Court remand for prison Access Bank staff wey allegedly plant camera, take naked videos of female colleagues

Nigerian police

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Court for Lagos don remand for prison 27 years old Stephen Ejezie wey allegedly record naked videos of im co-workers for Access Bank Contact Centre for Oniru area of di state.

Lagos state police command bin arraign di suspect before di court on Monday wit two count charges of breach of public peace by videoing im colleagues while dem dey bath and for fighting im colleagues.

Police tok-tok pesin Benjamin Hundeyin tell BBC Pidgin say dem bin arrest di suspect last week and di case happun but dem release am on bail in order to conclude investigation. But on Monday, di suspect report back to di station and dem charge am to court.

For court documents wey BBC see, di court also grant di suspect bail to di tune of 500,000 Naira and and two sureties. Court say e go remain for Ikoyi prison custody pending wen e meet im bail conditions.

Di court adjourn di case to 19th May 2025 to continue hearing

Access bank for statement on Monday say dem hand over di case of alleged privacy violation involving one of dia former Contact Centre agent to di appropriate authorities.

For press statement on dia verified handle, di bank say dem dey cooperate wit authorities on di matter, say dem dey committed to upholding di highest standard of safety and privacy of dia staff and customers.

Tori been comot for local media over di weekend say Access Bank staff feem nude videos of female staff inside restroom witout di knowledge of di victims.

Report from local media FIJ say authorities bin arrest di suspect but say dem later release am and e dey walk free while di victims dey suffer.

How dem catch am

Woman for restroom siddon and cover her face

Wia dis foto come from, Getty Images

According to FIJ, workers for di bank Contact Centre dey do shift work, so sometimes dem go sleep over for office, clean up and take dia bath for dia.

Tori be say di suspect dey hide enter di restrooms wia im dey secretly feem im colleagues wen dem dey naked dey take dia bath. Na inside one of di female restrooms dem catch am.

"Dem catch am wen one lady dey take her bath and notice phone wey dey up dey record am from di toilet wey dey by di side. Na by chance she see di camera," di tori pipo write.

After she raise alarm, plenti pipo run enter di female restroom and catch am.

Di tori claim say dem later search im house and im phone wia dem allegedly find up to 400 of such videos.

Anoda part of di tori tok say di suspect dey sell di nudes online, say e get online customers wey im dey into business wit. BBC neva fit verify dis claims.

FIJ tori also claim say some of im colleagues wey dey fear weda dia video follow for wetin im record tok say im get Telegram account and Fans-Only account wey im dey use sell naked clips to im customers.

Latest tori be say di bank don sack di suspect and ban staff of di centre say make dem no dey sleep over again for di call centre.