Premier League fixtures for 2025/26 season

Read am in 3 mins

Di 2025/26 premier league fixtures don comot wit match details of some of di ogbonge teams wey go jam each oda for di opening weekend.

League champions Liverpool go open di season on Friday 15 August wit home game against Bournemouth.

Di game for di opening weekend na di ogbonge one between Arsenal and Manchester United for di Emirates on Sunday 17 August.

Pep Guardiola im team go travel to face Wolves. Chelsea go play wit Cyrstal Palace wey bin win di league cup last season.

Di teams go play 380 games ova 33 weekends, wia five of di games go happun for mid-week.

Di league go end for Sunday, 24 May 2026.

Organizers of di league tok say dem gree to start di league for 15 August – wey be 82 days from di end of di last season to "allow make di players rest well well bifor di new season."

During di festive period, dem neva go allow make clubs play two times in less dan 60 hours.

Liverpool go try to defend dia title, na so Manchester City go try to bounce back from dia trophyless season.

Manchester United coach Ruben Amorim say im team go try to compete for di new season as dem begin to sigh players – like Matheus Cunha from Wolves.

For Arsenal, anoda season for Mikel Arteta to try to finally win di league afta dem finish second for di last three seasons.

Below na di fixtures for di opening weekend fixtures for di league

Friday, 15 August

- Liverpool v Bournemouth (20:00)

Saturday, 16 August

- Aston Villa v Newcastle (12:30)

- Brighton v Fulham (15:00)

- Nottingham Forest v Brentford (15:00)

- Sunderland v West Ham (15:00)

- Tottenham v Burnley (15:00)

- Wolverhampton Wanderers v Manchester City (17:30)

Sunday, 17 August

- Chelsea v Crystal Palace (14:00)

- Manchester United v Arsenal (16:30)

Monday, 18 August

- Leeds v Everton (20:00)

All di game time na BST