Osun tighten security after Kwara massacre

Osun state govnor Ademola Adeleke

Wia dis foto come from, Osun state government/X

Read am in 5 mins

To avoid any spillover of violence and ensure safety of di residents of Osun state, di state govment say dem don step up security surveillance and coordination across di state border communities and neighbouring areas.

Di state govnor Ademola Adeleke give dis informate for one statement on Friday following di attack wey happun for two communities for Kwara state wey reportedly claim ova 160 lives.

Di road distance from Kwara to Osun state dey less dan 160km, dat na about 3 hours drive to di state capital, Ilorin.

Di govnor of di southwest state also appeal to di Inspector General of Police Kayode Egbtokun to lift di ban on di state Amoekun Corps and unseal dia operation base for di state to fight di emerging threats.

"Responding to anoda case of kidnapping for Ora Igbomina area, di state dey handicapped for dia security response as di Amotekun service don remain sealed by di police and dia top officers dey for detention without trial for several months."

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Oga Adeleke explain say Amotekun service don bicom expert in containment and intelligence-led operations especially for rural border areas and add say police shutting down of di service operations don create big gap wey bandits and criminals dey exploit.

"Closing down Amotekun dey expose Osun pipo to serious risks. I call on di Inspector General of Police to unseal Amotekun and allow dia operatives to secure my pipo across di grassroots."

Amotekun corps na one Western Nigeria Security Network wey dey based for di six south western states for Nigeria.

Govments of di six southwest states bin establish am for 2020 to assist police plus oda security agencies fight insecurity for di region.

However, for October 2025, di IGP bin seal di operational base of Amotekun for Osun state on top accuse of alleged extra-judicial killings, plus dia mode of operations.

Burnt wooden stalls and corrugated iron from one market for di aftermath of di attack.

Di attack for Woro and Nuku communities for Kwara state, northcentral Nigeria on Tuesday na likely di deadliest di kontri don see dis year.

Di govment blame di assault on di jihadist group Boko Haram, wey e say target di residents becos dem no gree accept an "extremist" version of Islam.

Di state govnor AbdulRahman AbdulRazaq post on X say "75 local Muslims dey massacred" for Tuesday raid, while one state lawmaker tell BBC say dem don bury 78 pipo so far and di death toll fit rise to an estimated 170, as dem dey recover more corpses.

In addition to di killings for di villages, dem abduct 38 pipo, burn shops and houses, Saidu Baba Ahmed, one member of di Kwara state house of assembly tok.

Groups for Nigeria dey para as dem blame di govment for failing to protect di citizens.

Di Human Rights Writers Association don even on President Tinubu to put embargo on foreign trips and focus on securing di kontri.

International communities wey include di United States govment, di Muslim World League among odas don condemn di attack in strong terms.

For one statement on X, di US mission in Nigeria bin describe di attack as "horrific", as dem note say di death toll neva still dey clear and many still dey unaccounted for.

"We express our deepest condolences to di families of dos affected by dis senseless violence. We welcome President Tinubu order to deploy security forces to protect villages for di area and im directive to federal and state officials to provide aid to di community and bring di perpetrators of dis atrocity to justice," di statement add.

Di attacks come afta Nigeria govment confam di presence of American troop for di kontri.

For December, America bin work wit Nigerian authorities, and dem carry out air strikes for Sokoto state for north-western Nigeria, dem target di camps wey Islamist militant groups dey run.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

In recent months, jihadists - suspected to be from one Boko Haram splinter faction - don dey very active for Kwara, as dem dey carry out targeted killings.

Dem dey most often ride on motorcycles and attackg markets and vigilante groups wey dey set up to protect villagers.

For inside one press release on Wednesday, govnor Abdulrazaq tok say di attack on di two villages na as a result of recent counter-terrorism operations for di region.

Dat same Tuesday, 21 pipo die from one attack on Doma village for Katsina state for di north, Amnesty tok.

On di same day 17 pipo die for series of attacks for north-eastern Borno state, by suspected Boko Haram militants.

Meanwhile, more dan 50 survivors from di Kwara attack don begin receive treatment for hospitals for injuries dem sustain during di assault.

Di senator wey dey represent Kwara North Senatorial District, Sadiq Umar, visit some of dem for hospital.