor Adams put in di ball to put Nigeria for di lead. Nobodi expect dat ball, di defence line dey so empty
78mins- GOOOOAAAAAAAAAALLLLLL
77mins- SUBSITTUTION, Meyo and Lemina in, Openda and Koko out for Gabon...
Be like say Nwabali want make dem change am
72mins- Stanley Nwabali dey veri confident for di goalpost, but e don dey down afta one Gabon player bin charge am. E kick di ball out, but im leg hit di player
Moses Simon dey try change di scoreline, wit impressive crosses
70mins- Great dribble by Simon, but di ball to high for Osimhen to head. Dat na Simon first cross
67mins- Osimhen use back hit di ball, e for convert am if to say na im front di ball bin land
Nwabali wit di ball for front of goalpost wia Gabon player bin block di ball wey e wan play go out
65mins- CORNER for Nigeria, dat ball too much ooo, nobodi to head am
Ejuke carry di ball, great cross, but Gabon player Manga hit am go corner.
64mins- CORNER- Gabon get one corner, dem play am enta anoda corner. So much Pressure here for Nigeria. Anoda corner again.
Dem play three corners one afta di oda, Nwabali catch di last one.
62mins- Gabon wit di ball, veri fast as usual. Hard tackle on Ndidi as Gabon player pull im shirt, but referee blow free kick for Gabon.
Osimhen head di ball comot for post
60mins - Ndidi wit great run to recova di ball,
59mins- SUBSTITUTION' Ademola Lookman out, Moses Simon in for Nigeria. Chukwueze out, Ejuke in
59mins- Calvin Bassey wit good tackle on Bouanga
57mins- CORNER KICK still on for Gabon, dem quickly play am
No Penalty!!! What a relief for Nigeria. Afta plenti checks by di referee and di VAR room, dem say di pull wey Samuel give Gabon player no be penalty
50mins- FREE KICK for Gabon, afta Sanusi push Gabon player for front of di box. Dis one dey dangerous oooo. Be like shirt pulling dey for inside Nigeria box 18, referee dey check if na penalty or not afta one Gabon player fall for inside Nigeria box
48mins- Gabon dey kontrol di ball so far for dis second part of di game, Aubameyang wit some show of dribbles but e neva fir convert am
46mins- We are back for di second half of di game between Nigeria and Gabon, and di ball is in play afta di referee blow whistle
Second Half
Nigeria 0 vs 0 Gabon
HALF-TIME
Referee don blow WHISTLE!!!
45+6mins- Nwabali pursue di ball, as e pass am give Iwobi
Haaaaaaaa, Aubameyang ooooooo. Wonderful challenge by Fredrick, di ball go corner.
Calvin Bassey dey hold di defence line well, wit odas
45+4mins- Aubemayang wit di ball, chaaiii, see as e dribble Nigeria defender, but e play di ball into Nwabali hand
Ademola Lookman and Samuel step forward to play di kick, Lookman take am, e play am for up ontop di goalkeeper head, but Gabon goalkeeper catch am from up
FREE KICK for Nigeria
45+2mins- Nigeria in play, Ademola Lookman wit di move, good dribble, ouch Andre Poko don fall am down.
6 MINUTES ADDED TIME
45mins- So much pressure on Gabon, as dem dey play veri fast ball, to enta Nigeria defence
Nigeria 0 vs 0 Gabon
WHAT A CHANCE!!!! Openda shot stop for Stanley Nwabali front ooo
YELLOW CARD - Pierre Aubameyang
43mins- Lots of tension here, wit eyes on Osimhen, Gabon don begin play strong defensive game so Nigeria no go break into dia wall, but di Super Eagles dey try break di wall
41mins- So far, Nigeria don get good five shots on target. Good SAVE by Gabon goalkeeper. Di flag bin go up, but later come down
38mins- Referee don give di players small break to rest oooo, as Gabon goalkeeper dey receive treatment. Gabon coach dey also follow im players tok
37mins- Nigeria lose di ball ooooooo, counter attack for Gabon. Aubemeyang catch di ball, great run.
Ewwooooo, e pass give Bouanga. Bouanga wit di shot, but Nigeria defender block am
CORNER for Nigeria
35mins- Good shot by Osimhen but dem block am
34mins- Aubameyang no too show for dis match ooooo. Victor Osimhen dey show Gabon midfield say im dey for di game, as e turn dem
THROW-IN for Gabon. Jacques Ekomie move forward to throw am, but referee blow foul throw-in.
32mins- CORNER for Gabon, Openda win a corner for di Gabon team afta im fast run.
Nigeria 0 vs 0 Gabon
Osimhen wit di ball, Lookman don position for am, e pass give Chukwueze, but e no see di ball play
31mins- Veri sharp dribble by Ekomie, veri fast but nobodi to pass give.
29mins- No be GOAL oooooo, Referee cancel am say di ball no enta and no be handball. Di match don kontinue
27mins- NA GOAL? Wetin happun for dia? Osimhen head di ball into di net but di goalkeeper push am out afta e don near di touchline. Referee dey try decide if na goal or not.
Gabon pull out di ball, dem dey run go Nigeria box. But Nwabali dey dia to stop am
24mins- Osimhen wit di ball, great run, Shey e go shoot? Make we see, Osimhen run wit di ball, enta Gabon post. Give pass to Osayi, Oh no, Osayi no shoot am well, di ball just hang for im leg.
Nigeria dey give some good energy to charge di Gabon players, and dem dey control ball well for dis first half, but Gabon too no gree as dem dey try set di midfield well
22mins- Good chances for Nigeria as dem dey try dominate di game, Ademola Lookman wit di ball, moving into di box 18. Long shot blocked again, from Lookman
20mins- WHAT A SAVE!!! Gabon goalkeeper Mbaba bin save Osimhen header. Dat na veri strange save
Nigeria 0 vs 0 Gabon
18mins- Dem don carry Osimhen comot for pitch as di medical dey attend to am. Di ball don return to play
Osimhen is down afta e jam wit Gabon goalkeeper.
16mins- Osimhen come out ooooo, e don jam di goalkeeper. Brilliant cross from Adams from di side of di box.
Nigeria get good chance for front of Gabon box but dem no dey convert dis tin to goal, Alex Iwobi shot wey e play, di defender block am
13mins- Stanley Nwabali wit di good SAVE, e catch di long shot by Anthony Oyono.
11mins- Pierre Aubameyang dey dis game for Gabon, and im skills neva show yet as ball neva reach im side for front of Nigeria goalpost. Na one of dia ogbonge player wey fit make anytin happun for dem wen e concern goal.
What a wide shot by Alex Iwobi, di ball go ova di bar from di edge of di box.
9mins- Calvin Bassey wit di strong touch on di ball. Big foul on Samuel Osayi by Mario Lemina of Gabon.
7mins- FREE Kick for Gabon, Ndong sharply play am, wit good pass to im teammate, dem dey move wit di ball, but Nigeria defender stop and collect di ball
YELLOW CARD - Ndidi chop yellow card afta e do hard tackle on Didier Ndong of Gabon.
5mins- Dangerous position for di Super Eagles as Royce Openda carry di ball enta Nigeria box 18, e try dribble, but e kick am out.
3mins- Good Chance for Nigeria, But Gabon goalkeeper Loyce Mbaba catch am.
Hard tackle of Sanusi by Didier Ndong
2mins - Alex Iwobi and Sanusi dey play togeda for di middle, as dem dey pair wit Ademola Lookman.
Wat a wide shot from di Nigerian player, but di Gabon goalkeeper catch di ball.
FREE KICK for Nigeria.
1mins' - Referee don blow whistle and di match don start
0mins' - Dem sing di Nigeria National anthem, followed by di Gabon anthem and di players dey stretch
Dis no be di first time wey Nigeria and Gabon dey face each oda for tournament but dis one go hot pass wetin pipo tink becos say na 2026 World Cup play-off.
Super Eagles of Nigeria no just dey go World Cup, but Gabon neva go World Cup bifor- so both teams go fight wit dia power to make am through.
Nigeria 0 vs 0 Gabon










