You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Police give update on video of House on The Rock pastor wey show 'stun' gun
Lagos state police command don confam say di gun like object wey popular pastor Paul Adefarasin carri for one viral video no be firearm and no be dangerous weapon as di tori bin tok for social media.
For statement on Tuesday night police say wetin dem recover from di pastor na stun gun - wey be prohibited anti-riot equipment.
Police say afta dem kwesion di pastor, im volunteer cautionary statements to di police investigators.
Di statement add say dem grant am bail while investigation kontinu for di case.
BBC Pidgin bin earlier report say police invite pastor Adefarasin to ansa kwesions ontop viral video wey show wia im carri gun-like object against anoda road user while im dey drive unmarked SUV.
Police tok tok pesin Benjamin Hundeyin bin say detectives dey kwesion di pastor and dem don commence investigation into di viral video wey show wia im hold gun-like object against anoda road user and dey drive car without plate number.
Di video bin comot for social media two weeks ago and go viral. Di video show di pastor as e dey drive one SUV wey no carry plate number.
E raise plenti dust as pipo begin question why pastor go dey carry fire arm.
But Pastor Adefarasin bin debunk allegations say e carry firearm for di viral video.
During Sunday service same week, Pastor Adefarasin react say no be gun im carri.
"I dey assure you say dat tin no be firearm and I no point am on anybodi" na so e tok.
According to am na clickbaiters attack am in order to make more money.
E say "dem falsely accuse me say I carry firearm, say I point firearm on aggressive content creator wey come close into my personal space"
Pastor Adefarasin further add say im no get pistol license to carry firearm, im no get firearm and I no point firearm on any pesin".
After im response, some social media commentators still react say di pastor no clear di air properly as im no explain wetin im actually carry for di viral video.
Wen BBC Pidgin ask police wen dem go release di pastor, di tok tok pesin answer say for now, im dey wit dem and e no wan speculate di outcome of im visit.
Pastor Paul Adefarasin dey popular not only for Nigeria but across Africa and di world as im be di organizer of one of di biggest gospel music festival for Africa wey dem dey call The Experience.
Im be di lead pastor of popular House on di Rock Church wey get branches for major cities across Nigeria.