Wetin cause blackout for Spain and Portugal?

Photo of of metro station wey no get light dey circulate online

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Spain and Portugal dey face widespread power blackout, di blackout affect public transport.

Portuguese electricity operator say na one "rare" atmospheric phenomenon, wey dey related to variations in temperatures na im cause di power cut.

Di power issue wey start on Monday don cause serious traffic and delay airline flights.

Utility operators dey work hard to restore di grid.

Di head of Spain electricity grid say to restore power fit take hours.

Red Electrica CEO Eduardo Prieto tell tori pipo for news conference say operation to solve di issue fit take "between six and ten hours".

Dis na wetin we know

  • For some regions, traffic lights no dey work, shops and restaurants no get light even train service dey affected too
  • Internet also dey affected and mobile phone networks dey down in Spain
  • Spanish grid operator Red Electrica say dem dey working wit regional energy companies to restore supplies
  • For Madrid - wey be di capital of Spain - Mayor José Luis Martínez-Almeida warn residents to stay wia dem dey
  • Meanwhile, for Portugal, airline TAP Air tell passengers make dem no travel to airport until further notice
  • Parts of France also briefly lost power but the French grid operator RTE say di network now dey operate normally

Wetin we no know yet na

  • Wen authorities go fully restore power, Spanish Prime Minister Pedro Sanchez office say: "Di goment dey work to identify di origin of dis mata and we dey dedicate all possible resources to resolve am as quickly as possible"

I bin dey scan my shopping for Aldi wen di power off

Hannah Lowney, wey from Manchester but dey live for Madrid, say she bin don go halfway to scan her grocery shopping for Aldi wen di power go off .

For one voice message to BBC's Naga Munchetty, on Radio 5 Live, she explain say:

"If you look outside window e look like say na di whole street [wey lose power], and den pipo for Aldi say na nationwide power cut.

"Di traffic lights dey off. Pipo dey come out of dia offices to waka go dia house because dem no fit tell wen di buses dey come.

"E be like say nobody get any idea of when it will come back.

"Edey say say na di whole kontri, I' never experienced dis kain tin bifor."

Di European Commission say dem dey "in contact" wit Spanish and Portuguese authorities "to understand di underlying cause" of today blackout.

"Di commission go kotinu to monitor di situation and make sure say di information dem dey exchange dey smooth," na wetin tok-tok pesin for EU executive arm tok.

Antonio Costa, wey be former Portuguese premier wey dey head di European Council of EU member states, also dey in contact wit di Spanish and Portuguese leaders, EU officials add.

Costa, say no sign say today power outage na cyber attack cause am.

Costa say im dey in touch wit Spanish Prime Minister Pedro Sanchez and Portuguese PM Luís Montenegro - im add say di grid operators for di two kontris dey "work to find di cause, and to restore di electricity supply".

Meanwhile Portugal power firm REN, say, "due to di complexity of di issue and di need to rebalance electricity flows internationally, e estimate say e fit take up to one week bifor di network go fit dey normal